2 Coríntios 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Awa brodas and sistas, wi don tell una about di grace wey God give di pipol for di church for Masidonia sey,
1 Também, irmãos, vos fazemos conhecer a graça de Deus dada às igrejas da Macedônia;
2 even wen dia sofa strong well-well; dem still dey happy and wen dem nor get money at-all; dem still dey fine money give us.
2 como, em muita prova de tribulação, houve abundância do seu gozo, e como a sua profunda pobreza superabundou em riquezas da sua generosidade.
3 I bi witness sey dem dey give akordin to wetin dem get. Sometaim, dem dey give pass wetin dem get. Nobody dey force dem to do like dat, but dem dey do am from dia own mind
3 Porque, segundo o seu poder (o que eu mesmo testifico) e ainda acima do seu poder, deram voluntariamente,
4 and dem dey beg us make wi let dem do am, so dat dem go get di blessing wey dey follow pipol wey dey give.
4 pedindo-nos com muitos rogos a graça e a comunicação deste serviço, que se fazia para com os santos.
5 Dem dey do like dis, nor bi only as wi wont am, but na bikos dem don first give demsef to God, den dem kon give demsef to us as God wont.
5 E não somente fizeram como nós esperávamos, mas também a si mesmos se deram primeiramente ao Senhor e depois a nós, pela vontade de Deus;
6 Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una.
6 de maneira que exortamos a Tito que, assim como antes tinha começado, assim também acabe essa graça entre vós.
7 But as una dey do well for evritin: For faith; for tok; for wetin una know and as una won do di work well, bikos una love us, make una make sure sey una dey do dis good with all una heart.
7 Portanto, assim como em tudo sois abundantes na fé, e na palavra, e na ciência, e em toda diligência, e em vosso amor para conosco, assim também abundeis nessa graça.
8 Nor bi sey I dey kommand una, but I won si weda una love na really won like di oda church pipol own.
8 Não digo isso como quem manda, mas para provar, pela diligência dos outros, a sinceridade do vosso amor;
9 Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.
9 porque já sabeis a graça de nosso Senhor Jesus Cristo, que, sendo rico, por amor de vós se fez pobre, para que, pela sua pobreza, enriquecêsseis.
10 Na wetin I tink for di matter bi dis: Una start well last year for how una dey give and how una dey won give,
10 E nisso dou o meu parecer; pois isso vos convém a vós, que desde o ano passado começastes; e não foi só praticar, mas também querer.
11 so e betta make una just finish wetin una start, so dat di way wey una take start, na so too una go still take finish am as una pawa rish.
11 Agora, porém, completai também o já começado, para que, assim como houve a prontidão de vontade, haja também o cumprimento, segundo o que tendes.
12 Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.
12 Porque, se há prontidão de vontade, será aceita segundo o que qualquer tem e não segundo o que não tem.
13 I nor dey tok dis one, so dat wen una don give oda pipol, dem go kon get and una go kon dey sofa, but na to make sure sey tins dey ekwol.
13 Mas não digo isso para que os outros tenham alívio, e vós, opressão;
14 As tins bi naw, di money wey una get go help dem as dem nor get, so dat one day, di money wey dem go get go still help una wen una nor get, dat time evritin go kon dey ekwol, bikos
14 mas para igualdade; neste tempo presente, a vossa abundância supra a falta dos outros, para que também a sua abundância supra a vossa falta, e haja igualdade,
15 dem rite for God word sey: “Di pesin wey gada plenty, nor go get plenty and di pesin wey gada small, go get di one wey go rish am.”
15 como está escrito: O que muito colheu não teve de mais; e o que pouco, não teve de menos.
16 Wi tank God wey give Titus di kind mind wey I get to help una.
16 Mas graças a Deus, que pôs a mesma solicitude por vós no coração de Tito;
17 Bikos e nor only gri for wetin wi ask am, but e dey help una well-well and nobody force am kom meet una.
17 pois ele aceitou a exortação e, muito diligente, partiu voluntariamente para vós.
18 And di broda wey all di church dem dey praiz, bikos of how e dey prish di gospel, wi dey send am follow Titus too and
18 E com ele enviamos aquele irmão cujo louvor no evangelho está espalhado em todas as igrejas.
19 bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help.
19 E não só isso, mas foi também escolhido pelas igrejas para companheiro da nossa viagem, nessa graça que por nós é ministrada para glória do mesmo Senhor e prontidão do vosso ânimo;
20 Wi dey do like dis, so dat nobody go komplain as wi dey share dis gift.
20 evitando isto: que alguém nos vitupere por essa abundância, que por nós é ministrada;
21 Bikos wi dey try to do wetin dey rite, nor bi only for God eye, but for pipol eye too.
21 pois zelamos o que é honesto, não só diante do Senhor, mas também diante dos homens.
22 So wi dey send awa broda follow dem; awa broda wey wi don test plenty times kon si sey e get di mind to help and e ready to help naw, bikos e trust una well-well.
22 Com eles, enviamos também outro nosso irmão, o qual, muitas vezes e em muitas coisas, já experimentamos ser diligente e agora muito mais diligente ainda pela muita confiança que em vós tem.
23 But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.
23 Quanto a Tito, é meu companheiro e cooperador para convosco; quanto a nossos irmãos, são embaixadores das igrejas e glória de Cristo.
24 So make una show dem sey, una love dem, so dat all di pipol for di church go know sey, di way wey wi dey boast about una, na true.
24 Portanto, mostrai para com eles, perante a face das igrejas, a prova do vosso amor e da nossa glória acerca de vós.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.