2 Coríntios 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 I nor nid to rite to una about how to help God pipol wey dey Jerusalem,
1 Pois quanto à ministração que se faz a favor dos santos, não necessito escrever-vos;
2 bikos I know sey una one help dem. I always dey boast give Masidonia pipol sey, una wey dey Akaia, dey always won help and una don ready to give money since last year. And di way wey una dey won help, don make some for dem won help too.
2 porque bem sei a vossa prontidão, pela qual me glorio de vós perante os macedônios, dizendo que a Acaia está pronta desde o ano passado; e o vosso zelo tem estimulado muitos.
3 But I dey send dis brodas kom meet una to make sure sey una dey ready; as I don tell dem before sey, una don already kollect money. So make una nor let shame katch mi, as I dey boast about una.
3 Mas enviei estes irmãos, a fim de que neste particular não se torne vão o nosso louvor a vosso respeito; para que, como eu dizia, estejais preparados,
4 But if anybody for Masidonia follow mi kom meet una, den e si sey una neva ready to give, shame go katch us, (I nor go tok too mush) bikos wi trust una.
4 a fim de, se acaso alguns macedônios forem comigo, e vos acharem desaparecidos, não sermos nós envergonhados {para não dizermos vós} nesta confiança.
5 Naim make mi beg dis brodas make dem go for my front before di time go rish and make dem help una arrange di money wey una promise, so dat una go do am with una mind and nobody go force una.
5 Portanto, julguei necessário exortar estes irmãos que fossem adiante ter convosco, e preparassem de antemão a vossa beneficência, já há tempos prometida, para que a mesma esteja pronta como beneficência e não como por extorsão.
6 Na wetin I dey tok bi dis; Pesin wey plant small, go harvest small, but di pesin wey plant plenty, go harvest plenty.
6 Mas digo isto: Aquele que semeia pouco, pouco também ceifará; e aquele que semeia em abundância, em abundância também ceifará,
7 Make each of una give as e plan for en mind; nor bi with regret or like sey dem force am, bikos God love pesin wey dey give with happiness.
7 Cada um contribua segundo propôs no seu coração; não com tristeza, nem por constrangimento; porque Deus ama ao que dá com alegria.
8 God go provide evritin wey una nid. Den, una go always get evritin wey una nid and di one wey una go fit give odas.
8 E Deus é poderoso para fazer abundar em vós toda a graça, a fim de que, tendo sempre, em tudo, toda a suficiência, abundeis em toda boa obra;
9 Just as dem rite for God word, “E don skata for evriwhere, e don give to poor pipol and en raitiousness, go dey forever.”
9 conforme está escrito: Espalhou, deu aos pobres; a sua justiça permanece para sempre.
10 Bikos na God dey give seed to farmer and provide bread wey pipol go chop. Like dis too, E go provide and di tins wey una nid, go plenty well-well and dem go last forever.
10 Ora, aquele que dá a semente ao que semeia, e pão para comer, também dará e multiplicará a vossa sementeira, e aumentará os frutos da vossa justiça.
11 E go make una get enough money for evritin, so dat evritime, una go fit dey give well-well and di pipol wey una give money, go always dey tank God.
11 enquanto em tudo enriqueceis para toda a liberalidade, a qual por nós reverte em ações de graças a Deus.
12 Bikos dis work wey una dey do so, nor just dey help only God pipol, but e dey always make pipol, tank God.
12 Porque a ministração deste serviço não só supre as necessidades dos santos, mas também transborda em muitas ações de graças a Deus;
13 Bikos of una work, pipol go praiz God, bikos una dey obey Christ word wey una bilive and una dey share evritin wey una get with good mind.
13 visto como, na prova desta ministração, eles glorificam a Deus pela submissão que confessais quanto ao evangelho de Cristo, e pela liberalidade da vossa contribuição para eles, e para todos;
14 So, bikos of God big grace wey E give una, pipol dey pray for una with strong love.
14 enquanto eles, pela oração por vós, demonstram o ardente afeto que vos têm, por causa da superabundante graça de Deus que há em vós.
15 Na dis make us dey tank God for dis gift wey pesin mout nor fit tok.
15 Graças a Deus pelo seu dom inefável.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.