2 Pedro 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 My friends, dis na di sekond leta wey I dey rite to una, so dat una go dey tink about di tins wey I tell una.
1 Amados, esta é agora a segunda carta que lhes escrevo. Em ambas quero despertar com estas lembranças a sua mente sincera para que vocês se lembrem
2 I wont make una remember all di word wey di profets tok before and di kommandment wey awa Oga God and Savior give us thru di apostles.
2 das palavras proferidas no passado pelos santos profetas, e do mandamento de nosso Senhor e Salvador que os apóstolos de vocês lhes ensinaram.
3 Afta dis, make una undastand sey: for di last days, yeye pipol go kom and dem go dey do bad tins wey dey hongry dem.
3 Antes de tudo saibam que, nos últimos dias, surgirão escarnecedores zombando e seguindo suas próprias paixões.
4 Dem go sey, “I tink sey Jesus promise sey E go kom back? Awa grand-grand papa dem don die since, but evritin still bi as dem bi since God kreate di world.”
4 Eles dirão: "O que houve com a promessa da sua vinda? Desde que os antepassados morreram, tudo continua como desde o princípio da criação".
5 Dem don forget sey, na with word God take kreate di heaven before E kreate di eart from wota and na with wota, E take make dis world.
5 Mas eles deliberadamente se esquecem de que há muito tempo, pela palavra de Deus, existiam céus e terra, esta formada da água e pela água.
6 And na with di same wota, E take distroy di eart wey dey before.
6 E pela água o mundo daquele tempo foi submerso e destruído.
7 Na di same word God take keep dis heaven and eart dey wait for fire wey go kom. E keep dem dey wait Judgement day. Di day wen E go distroy di pipol wey nor dey fear am.
7 Pela mesma palavra os céus e a terra que agora existem estão reservados para o fogo, guardados para o dia do juízo e para a destruição dos ímpios.
8 Naw, my friends, make una nor let dis tin pass una, bikos one day bi like 1,000 years for God eye and 1,000 years bi like one day.
8 Não se esqueçam disto, amados: para o Senhor um dia é como mil anos, e mil anos como um dia.
9 Nor bi sey God nor fit do wetin E promise as some pipol dey tink, but E dey patient dey wait for una, bikos E nor wont make anybody die trowey, but E wont make evribody turn from sin kom meet am.
9 O Senhor não demora em cumprir a sua promessa, como julgam alguns. Pelo contrário, ele é paciente com vocês, não querendo que ninguém pereça, mas que todos cheguem ao arrependimento.
10 Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.
10 O dia do Senhor, porém, virá como ladrão. Os céus desaparecerão com um grande estrondo, os elementos serão desfeitos pelo calor, e a terra, e tudo o que nela há, será desnudada.
11 Since evritin go melt like dis, wish kind pipol wi suppose to bi? E good make wi dey live awa life for holiness and dey do wetin God wont.
11 Visto que tudo será assim desfeito, que tipo de pessoas é necessário que vocês sejam? Vivam de maneira santa e piedosa,
12 Since wi dey wait for di day wey Christ go kom, make wi dey do wetin wi fit do to make Christ kwik kom. Bikos for dat day, evritin wey dey for heaven go burn kon skata and di stars, go melt.
12 esperando o dia de Deus e apressando a sua vinda. Naquele dia os céus serão desfeitos pelo fogo, e os elementos se derreterão pelo calor.
13 But as God promise, wi dey wait for di new heaven and eart, di place where raitiousness dey.
13 Todavia, de acordo com a sua promessa, esperamos novos céus e nova terra, onde habita a justiça.
14 So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.
14 Portanto, amados, enquanto esperam estas coisas, empenhem-se para serem encontrados por ele em paz, imaculados e inculpáveis.
15 God dey wait with patient, so dat una go turn from sin kom meet am, just as awa broda Paul rite give una akordin to di wisdom wey God gi-am.
15 Tenham em mente que a paciência de nosso Senhor significa salvação, como também o nosso amado irmão Paulo lhes escreveu, com a sabedoria que Deus lhe deu.
16 E tok about dis tins for all en letas. Aldo some tins for di leta dey hard to undastand and doz wey nor know di trut or dey stabol, don turn dem to wetin go kill dem. Na so dem take distroy all di oda part for God word too.
16 Ele escreve da mesma forma em todas as suas cartas, falando nelas destes assuntos. Suas cartas contêm algumas coisas difíceis de entender, as quais os ignorantes e instáveis torcem, como também o fazem com as demais Escrituras, para a própria destruição deles.
17 So, my friends, as una don know wetin go happen, make una shine una eye, so dat una nor go miss di way and fall from di trut wey una get, bikos na so pipol wey nor sirious, dey do.
17 Portanto, amados, sabendo disso, guardem-se para que não sejam levados pelo erro dos que não têm princípios morais, nem percam a sua firmeza e caiam.
18 But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.
18 Cresçam, porém, na graça e no conhecimento de nosso Senhor e Salvador Jesus Cristo. A ele seja a glória, agora e para sempre! Amém.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Pedro 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.