2 Crônicas 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen Sheba kween hear about Solomon, di woman kon go ask am strong-strong kweshon. Di kween rish Jerusalem with many pipol and many kamel wey karry spices, plenty gold and precious jewels. Wen di kween meet Solomon, e tell am evritin wey e get for en mind.
1 A rainha de Sabá soube da fama de Salomão, e foi a Jerusalém para pô-lo à prova com perguntas difíceis. Quando chegou, acompanhada de uma enorme caravana, com camelos carregados de especiarias, grande quantidade de ouro e pedras preciosas, foi até Salomão e lhe fez todas as perguntas que tinha em mente.
2 Solomon get ansa for all di kween kweshon; e nor get anytin wey dey too hard for am to esplain give di kween.
2 Salomão respondeu a todas; nenhuma lhe foi tão difícil que não pudesse responder.
3 Wen Sheba kween si di palis wey Solomon build and how di king get sense rish,
3 Vendo a sabedoria de Salomão, bem como o palácio que ele havia construído,
4 di woman sopraiz well-well. Di kween still sopraiz for di kind food wey dey di tabol; as Solomon ofisas dey organize and di fine-fine klot wey dem wear; di pesin wey dey hold di cup; dia garment and di burnt ofrin wey Solomon offa for God Temple.
4 o que era servido em sua mesa, o lugar de seus oficiais, os criados e copeiros, todos uniformizados, e os holocaustos que ele fazia no templo do Senhor, ela ficou impressionada.
5 Di kween tell Solomon, “Wetin I hear for my kountry about evritin wey yu get and yor wisdom, na true!
5 Disse ela então ao rei: "Tudo o que ouvi em meu país acerca de tuas realizações e de tua sabedoria era verdade.
6 I nor bilive wetin dem tok until I kom here kom si dem with my own eyes. True-true, I neva even hear half of di wisdom wey yu get! Wetin I dey si so, dem nor even tell mi rish half.
6 Mas eu não acreditava no que diziam, até ver com os meus próprios olhos. Na realidade, não me contaram nem a metade da grandeza de tua sabedoria; tu ultrapassas em muito o que ouvi.
7 Yor pipol go dey happy well-well o-o! Na betta honor for yor ofisas to stand here evriday dey listin to yor wisdom!
7 Como devem ser felizes os homens da tua corte, que continuamente estão diante de ti e ouvem a tua sabedoria!
8 Make wi praiz di Oga wey bi yor God, bikos E like yu kon give yu dis en great kingdom. God love Israel and en pipol and E wont make dis kingdom last forever. E don make yu king ova dem, so dat yu go rule well and dey good with am.”
8 Bendito seja o Senhor, o teu Deus, que se agradou de ti e te colocou no trono dele para reinar pelo Senhor, pelo teu Deus. Por causa do amor de teu Deus para com Israel e do seu desejo de preservá-lo para sempre, ele te fez rei, para manter a justiça e a retidão".
9 Den di kween give di king gift wey bi 9,000 pound of gold, many spices and precious jewels. E nor get any spices wey fine rish di ones wey Sheba kween give King Solomon.
9 E ela deu ao rei quatro toneladas e duzentos quilos de ouro e grande quantidade de especiarias e de pedras preciosas. Nunca se viu tantas especiarias tais como aquelas que a rainha de Sabá deu ao rei Salomão.
10 (Plus all dis ones, Hiram and Solomon savant buy gold from Ofir, plus fine timba and precious jewels.
10 ( Os marinheiros de Hirão e de Salomão trouxeram ouro de Ofir, e também madeira de junípero e pedras preciosas.
11 Di king use di timbas take make steps for God Temple, en royal palis kon do instrument for doz wey dey play music. For Judah land, nobody don ever si anytin like dat until dat time.)
11 O rei utilizou a madeira para fazer a escadaria do templo do Senhor e a do palácio real, além de harpas e liras para os músicos. Nunca se havia visto algo semelhante em Judá. )
12 Evritin wey Sheba kween ask for, King Solomon gi-am and wetin e gi-am many pass wetin di kween bring kom. Den di kween kon go back to en kountry with di men wey follow am kom.
12 O rei Salomão deu à rainha de Sabá tudo o que ela desejou e pediu; muito mais do que ela lhe tinha trazido. Então ela e seus servos voltaram para o seu país.
13 Solomon dey kollect 666 pound for gold evry year.
13 O peso do ouro que Salomão recebia anualmente era de vinte e três toneladas e trezentos quilos,
14 All dis nor dey join di oda tins wey e dey get from doz wey dey buy and sell. All Arabia kings and govnor from di aria, dey still bring gold and silva kon gi-am.
14 fora o que os mercadores e os comerciantes traziam. Também todos os reis da Arábia e os governadores do país traziam ouro e prata para Salomão.
