2 Crônicas 20

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Afta, Moab and Ammon pipol with some pipol from Meun kon attack Jehoshafat.
1 E sucedeu que, depois disto, os filhos de Moabe, e os filhos de Amom, e com eles outros dos amonitas, vieram à peleja contra Jeosafá.
2 Some messenjas go tell Jehoshafat sey, “Plenty sojas dey attack yor town from di oda side for di Dead Sea for Edom side, for Hazezon Tamar wey bi En-Gedi.”
2 Então vieram alguns que avisaram a Jeosafá, dizendo: Vem contra ti uma grande multidão dalém do mar e da Síria; e eis que já estão em Hazazom-Tamar, que é En-Gedi.
3 Jehoshafat kon dey fear, so e go meet God. E kommand evribody for Judah sey make dem fast.
3 Então Jeosafá temeu, e pôs-se a buscar o Senhor, e apregoou jejum em todo o Judá.
4 Judah pipol from difren town gada togeda kom sey make God help dem.
4 E Judá se ajuntou, para pedir socorro ao Senhor; também de todas as cidades de Judá vieram para buscar ao Senhor.
5 King Jehoshafat stand for where Judah and Jerusalem pipol gada put for di kourtyard front, wey dey God Temple
5 E pôs-se Jeosafá em pé na congregação de Judá e de Jerusalém, na casa do Senhor, diante do pátio novo.
6 kon pray:
6 E disse: Ah! Senhor Deus de nossos pais, porventura não és tu Deus nos céus? Não és tu que dominas sobre todos os reinos das nações? Na tua mão há força e potência, e não há quem te possa resistir.
7 Awa Oga God, Yu porshu doz wey dey dis land before kon gi-am to yor friend Abraham and en shidren-shidren Israel, wey bi yor pipol.
7 Porventura, ó nosso Deus, não lançaste fora os moradores desta terra de diante do teu povo Israel, e não a deste para sempre à descendência de Abraão, teu amigo?
8 Dem stay di town kon build temple put as respet for Yu sey,
8 E habitaram nela e edificaram-te nela um santuário ao teu nome, dizendo:
9 ‘If wahala kom meet us like sojas attack us, judgement, sickness or sey food nor dey, wi go kry kon meet Yu with awa pain, so dat Yu go hear and diliver us.’
9 Se algum mal nos sobrevier, espada, juízo, peste, ou fome, nós nos apresentaremos diante desta casa e diante de ti, pois teu nome está nesta casa, e clamaremos a ti na nossa angústia, e tu nos ouvirás e livrarás.
10 Naw, Ammon, Moab and pipol for Mount Seir dey kom! Wen Israel pipol komot from Egypt, Yu nor gri make dem fight dis pipol. Dem just pass and dem nor tosh dem.
10 Agora, pois, eis que os filhos de Amom, e de Moabe e os das montanhas de Seir, pelos quais não permitiste passar a Israel, quando vinham da terra do Egito, mas deles se desviaram e não os destruíram,
11 But naw, make Yu si how dem dey pay us back. Dem dey kom drive us komot from awa land wey Yu give us!
11 Eis que nos dão o pago, vindo para lançar-nos fora da tua herança, que nos fizeste herdar.
12 Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”
12 Ah! nosso Deus, porventura não os julgarás? Porque em nós não há força perante esta grande multidão que vem contra nós, e não sabemos o que faremos; porém os nossos olhos estão postos em ti.
13 All di men for Judah, dia wifes and shidren kon stand for God front.
13 E todo o Judá estava em pé perante o Senhor, como também as suas crianças, as suas mulheres, e os seus filhos.
14 Den Zekaraya wey Benaya born, God Spirit kon enter en pikin Jahaziel, for all di pipol present. Na Jeiel wey Matanaya born bi Benaya papa. Dem bi Levi pipol from Asaf family.
14 Então veio o Espírito do Senhor, no meio da congregação, sobre Jaaziel, filho de Zacarias, filho de Benaia, filho de Jeiel, filho de Matanias, levita, dos filhos de Asafe,
15 Jahaziel kon sey, “Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem with Jehoshafat, make una listin! Dis na wetin God dey tok, ‘Make una nor fear, bikos of dis plenty sojas! Bikos di fight nor bi una own, but na God go fight am.’
15 E disse: Dai ouvidos todo o Judá, e vós, moradores de Jerusalém, e tu, ó rei Jeosafá; assim o Senhor vos diz: Não temais, nem vos assusteis por causa desta grande multidão; pois a peleja não é vossa, mas de Deus.
16 Make una go fight dem tumoro as dem dey kom Ziz. Una go si dem for one small river for Jeruel Desert front.
16 Amanhã descereis contra eles; eis que sobem pela ladeira de Ziz, e os achareis no fim do vale, diante do deserto de Jeruel.
17 Una nor go fight for dis war. Make una just stand kon si how God go diliver una wey bi Judah and Jerusalem pipol. Make una nor fear, make una go fight dem tumoro, bikos God dey with una.”
17 Nesta batalha não tereis que pelejar; postai-vos, ficai parados, e vede a salvação do Senhor para convosco, ó Judá e Jerusalém. Não temais, nem vos assusteis; amanhã saí-lhes ao encontro, porque o Senhor será convosco.
18 King Jehoshafat kon bow and Judah pipol with doz wey dey stay Jerusalem, bow woship God.
18 Então Jeosafá se prostrou com o rosto em terra, e todo o Judá e os moradores de Jerusalém se lançaram perante o Senhor, adorando-o.
19 Den some Levi pipol wey kom from Kohat and Korah get up kon shaut dey praiz God.
19 E levantaram-se os levitas, dos filhos dos coatitas, e dos filhos dos coratitas, para louvarem ao Senhor Deus de Israel, com voz muito alta.
