2 Crônicas 24
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Joash na seven years wen e start to rule. E rule for forty years from Jerusalem. Na Zibaya wey kom from Beersheba bi en mama.
1 Joás tinha sete anos quando começou a reinar. Seu reinado, em Jerusalém, durou quarenta anos. Sua mãe chamava-se Sébia; era ela de Bersabéia.
2 King Joash obey God thru-out di time wen Priest Jehoiada dey alive.
2 Joás fez o bem aos olhos do Senhor durante toda a vida do sacerdote Jojada,
3 Priest Jehoiada choose two wife for King Joash and e get sons and dotas.
3 o qual lhe deu por esposas duas mulheres, das quais teve filhos e filhas.
4 Wen e don bi king for sometaim, e kon won ripair God Temple.
4 Depois disso, Joás tomou a peito restaurar o templo do Senhor.
5 E gada di priest and Levi pipol kon orda dem sey, “Make una go Judah towns go kollect plenty money kom from di pipol make wi take ripair God Temple.” E sey make dem kwik-kwik kollect am, but Levi pipol nor kwik rish der.
5 Convocou os sacerdotes e levitas e lhes disse: Ide e percorrei as cidades de Judá, e delas recolhereis anualmente dinheiro dos israelitas para reparar o templo de vosso Deus. Executai isso com presteza. Mas os levitas não se apressaram.
6 So, di king koll Priest Jehoiada kon sey, “Wetin make yu neva tell Levi pipol make dem kollect di tax from Judah and Jerusalem pipol, just as dem rite am for God savant Moses book?”
6 Então o rei mandou vir o sumo sacerdote Jojada e lhe disse: Por que não cuidaste que os levitas trouxessem de Judá e de Jerusalém a contribuição imposta por Moisés, servo do Senhor, à comunidade de Israel para a tenda do testemunho?
7 (Atalaya wiked well-well and en sons break enter God Temple kon use all di tins wey dey der take woship Baal juju.)
7 A ímpia Atalia e seus filhos destruíram a casa de Deus: fizeram servir ao culto de Baal todos os objetos sagrados do templo do Senhor.
8 Di king orda sey make dem make one box kon put am outside God Temple gate.
8 Então o rei ordenou que se fizesse um cofre e o colocassem na parte externa da porta do templo.
9 So dem send message go Jerusalem and Judah make evribody bring di tax, wey God savant, Moses, sey make Israel pipol dey pay wen dem dey wildaness.
9 Em seguida, publicou-se em Judá e em Jerusalém que levassem ao Senhor a contribuição imposta a Israel no deserto, por Moisés, servo do Senhor.
10 All di ofisas and di pipol kon happy as dem dey put dia silva inside di box till e full.
10 Todos os chefes e todo o povo, cheios de alegria, vieram colocar dinheiro no cofre até que este estivesse cheio.
11 Anytime wen Levi pipol si sey di box wey di royal money dey don full, doz wey dey kount di money go remove all di money kon karry di box go back to di gate. Na so dem dey do am evriday, until dem kollect plenty money.
11 Cada vez que, por meio dos levitas, era o cofre levado para a inspeção do rei - o que acontecia quando o dinheiro se acumulava -, o escriba real e um comissário do sumo sacerdote esvaziavam-no e depois os levitas iam colocá-lo no lugar. Assim faziam eles cada vez, e recolheram, em abundância, dinheiro,
12 Di king and Priest Jehoiada give di money to doz wey dem sey make dem ripair God Temple. Dem hire karpenter, doz wey get handwork, doz wey dey do bronze and iron sey make dem ripair God Temple.
12 que o rei e Jojada entregavam ao empreiteiro das obras do templo. Este contratava os carpinteiros, os canteiros e os trabalhadores que modelavam o ferro e o bronze, para restaurar e reparar o templo do Senhor.
13 Dem work well-well kon ripair di temple. Dem follow as di measurement bi for di temple kon do am like dat.
13 Os empreiteiros fizeram com que os reparos fossem acabados pelos seus cuidados, e restabeleceram o templo em seu primeiro estado e o consolidaram.
