2 Crônicas 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Wen Solomon don pray finish, fire kom down from heaven kon burn di ofrin and di sakrifice, den God present kon full inside di temple.
1 Tendo Salomão acabado de orar, desceu fogo do céu e consumiu o holocausto e os sacrifícios; e a glória do Senhor encheu a casa.
2 Di priests nor fit enter God Temple, bikos God present full der.
2 E os sacerdotes não podiam entrar na casa do Senhor, porque a glória do Senhor tinha enchido a sua casa.
3 Wen evribody for Israel si sey fire kom down and God present full di temple, dem knee down kon face groun. Dem kon dey woship and tank God dey sey,
3 E todos os filhos de Israel, vendo descer o fogo, e a glória do Senhor sobre a casa, prostraram-se com o rosto em terra sobre o pavimento, adoraram ao Senhor e lhe deram graças, dizendo: Porque ele é bom; porque a sua benignidade dura para sempre.
4 Di king and di pipol kon offa sakrifice give God.
4 Então o rei e todo o povo ofereceram sacrifícios perante o Senhor.
5 King Solomon sakrifice 22,000 kattle and 120,000 sheep. Den en and all di pipol dedikate God Temple.
5 E o rei Salomão ofereceu em sacrifício vinte e dois mil bois e cento e vinte mil ovelhas. Assim o rei e todo o povo consagraram a casa de Deus.
6 Di priests stand for where dem put dem, plus all di Levi pipol wey dey play music to take praiz God. (Dis na di tins wey King David make to take give God tanks and David dey use dem wen ever e dey praiz God sey, “True-true, yor love dey with us forever.”) Di priest stand near Levi pipol dey blow di trumpets, while evry oda tribe for Israel, stand dey praiz God.
6 Os sacerdotes estavam em pé nos seus postos, como também os levitas com os instrumentos musicais do Senhor, que o rei Davi tinha feito para dar graças ao Senhor {porque a sua benignidade dura para sempre}, quando Davi o louvava pelo ministério deles; e os sacerdotes tocavam trombetas diante deles; e todo o Israel estava em pé.
7 Solomon santify di kourtyard centre wey dey God Temple front. Di burnt sakrifice, di korn ofrin and di fat part for di peace ofrin, e offa dem for der, bikos di bronze altar wey Solomon make, too small to kontain all di ofrins.
7 Salomão consagrou também o meio do átrio que estava diante da casa do Senhor; porquanto ali ele ofereceu os holocaustos e a gordura das ofertas pacíficas; pois no altar de bronze que Salomão tinha feito não cabiam o holocausto, e a oferta de cereais e a gordura.
8 For dat time, Solomon and Israel pipol celebrate for seven days. Pipol from Hamat for nort go rish Egypt wotaside for sout, still dey join dis pipol too.
8 Assim naquele tempo celebrou Salomão a festa por sete dias, e todo o Israel com ele, uma grande congregação, vinda desde a entrada de Hamate e desde o rio do Egito.
9 For di eight day, dem gada evribody togeda, bikos dem don dedikate di altar for seven days kon celebrate for anoda seven days.
9 E no oitavo dia celebraram uma assembléia solene, pois haviam celebrado por sete dias a dedicação do altar, e por sete dias a festa.
10 For di twenty-third day for di sevent mont, Solomon kon tell all di pipol make dem dey go dia house. Dem happy well-well as dem dey go, bikos of di good tins wey God don do for David, Solomon and Israel pipol.
10 E, no vigésimo terceiro dia do sétimo, mês, ele despediu o povo para as suas tendas, alegre e de bom ânimo pelo bem que o Senhor tinha feito a Davi e a Salomão, e a seu povo Israel.
11 Afta Solomon don build God Temple, di royal palis and evritin wey e plan for God Temple and en royal palis finish,
11 Assim Salomão acabou a casa do Senhor e a casa do rei; tudo quanto Salomão intentara fazer na casa do Senhor e na sua própria casa, ele o realizou com êxito.
12 God appear to am for nite kon sey:
12 E o Senhor apareceu de noite a Salomão e lhe disse: Eu ouvi a tua oração e escolhi para mim este lugar para casa de sacrifício.
13 Wen I klose di sky so dat rain nor go fall, or kommand lokust make dem distroy di plant for di land, or kause betta wahala and diziz,
13 Se eu cerrar o céu de modo que não haja chuva, ou se ordenar aos gafanhotos que consumam a terra, ou se enviar a peste entre o meu povo;
14 if my pipol go honbol demsef kon pray to mi and turn from dia sins, I go hear and ansa dem from heaven kon forgive dia sins, den heal dia land.
14 e se o meu povo, que se chama pelo meu nome, se humilhar, e orar, e buscar a minha face, e se desviar dos seus maus caminhos, então eu ouvirei do céu, e perdoarei os seus pecados, e sararei a sua terra.
15 I go listin and ansa dia prayers wey dem go pray for dis place.
15 Agora estarão abertos os meus olhos e atentos os meus ouvidos à oração que se fizer neste lugar.
16 I don choose and santify dis temple, so dat e go bi my permanent house; I go always dey here.
16 Pois agora escolhi e consagrei esta casa, para que nela esteja o meu nome para sempre; e nela estarão fixos os meus olhos e o meu coração perpetuamente.
17 Yu must serve mi, just as yor papa David do. Make yu do evritin wey I kommand and obey my rules well-well.
17 E, quanto a ti, se andares diante de mim como andou Davi, teu pai, fazendo conforme tudo o que te ordenei, guardando os meus estatutos e as minhas ordenanças,
18 Den I go make yor shidren rule forever, just as I promise yor papa David sey, ‘Yu go always get pikin wey go rule ova my pipol, Israel.’
18 então confirmarei o trono do teu reino, conforme o pacto que fiz com Davi, teu pai, dizendo: Não te faltará varão que governe em Israel.
19 But if yor pipol turn from mi kon dey disobey di rules and kommand wey I sey make dem keep and dem kon dey serve anoda god,
19 Mas se vos desviardes, e deixardes os meus estatutos e os meus mandamentos, que vos tenho proposto, e fordes, e servirdes a outros deuses, e os adorardes,
20 I go remove dem from my land wey I give dem; I go forget dis temple wey I santify with my present kon make pipol laf and fool dem among all di nashon.
20 então vos arrancarei da minha terra que vos dei; e esta casa que consagrei ao meu nome, lançá-la-ei da minha presença, e farei com que ela seja por provérbio e motejo entre todos os povos.
21 But for dis temple, wey bin dey good and okay, evribody wey dey pass am go shok kon sey, ‘Wetin make God do like dis to dis land and dis temple?’
21 E desta casa, que é tão exaltada, se espantará qualquer que por ela passar, e dirá: Por que fez o Senhor assim a esta terra e a esta casa.
22 Odas go ansa sey, ‘Na bikos dem nor obey di Oga wey bi dia grand-grand papa God; di One wey take dem komot from Egypt. Dem dey serve and woship oda god with all dia mind. Na dis make God dey ponish dem like dis.’ ”
22 E lhe responderão: Porquanto deixaram ao Senhor Deus de seus pais, que os tirou da terra do Egito, e se apegaram a outros deuses, e os adoraram e os serviram; por isso trouxe sobre eles todo este mal
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Crônicas 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.