2 João 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Mi wey bi elder dey rite dis leta to di woman wey God choose, with en shidren wey I love inside di trut (nor bi only mi, but na evribody wey know di trut).
1 O ancião à senhora eleita, e a seus filhos, aos quais eu amo em verdade, e não somente eu, mas também todos os que conhecem a verdade,
2 Bikos di trut dey inside us, e go stay inside us forever.
2 por causa da verdade que permanece em nós, e para sempre estará conosco:
3 Make God, awa Papa and Jesus Christ, en pikin wey dey inside trut and love, give us grace, mesi and peace.
3 Graça, misericórdia, paz, da parte de Deus Pai e da parte de Jesus Cristo, o Filho do Pai, serão conosco em verdade e amor.
4 I dey happy well-well, wen I si sey some among yor shidren dey live akordin to di trut, just as di Papa kommand us.
4 Muito me alegro por ter achado alguns de teus filhos andando na verdade, assim como recebemos mandamento do Pai.
5 I dey rite to remind una sey, make una love one anoda. Dis nor bi new kommandment, but na di one wey dey from di biginnin.
5 E agora, senhora, rogo-te, não como te escrevendo um novo mandamento, mas aquele mesmo que desde o princípio tivemos: que nos amemos uns aos outros.
6 (Na wetin love mean bi dis: make wi dey do wetin God wont.) Na di kommandment bi dis and just as wi hear am from di biginnin; na so wi suppose to follow am.
6 E o amor é este: que andemos segundo os seus mandamentos. Este é o mandamento, como já desde o princípio ouvistes, para que nele andeis.
7 Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!
7 Porque já muitos enganadores saíram pelo mundo, os quais não confessam que Jesus Cristo veio em carne. Tal é o enganador e o anticristo.
8 Make una shine una eye, so dat di work wey wi do among una, nor go lost, but instead, wi go get komplete reward.
8 Olhai por vós mesmos, para que não percais o fruto do nosso trabalho, antes recebeis plena recompensa.
9 Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.
9 Todo aquele que vai além do ensino de Cristo e não permanece nele, não tem a Deus; quem permanece neste ensino, esse tem tanto ao Pai como ao Filho.
10 If anybody kom meet una and e nor asept wetin wi dey tish, make una nor welkom or receive am as una broda.
10 Se alguém vem ter convosco, e não traz este ensino, não o recebais em casa, nem tampouco o saudeis.
11 But pesin wey receive am, go dey follow am do di wiked tins wey e dey do.
11 Porque quem o saúda participa de suas más obras.
12 Even doh I get many oda tins wey I won tell una, I nor won take paper and biro rite dem, but I hope sey I go kom visit una and I go tok to una face-to-face, so dat awa happiness go full.
12 Embora tenha eu muitas coisas para vos escrever, não o quis fazer com papel e tinta; mas espero visitar-vos e falar face a face, para que o nosso gozo seja completo.
13 Una sista shidren wey God don choose, dey greet una.
13 Saúdam-te os filhos de tua irmã, a eleita.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 João 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.