2 Pedro 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.
1 E também houve entre o povo falsos profetas, como entre vós haverá também falsos doutores, que introduzirão encobertamente heresias de perdição, e negarão o Senhor que os resgatou, trazendo sobre si mesmos repentina perdição.
2 Many pipol go follow dem live dia yeye life. Bikos of dis fake tishas, pipol go tok bad about di trut,
2 E muitos seguirão as suas dissoluções, pelos quais será blasfemado o caminho da verdade.
3 and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.
3 E por avareza farão de vós negócio com palavras fingidas; sobre os quais já de largo tempo não será tardia a sentença, e a sua perdição não dormita.
4 God nor sorry for di angels wey sin, E trow dem for hell and tie dem for darkness until di day wen E go judge di world.
4 Porque, se Deus não perdoou aos anjos que pecaram, mas, havendo-os lançado no inferno, os entregou às cadeias da escuridão, ficando reservados para o juízo;
5 God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.
5 E não perdoou ao mundo antigo, mas guardou a Noé, a oitava pessoa, o pregoeiro da justiça, ao trazer o dilúvio sobre o mundo dos ímpios;
6 E still turn Sodom and Gomorrah to ashes wen E distroy dem, den E use dem as ezample for di pipol wey dey live bad life,
6 E condenou à destruição as cidades de Sodoma e Gomorra, reduzindo-as a cinza, e pondo-as para exemplo aos que vivessem impiamente;
7 but E save Lot wey nor like wiked pipol life,
7 E livrou o justo Ló, enfadado da vida dissoluta dos homens abomináveis
8 (bikos di time wey Lot dey dat town, e vex for di bad tins wey di pipol dey do).
8 (Porque este justo, habitando entre eles, afligia todos os dias a sua alma justa, por isso via e ouvia sobre as suas obras injustas);
9 If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.
9 Assim, sabe o Senhor livrar da tentação os piedosos, e reservar os injustos para o dia do juízo, para serem castigados;
10 Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority.
10 Mas principalmente aqueles que segundo a carne andam em concupiscências de imundícia, e desprezam as autoridades; atrevidos, obstinados, não receando blasfemar das dignidades;
11 even angels wey get pawa pass dem, nor dey tok about dis tins for God present.
11 Enquanto os anjos, sendo maiores em força e poder, não pronunciam contra eles juízo blasfemo diante do Senhor.
12 But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.
12 Mas estes, como animais irracionais, que seguem a natureza, feitos para serem presos e mortos, blasfemando do que não entendem, perecerão na sua corrupção,
13 Dem go sofa for dis tins wey dem dey do, bikos dem feel sey dem fit do anytin wey dia body wont for day time and wen ever dem follow una chop, dem dey kause trobol among una.
13 Recebendo o galardão da injustiça; pois que tais homens têm prazer nos deleites quotidianos; nódoas são eles e máculas, deleitando-se em seus enganos, quando se banqueteiam convosco;
14 Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.
14 Tendo os olhos cheios de adultério, e não cessando de pecar, engodando as almas inconstantes, tendo o coração exercitado na avareza, filhos de maldição;
15 Since dem komot from di rite way, dem don miss road, bikos dem dey follow Balaam, Beor pikin, wey love bad tins!
15 Os quais, deixando o caminho direito, erraram seguindo o caminho de Balaão, filho de Beor, que amou o prêmio da injustiça;
16 As God dey korrect Balaam for en sin (donkey wey nor suppose tok kon tok to di profet, so dat e go stop di bad tins wey e dey do).
16 Mas teve a repreensão da sua transgressão; o mudo jumento, falando com voz humana, impediu a loucura do profeta.
17 Dis pipol bi like river wey nor get wota, dem bi like kloud wey breeze dey blow anyhow and na dem God dey keep di place wey dark pass, dey wait.
17 Estes são fontes sem água, nuvens levadas pela força do vento, para os quais a escuridão das trevas eternamente se reserva.
18 Dem dey use dia big-big grammar wey nor mean anytin, take deceive pipol wey just dey won komot hand for bad tins.
18 Porque, falando coisas mui arrogantes de vaidades, engodam com as concupiscências da carne, e com dissoluções, aqueles que se estavam afastando dos que andam em erro,
19 Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.
19 Prometendo-lhes liberdade, sendo eles mesmos servos da corrupção. Porque de quem alguém é vencido, do tal faz-se também servo.
20 Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.
20 Porquanto se, depois de terem escapado das corrupções do mundo, pelo conhecimento do Senhor e Salvador Jesus Cristo, forem outra vez envolvidos nelas e vencidos, tornou-se-lhes o último estado pior do que o primeiro.
21 Bikos e for betta sey, dem nor know God at-all, dan sey afta dem don know am, dem kon turn back from di kommandment wey God give dem.
21 Porque melhor lhes fora não conhecerem o caminho da justiça, do que, conhecendo-o, desviarem-se do santo mandamento que lhes fora dado;
22 Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”
22 Deste modo sobreveio-lhes o que por um verdadeiro provérbio se diz: O cão voltou ao seu próprio vômito, e a porca lavada ao espojadouro de lama.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Pedro 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.