2 Crônicas 34

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Josaya na eight years wen e start to rule and e rule for thirty-one years from Jerusalem.
1 Tinha Josias oito anos de idade quando começou a reinar e reinou trinta e um anos em Jerusalém.
2 E do wetin God wont kon follow David wey bi en grand-grand papa footstep, e nor turn go left or rite.
2 Fez o que era reto perante o Senhor , andou em todo o caminho de Davi, seu pai, e não se desviou nem para a direita nem para a esquerda.
3 For di eight years wen e dey rule, even doh e still dey yong, e start to serve God wey en grand-grand papa David serve. For di twelft year, e bigin distroy all di place where dem for dey serve juju: Asherah juju and all di oda juju.
3 Porque, no oitavo ano de seu reinado, sendo ainda moço, começou a buscar o Deus de Davi, seu pai; e, no duodécimo ano, começou a purificar a Judá e a Jerusalém dos altos, dos postes-ídolos e das imagens de escultura e de fundição.
4 E give orda sey make dem distroy Baal juju kon skata di incense altar wey dey on-top dem. E skata and grind Asherah juju, di oda juju and dia image, den e pour dia dust on-top di juju savant graves.
4 Na presença dele, derribaram os altares dos baalins; ele despedaçou os altares do incenso que estavam acima deles; os postes-ídolos e as imagens de escultura e de fundição, quebrou-os, reduziu-os a pó e o aspergiu sobre as sepulturas dos que lhes tinham sacrificado.
5 E burn di juju priest bones for di altars where dem for dey woship before. Bikos of all dis tins wey e do, Judah and Jerusalem kon dey holy again.
5 Os ossos dos sacerdotes queimou sobre os seus altares e purificou a Judá e a Jerusalém.
6 E do di same tin for Manasseh, Efraim and Simeon land go rish Naftali and all di towns wey dey near dem.
6 O mesmo fez nas cidades de Manassés, de Efraim e de Simeão, até Naftali, por todos os lados no meio das suas ruínas.
7 E distroy di altar, Asherah juju and di oda juju kon skata all di incense altars wey dey for Israel town, den e go back to Jerusalem.
7 Tendo derribado os altares, os postes-ídolos e as imagens de escultura, até reduzi-los a pó, e tendo despedaçado todos os altares do incenso em toda a terra de Israel, então, voltou para Jerusalém.
8 For di eighteent year wen e dey rule, e kontinue to dey make di land and di temple holy. King Josaya tell Shafan wey Azalaya born, Maaseaya wey bi Jerusalem govnor and Joah wey bi di high offisa Jehoahaz pikin sey, “Make una go ripair di Oga awa God, temple.”
8 No décimo oitavo ano do seu reinado, havendo já purificado a terra e a casa, enviou a Safã, filho de Azalias, a Maaseias, governador da cidade, e a Joá, filho de Joacaz, cronista, para repararem a Casa do Senhor , seu Deus.
9 Di money wey Levi pipol wey dey guide don kollect for di temple, dem pak and gi-am to Hilkaya wey bi di High Priest. (Dem kollect am from Manasseh, Efraim and all di pipol wey remain for Israel, Judah, Benjamin and Jerusalem.)
9 Foram a Hilquias, sumo sacerdote, e entregaram o dinheiro que se tinha trazido à Casa de Deus e que os levitas, guardas da porta, tinham ajuntado, dinheiro provindo das mãos de Manassés, de Efraim e de todo o resto de Israel, como também de todo o Judá e Benjamim e dos habitantes de Jerusalém.
10 Dem kon give di money to di three men wey dey ripair di temple wey
10 Eles o entregaram aos que dirigiam a obra e tinham a seu cargo a Casa do Senhor , para que pagassem àqueles que faziam a obra, trabalhadores na Casa do Senhor , para repararem e restaurarem a casa.
