2 Pedro 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.
1 Simão Pedro, servo e apóstolo de Jesus Cristo, aos que conosco alcançaram fé igualmente preciosa pela justiça do nosso Deus e Salvador Jesus Cristo:
2 Make God give una betta peace and grace as una dey grow for en word and inside Jesus, wey bi awa Oga God!
2 Graça e paz vos sejam multiplicadas, pelo conhecimento de Deus, e de Jesus nosso Senhor;
3 I pray make God pawa give us evritin wey wi nid, so dat wi go fit live di kind life wey E wont, as wi don know di trut about Jesus wey koll us with en glory and goodness.
3 Visto como o seu divino poder nos deu tudo o que diz respeito à vida e piedade, pelo conhecimento daquele que nos chamou pela sua glória e virtude;
4 Like dis too, wi don get betta promise and bikos of dat, wi go get God karata wey go free us from di bad tins wey dey for dis world.
4 Pelas quais ele nos tem dado grandíssimas e preciosas promessas, para que por elas fiqueis participantes da natureza divina, havendo escapado da corrupção, que pela concupiscência há no mundo.
5 So, make una try to make una faith strong and know God word. As una dey know God word more-more,
5 E vós também, pondo nisto mesmo toda a diligência, acrescentai à vossa fé a virtude, e à virtude a ciência,
6 una go fit kontrol unasef; get patient; dey live holy life
6 E à ciência a temperança, e à temperança a paciência, e à paciência a piedade,
7 and love una brodas and sistas without parsha.
7 E à piedade o amor fraternal, e ao amor fraternal a caridade.
8 Bikos if una really get dis tins, dem go dey grow inside una, so una nor go dey yuzles, but una go bear good fruits as una dey try to know Christ more-more.
8 Porque, se em vós houver e abundarem estas coisas, não vos deixarão ociosos nem estéreis no conhecimento de nosso Senhor Jesus Cristo.
9 But di pesin wey nor get dis tins, dey blind. Dis show sey, e nor dey si far and e don forget sey God don forgi-am en sins.
9 Pois aquele em quem não há estas coisas é cego, nada vendo ao longe, havendo-se esquecido da purificação dos seus antigos pecados.
10 So my brodas and sistas, make una do evritin to show sey, God koll and choose una. As una dey do so, una nor go ever fall inside sin.
10 Portanto, irmãos, procurai fazer cada vez mais firme a vossa vocação e eleição; porque, fazendo isto, nunca jamais tropeçareis.
11 Di door to enter awa Oga God and Savior Jesus Christ kingdom, wey nor go ever end, go open wide for una.
11 Porque assim vos será amplamente concedida a entrada no reino eterno de nosso Senhor e Salvador Jesus Cristo.
12 I go dey remind una dis tins evritime, even doh I know sey una know dem and naw, una leg don strong for di trut wey una bilive.
12 Por isso não deixarei de exortar-vos sempre acerca destas coisas, ainda que bem as saibais, e estejais confirmados na presente verdade.
13 As long as I dey, I look am sey e good make I dey remind una,
13 E tenho por justo, enquanto estiver neste tabernáculo, despertar-vos com admoestações,
14 as I know sey di time wey I go die don near, bikos awa Oga God Jesus Christ don show mi.
14 Sabendo que brevemente hei de deixar este meu tabernáculo, como também nosso Senhor Jesus Cristo já mo tem revelado.
15 I go try do evritin wey I fit do, so dat afta I don go, una go fit tok about dis tins.
15 Mas também eu procurarei em toda a ocasião que depois da minha morte tenhais lembrança destas coisas.
16 Bikos, wi nor use awa brain take tell una lie-lie story about Christ pawa and how E go kom back.
16 Porque não vos fizemos saber a virtude e a vinda de nosso Senhor Jesus Cristo, seguindo fábulas artificialmente compostas; mas nós mesmos vimos a sua majestade.
17 God gi-am honor and glory wen di vois sey, “Dis na my Pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
17 Porquanto ele recebeu de Deus Pai honra e glória, quando da magnífica glória lhe foi dirigida a seguinte voz: Este é o meu Filho amado, em quem me tenho comprazido.
18 Wen dis vois tok from heaven, wi awasef hear am, bikos wi dey with am on-top di mountin.
18 E ouvimos esta voz dirigida do céu, estando nós com ele no monte santo;
19 Afta dat one, wi bilive wetin di profets prish. Una go do well if una hear and follow di lite wey dey shine for darkness and wen day break, di star wey dey kom for morning, go shine for una heart.
19 E temos, mui firme, a palavra dos profetas, à qual bem fazeis em estar atentos, como a uma luz que alumia em lugar escuro, até que o dia amanheça, e a estrela da alva apareça em vossos corações.
20 Di one wey important pass bi sey, una know dis tins: e nor get anytin wey di profets tok for God word wey just kom out from dia own mind,
20 Sabendo primeiramente isto: que nenhuma profecia da Escritura é de particular interpretação.
21 bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.
21 Porque a profecia nunca foi produzida por vontade de homem algum, mas os homens santos de Deus falaram inspirados pelo Espírito Santo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Pedro 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.