14 Wen dem don finish, dem karry di silva wey remain go give di king and Priest Jehoiada. Dem use am make difren tins for God Temple: tins wey dem take dey serve God for di temple; tins to take burnt sakrifice; pans with oda tins wey dem use gold and silva take make. Wen Priest Jehoiada dey alive, dem dey always burnt sakrifice for di temple.
14 Terminado o trabalho, devolveram na presença do rei e de Jojada o restante do dinheiro, com o qual fabricaram utensílios para o serviço do templo e para os holocaustos, assim como taças e outros objetos de ouro e prata. Enquanto viveu Jojada, foram regularmente oferecidos os holocaustos no templo do Senhor.
15 Priest Jehoiada old well-well and e die wen e bi one hundred and thirty years.
15 Jojada, velho e cheio de dias, morreu. Tinha cento e trinta anos.
16 Dem beri am for David Town with di oda kings, bikos e do good tins for Israel and for God Temple.
16 Sepultaram-no na cidade de Davi, com os reis, pois ele tinha feito o bem em Israel para com o Senhor e seu templo.
17 Wen Priest Jehoiada don die, Judah leaders kon visit di king, bikos of dia respet for Jehoiada. Di king kon listin to dia advise.
17 Depois da morte de Jojada, os chefes de Judá vieram e se prostraram diante do rei, e o rei os ouviu.
18 Dia Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem leave en temple kon bigin woship Asherah and difren juju. Bikos of dia sin, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol.
18 Abandonaram o templo do Senhor, Deus de seus pais, e se puseram a adorar as imagens de asserá e outros ídolos, e tamanhas faltas atraíram a ira divina contra Judá e Jerusalém.
19 God send profet go meet dem, so dat dem go turn back kom meet am. Dem warn dem well-well, but dem nor gri listin.
19 Enviou-lhes o Senhor profetas para os converterem a ele; porém, pregaram em vão, e não foram escutados.
20 God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”
20 Então o espírito de Deus apossou-se de Zacarias, filho do sacerdote Jojada, o qual se apresentou diante do povo: Eis, disse ele, o que diz o Senhor: Por que transgredis as ordens do Senhor? Nada conseguireis. Porque abandonastes o Senhor, o Senhor vos abandonará.
21 Dem plan kon stone Zekaraya die for God kourtyard.
21 Mas eles se revoltaram contra ele e o apedrejaram por ordem do rei no átrio do templo do Senhor.
22 Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”
22 Joás, esquecido dos benefícios que Jojada lhe dispensara, mandou matar o filho. Porem, ao expirar, disse Zacarias: Que o Senhor o veja, e faça vingança!
23 As di year dey start, Siria sojas attack Judah and Jerusalem kon karry many tins go Damaskus.
23 Ao fim de um ano, o exército dos sírios atacou Joás; invadiu Judá e Jerusalém, massacrou os chefes do povo e enviou todo o seu despojo ao rei de Damasco.
24 Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash.
24 Embora os sírios tivessem vindo em pequeno número, o Senhor lhes entregou um enorme exército, porque Judá tinha abandonado o Senhor, Deus de seus pais. Assim os sírios fizeram justiça a Joás.
25 Dem wound am well-well. So wen dem don fight finish, den two of en ofisas kon plan and kill-am for en bed, bikos of Zekaraya wey e kill. Dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
25 Apenas se afastaram, deixando-o como presa de grandes sofrimentos, seus homens, revoltados contra ele por causa do assassínio do filho do sacerdote Jojada, assassinaram-no em seu leito. Assim morreu e sepultaram-no na cidade de Davi, mas não nos sepulcros dos reis.
26 Doz wey plan against am na, Zabad wey one Ammon woman, Shimeat born and Jehozabad wey one Moab woman, Shimrit born.
26 Os conjurados eram Zabad, filho de Semaat, mulher amonita, e Jozabad, filho de Samarit, mulher moabita.
27 King Joash sons names, di tins wey dem profesai against Joash and as e take build God Temple again, dem rite am put for di kings book. Amazaya en pikin kon take-ova as king.
27 Tudo o que se refere a seus filhos, os numerosos oráculos proferidos contra ele e a restauração do templo estão relatados nas memórias do livro dos Reis. Seu filho Amasias sucedeu-lhe no trono.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Crônicas 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.