11 leta give di karpenters and doz wey dey build, so dat dem go use am take buy strong stones and timba, to take ripair di house wey Judah kings bin skata.
11 Deram-no aos carpinteiros e aos edificadores, para comprarem pedras lavradas e madeiras para as junturas e para servirem de vigas para as casas que os reis de Judá deixaram cair em ruína.
12 Di men work with all dia mind and di four Levi men wey dey supavise dem na: Jahat and Obadaya from Merari; Zekaraya and Meshullam from Kohat family. (All Levi pipol wey dey der, sabi sing well-well.)
12 Os homens procederam fielmente na obra; e os superintendentes deles eram Jaate e Obadias, levitas, dos filhos de Merari, como também Zacarias e Mesulão, dos filhos dos coatitas, para superintenderem a obra.
13 Oda Levi pipol still dey supavise difren works, while some na guards and ofisas.
13 Todos os levitas peritos em instrumentos músicos eram superintendentes dos carregadores e dirigiam a todos os que faziam a obra, em qualquer sorte de trabalho. Outros levitas eram escrivães, oficiais e porteiros.
14 Wen dem remove di silva wey dem bring kom God Temple, Priest Hilkaya kon si di Law Book wey God give Moses.
14 Quando se tirava o dinheiro que se havia trazido à Casa do Senhor , Hilquias, o sacerdote, achou o Livro da Lei do Senhor , dada por intermédio de Moisés.
15 Priest Hilkaya tell Shafan. “I don si di Law Book for God Temple.” Den e give di book to Shafan.
15 Então, disse Hilquias ao escrivão Safã: Achei o Livro da Lei na Casa do Senhor .
16 Shafan take di book go give di king kon sey, “Yor savants dey do evritin wey dem give dem.
16 Hilquias entregou o livro a Safã. Então, Safã levou o livro ao rei e lhe deu relatório, dizendo: Tudo quanto se encomendou a teus servos, eles o fazem.
17 Dem melt di silva for God Temple kon gi-am to doz wey dey supavise dia work.”
17 Contaram o dinheiro que se achou na Casa do Senhor e o entregaram nas mãos dos que dirigem a obra e dos que a executam.
18 Shafan still tell di king, “Na Priest Hilkaya give mi dis book.” Den Shafan shaut as e dey read wetin dey di book give di king.
18 Relatou mais o escrivão ao rei, dizendo: O sacerdote Hilquias me entregou um livro. Safã leu nele diante do rei.
19 Wen di king hear di words wey dem rite for di Law Book, e kon tear en klot.
19 Tendo o rei ouvido as palavras da lei, rasgou as suas vestes.
20 Di king sey make Priest Hilkaya orda Ahikam wey bi Shafan pikin; Abdon wey Mikah born; Shafan wey bi di seketry and Asaya wey bi di king savant sey:
20 Ordenou o rei a Hilquias, a Aicão, filho de Safã, a Abdom, filho de Mica, a Safã, o escrivão, e a Asaías, servo do rei, dizendo:
21 “Make una go pray give God for mi and di pipol wey remain for Judah and Israel. Den ask am about di words wey dey dis book wey dem si, bikos God dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor obey en word as dem rite am for dis book!”
21 Ide e consultai o Senhor por mim e pelos restantes em Israel e Judá, acerca das palavras deste livro que se achou; porque grande é o furor do Senhor , que se derramou sobre nós, porquanto nossos pais não guardaram as palavras do Senhor , para fazerem tudo quanto está escrito neste livro.
22 So Priest Hilkaya and di oda pipol wey di king send with dem kon go meet Profetes Hulda wey dey stay di new part for Jerusalem. (En husband na Shallum wey Tokhat born and na Hasrah wey dey kare for di temple robe, bi en grand-papa.)
22 Então, Hilquias e os enviados pelo rei foram ter com a profetisa Hulda, mulher de Salum, o guarda-roupa, filho de Tocate, filho de Harás, e lhe falaram a esse respeito. Ela habitava na Cidade Baixa, em Jerusalém.