20 Di next day for early morning, dem mash go Tekoa Desert. Wen dem don ready to move, Jehoshafat kon stand sey: “Make una listin, una wey bi Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem! Make una trust di Oga una God and E go save una! Make una trust en profet words and una go win.”
20 E pela manhã cedo se levantaram e saíram ao deserto de Tecoa; e, ao saírem, Jeosafá pôs-se em pé, e disse: Ouvi-me, ó Judá, e vós, moradores de Jerusalém: Crede no Senhor vosso Deus, e estareis seguros; crede nos seus profetas, e prosperareis;
21 Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey,
21 E aconselhou-se com o povo, e ordenou cantores para o Senhor, que louvassem à Majestade santa, saindo diante dos armados, e dizendo: Louvai ao Senhor porque a sua benignidade dura para sempre.
22 As dem dey sing, na wons God attack Ammon, Moab and di men from Mount Seir wey dey kom fight Judah pipol, so Judah men win all of dem.
22 E, quando começaram a cantar e a dar louvores, o Senhor pôs emboscadas contra os filhos de Amom e de Moabe e os das montanhas de Seir, que vieram contra Judá, e foram desbaratados.
23 Ammon and Moab men attack di men wey kom from Mount Seir kon distroy dem. Wen dem kill Seir men finish, dem kon start to kill demsef.
23 Porque os filhos de Amom e de Moabe se levantaram contra os moradores das montanhas de Seir, para os destruir e exterminar; e, acabando eles com os moradores de Seir, ajudaram uns aos outros a destruir-se.
24 Wen Judah men rish di war front for di desert, na only dead body, dem si for groun.
24 Nisso chegou Judá à atalaia do deserto; e olharam para a multidão, e eis que eram corpos mortos, que jaziam em terra, e nenhum escapou.
25 King Jehoshafat with en men kon go pak di sojas tins. Dem pak dia klot and many oda betta tins. E take dem like three days to pak all di tins, bikos dem plenty well-well.
25 E vieram Jeosafá e o seu povo para saquear os seus despojos, e acharam entre eles riquezas e cadáveres em abundância, assim como objetos preciosos; e tomaram para si tanto, que não podiam levar; e três dias saquearam o despojo, porque era muito.
26 For di fourt day, dem gada go Beraca Valley kon praiz God for der. Na Beraca Valley dem dey koll dat place till today.
26 E ao quarto dia se ajuntaram no vale de Beraca; pois ali louvaram ao Senhor. Por isso chamaram aquele lugar o vale de Beraca, até ao dia de hoje.
27 All di men for Judah and Jerusalem kon dey happy as dem dey go Jerusalem and na Jehoshafat dey lead dem. God don give dem viktory ova dia enemies.
27 Então voltaram todos os homens de Judá e de Jerusalém, e Jeosafá à frente deles, e tornaram a Jerusalém com alegria; porque o Senhor os alegrara sobre os seus inimigos.
28 Dem enter Jerusalem with trumpet and oda tins wey dem take dey sing kon dey happy and dance go God Temple.
28 E vieram a Jerusalém com saltérios, com harpas e com trombetas, para a casa do Senhor.
29 All di oda kingdom wey near dem kon dey fear God wen dem hear as E fight Israel pipol enemies.
29 E veio o temor de Deus sobre todos os reinos daquelas terras, ouvindo eles que o Senhor havia pelejado contra os inimigos de Israel.
30 So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.
30 E o reino de Jeosafá ficou quieto; e o seu Deus lhe deu repouso ao redor.
31 King Jehoshafat reign for Judah. E bi thirty-five years wen e start to rule and e rule for twenty-five years from Jerusalem. En mama na Azuba wey bi Shilhi pikin.
31 E Jeosafá reinou sobre Judá; era da idade de trinta e cinco anos quando começou a reinar e vinte e cinco anos reinou em Jerusalém; e o nome de sua mãe era Azuba, filha de Sili.
32 E follow wetin Asa en papa do and e dey kareful and dey do only wetin God wont.
32 E andou no caminho de Asa, seu pai, e não se desviou dele, fazendo o que era reto aos olhos do Senhor.
33 But e nor still skata all di place where dem for dey serve juju and di pipol nor use all dia mind serve dia grand-grand papa God.
33 Contudo os altos não foram tirados porque o povo não tinha ainda disposto o seu coração para com o Deus de seus pais.
34 Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.
34 Ora, o restante dos atos de Jeosafá, assim, desde os primeiros até os últimos, eis que está escrito nas notas de Jeú, filho de Hanani, que as inseriu no livro dos reis de Israel.
35 Leta, King Jehoshafat make friend with King Ahazaya for Israel wey do many wiked tins.
35 Porém, depois disto, Jeosafá, rei de Judá, se aliou com Acazias, rei de Israel, que procedeu com toda a impiedade.
36 Dem agri to make ship wen dem go take travel go Tarshish and dem make di ship for Ezion-Geber.
36 E aliou-se com ele, para fazerem navios que fossem a Társis; e fizeram os navios em Eziom-Geber.
37 Dodavahu pikin Elieza from Maresha kon tok against King Jehoshafat sey, “Bikos yu enter agriment with King Ahazaya, God go skata wetin yu don make.” Di ship sink and e nor fit go Tarshish again.
37 Porém Eliezer, filho de Dodava, de Maressa, profetizou contra Jeosafá, dizendo: Porquanto te aliaste com Acazias, o Senhor despedaçou as tuas obras. E os navios se quebraram, e não puderam ir a Társis.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Crônicas 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.