15 King Solomon make 200 big shield with gold; na 600 gold wey dem melt for fire, dem take make each one.
15 O rei Salomão fez duzentos escudos grandes de ouro batido, utilizando três quilos e seiscentos gramas de ouro em cada um.
16 E still make 300 small shield with gold; na 300 gold wey dem melt for fire, dem take make each one. Di king put dem for di palis for Lebanon Forest.
16 Também fez trezentos escudos pequenos de ouro batido, com um quilo e oitocentos gramas de ouro em cada um. O rei os colocou no Palácio da Floresta do Líbano.
17 Di king make one big throne wey dem design with ivory kon dekorate am with gold.
17 O rei mandou fazer ainda um grande trono de marfim revestido de ouro puro.
18 Di throne get six steps and di place where dem go put leg on-top, na gold dem take do am. Di throne get where dem go rest hand put for di two side and one image like lion dey for di two side for di throne.
18 O trono tinha seis degraus, e um estrado de ouro fixo nele. Nos dois lados do assento havia braços, com um leão junto a cada braço.
19 E still get twelf oda image like lion for di six step; one lion for each end for di six step. E nor get any oda throne for di world wey dem fit use take kompare dis one!
19 Doze leões ficavam nos seis degraus, um de cada lado. Nada igual havia sido feito em nenhum outro reino.
20 All di cup wey king Solomon dey take drink wota or wine, na betta gold dem take make dem, just like all di tins wey dey di palis for Lebanon Forest. Dem nor make dem with silva, bikos wen Solomon dey rule, e nor si silva as anytin!
20 Todas as taças do rei Salomão eram de ouro, bem como todos os utensílios do Palácio da Floresta do Líbano. Não havia nada de prata, pois a prata quase não tinha valor nos dias de Salomão.
21 Di king get many ship wey go Tarshish with Hiram savants. Wons evry three years, di ship dey kom back with plenty gold, silva, ivory, apes and peacocks.
21 O rei tinha uma frota de navios mercantes tripulados por marinheiros do rei Hirão. Cada três anos a frota voltava, trazendo ouro, prata, marfim, macacos e pavões.
22 So King Solomon kon get money well-well and wise pass any oda king wey dey dis eart.
22 O rei Salomão era o mais rico e o mais sábio de todos os reis da terra.
23 Kings from evriwhere dey kom meet am make dem for hear from di wisdom wey God gi-am.
23 Esses pediam audiência a Salomão, para ouvirem a sabedoria que Deus lhe tinha dado.
24 Evribody wey dey kom visit Solomon, dey bring gift wey bi gold, silva, klot, war tins, spices, horse and melu kom meet am.
24 Ano após ano, todos os que vinham traziam algum presente: utensílios de prata e de ouro, mantos, armas e especiarias, cavalos e mulas.
25 Solomon get 4,000 place where e dey keep en shariot and ordinary horse put and e get 12,000 horse. E keep dem for some towns wey e choose and for Jerusalem town too.
25 Salomão possuía quatro mil estábulos para cavalos e carros, e doze mil cavalos, dos quais mantinha uma parte nas guarnições de algumas cidades e a outra perto dele, em Jerusalém.
26 E rule all di kingdoms from Eufrates River go rish Filistia pipol land and e still rish di borda for Egypt side.
26 Ele dominava sobre todos os reis desde o Eufrates até a terra dos filisteus, junto à fronteira do Egito.
27 Di king make silva plenty for Jerusalem like san-san. Cedar wood plenty, just as sikamore fig tree plenty for di low lands.
27 O rei tornou a prata tão comum em Jerusalém quanto as pedras, e o cedro tão numeroso quanto as figueiras bravas da Sefelá.
28 Solomon buy en horse dem from Egypt and many difren kountries.
28 Os cavalos de Salomão eram importados do Egito e de todos os outros países.
29 Di remainin tins wey Solomon do, from biginnin go rish di end, dem rite dem put for di book wey Profet Natan rite; plus Ahijah for Shiloh profesy; Iddo wey dey si vishon and di vishon about Jeroboam wey bi Nebat pikin.
29 Os demais acontecimentos do reinado de Salomão, desde o início até o fim, estão escritos nos relatos do profeta Natã, nas profecias do silonita Aías e nas visões do vidente Ido acerca de Jeroboão, filho de Nebate.
30 E rule Israel pipol from Jerusalem for forty years.
30 Salomão reinou quarenta anos em Jerusalém, sobre todo o Israel.
31 Wen King Solomon die, dem beri am for David Town, bikos dem name di town afta en papa, David. En pikin Rehoboam kon take-ova as king.
31 Então descansou com os seus antepassados e foi sepultado na cidade de Davi, seu pai. E o seu filho Roboão foi o seu sucessor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Crônicas 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.