23 den di woman sey, “Make una go tell di king,
23 Ela lhes disse: Assim diz o Senhor , o Deus de Israel: Dizei ao homem que vos enviou a mim:
24 ‘God sey: “I go ponish Jerusalem and all di pipol with di curse dem wey dey inside dis book wey dem read gi-am.
24 Assim diz o Senhor : Eis que trarei males sobre este lugar e sobre os seus moradores, a saber, todas as maldições escritas no livro que leram diante do rei de Judá.
25 Dem don rijet mi kon dey sakrifice give oda gods, so I dey vex for wetin dem do. I dey vex naw for Jerusalem and nor-tin go fit stop mi make I nor ponish dem.” ’
25 Visto que me deixaram e queimaram incenso a outros deuses, para me provocarem à ira com todas as obras das suas mãos, o meu furor está derramado sobre este lugar e não se apagará.
26 And for di king ensef, dis na wetin di Oga God dey tok: ‘Yu don listin to evritin wey dem rite for dis book
26 Porém ao rei de Judá, que vos enviou a consultar o Senhor , assim lhe direis: Assim diz o Senhor , o Deus de Israel, acerca das palavras que ouviste:
27 and yu kom turn from sin kom meet mi, as yu tear yor klot dey kry wen yu hear sey I won ponish Jerusalem with en pipol. I don hear una prayer.
27 Porquanto o teu coração se enterneceu, e te humilhaste perante Deus, quando ouviste as suas ameaças contra este lugar e contra os seus moradores, e te humilhaste perante mim, e rasgaste as tuas vestes, e choraste perante mim, também eu te ouvi, diz o Senhor .
28 So, I go let una die make dem beri una with peace. Una nor go si di wahala wey I won bring kom Jerusalem.’ ”
28 Pelo que eu te reunirei a teus pais, e tu serás recolhido em paz à tua sepultura, e os teus olhos não verão todo o mal que hei de trazer sobre este lugar e sobre os seus moradores. Então, levaram eles ao rei esta resposta.
29 Di king koll all di leaders for Judah and Jerusalem
29 Então, deu ordem o rei, e todos os anciãos de Judá e de Jerusalém se ajuntaram.
30 kon gada di pipol, di priest, Levi pipol; both old and yong pipol go God Temple and e shaut read wetin dem rite for di Law Book wey dem si for di temple.
30 O rei subiu à Casa do Senhor , e todos os homens de Judá, todos os moradores de Jerusalém, os sacerdotes, os levitas e todo o povo, desde o menor até ao maior; e leu diante deles todas as palavras do Livro da Aliança que fora encontrado na Casa do Senhor .
31 Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.
31 O rei se pôs no seu lugar e fez aliança ante o Senhor , para o seguirem, guardarem os seus mandamentos, os seus testemunhos e os seus estatutos, de todo o coração e de toda a alma, cumprindo as palavras desta aliança, que estavam escritas naquele livro.
32 E make all di pipol wey dey Jerusalem and Benjamin gri sey dem go do am. Pipol for Jerusalem follow di Oga wey bi dia grand-grand papa God kon obey en kovenant.
32 Todos os que se acharam em Jerusalém e em Benjamim anuíram a esta aliança; e os habitantes de Jerusalém fizeram segundo a aliança de Deus, o Deus de seus pais.
33 King Josaya remove all di juju from Israel pipol aria kon advise dem sey make dem serve God. For di time wen Josaya dey rule, di pipol nor sin against di Oga wey bi dia grand-grand papa God.
33 Josias tirou todas as abominações de todas as terras que eram dos filhos de Israel; e a todos quantos se acharam em Israel os obrigou a que servissem ao Senhor , seu Deus. Enquanto ele viveu, não se desviaram de seguir o Senhor , Deus de seus pais.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Crônicas 34, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.