2 Coríntios 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.
1 Tendo, pois, ó amados, tais promessas, purifiquemo-nos de toda impureza, tanto da carne como do espírito, aperfeiçoando a nossa santidade no temor de Deus.
2 Make una allow di gospel enter una heart bikos wi nor do bad to anybody or fall anybody business or play anybody wayo.
2 Acolhei-nos em vosso coração; a ninguém tratamos com injustiça, a ninguém corrompemos, a ninguém exploramos.
3 I nor dey tok dis one to kondemn una, bikos I don tell una before sey, una dey awa mind and wi with una go die and live togeda with Christ.
3 Não falo para vos condenar; porque já vos tenho dito que estais em nosso coração para, juntos, morrermos e vivermos.
4 For inside all dis sofa wey wi dey sofa, I still trust and dey boast well-well about una, bikos I get mind for una and my happiness full dey trowey.
4 Mui grande é a minha franqueza para convosco, e muito me glorio por vossa causa; sinto-me grandemente confortado e transbordante de júbilo em toda a nossa tribulação.
5 Even wen wi enter Masidonia, wi nor rest at-all, but dem trobol us from difren korna; wahala for outside, fear for inside.
5 Porque, chegando nós à Macedônia, nenhum alívio tivemos; pelo contrário, em tudo fomos atribulados: lutas por fora, temores por dentro.
6 But God wey dey help pipol wey nor happy, naim kon help us wen Titus kom.
6 Porém Deus, que conforta os abatidos, nos consolou com a chegada de Tito;
7 Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before.
7 e não somente com a sua chegada, mas também pelo conforto que recebeu de vós, referindo-nos a vossa saudade, o vosso pranto, o vosso zelo por mim, aumentando, assim, meu regozijo.
8 Bikos even if I make una vex with my leta, e nor pain mi sey I rite am (even doh e pain mi as I know sey e make una vex, aldo una vexnashon nor tey).
8 Porquanto, ainda que vos tenha contristado com a carta, não me arrependo; embora já me tenha arrependido (vejo que aquela carta vos contristou por breve tempo),
9 Naw I dey happy, nor bi bikos una dey vex, but bikos una vexnashon make una turn from sin kom meet God. Na so God plan una vexnashon, so dat bad tins nor go happen to una bikos of dis vexnashon wey wi kause for una.
9 agora, me alegro não porque fostes contristados, mas porque fostes contristados para arrependimento; pois fostes contristados segundo Deus, para que, de nossa parte, nenhum dano sofrêsseis.
10 Bikos wen God make pipol sorry for di sin wey dem kommit, dem go turn kom meet am, den God go save dem and dem nor go regret again. But di vexnashon wey dis world dey bring, na deat dey end am.
10 Porque a tristeza segundo Deus produz arrependimento para a salvação, que a ninguém traz pesar; mas a tristeza do mundo produz morte.
11 Naw, make una si wetin dis vexnashon wey God plan don do for una: Si how una work for God bi naw; si how una won show sey una hand klean; si as una dey vex bikos of di bad tin wey happen; si how una dey sopraiz; si as una dey won si and worry about us; si how una ready to ponish anybody wey do bad! For evritin, una don show sey una hand klean for dis matter.
11 Porque quanto cuidado não produziu isto mesmo em vós que, segundo Deus, fostes contristados! Que defesa, que indignação, que temor, que saudades, que zelo, que vindita! Em tudo destes prova de estardes inocentes neste assunto.
12 I nor rite dis leta give una bikos of di pesin wey do bad or di pesin wey dem do di bad to, but na to show una how una won work for God bikos of us.
12 Portanto, embora vos tenha escrito, não foi por causa do que fez o mal, nem por causa do que sofreu o agravo, mas para que a vossa solicitude a nosso favor fosse manifesta entre vós, diante de Deus.
13 So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest.
13 Foi por isso que nos sentimos confortados. E, acima desta nossa consolação, muito mais nos alegramos pelo contentamento de Tito, cujo espírito foi recreado por todos vós.
14 I don boast gi-am about una and una nor let mi shame, but as evritin wey wi tell una na true, na so all di boast wey wi boast about una give Titus, na trut too.
14 Porque, se nalguma coisa me gloriei de vós para com ele, não fiquei envergonhado; pelo contrário, como, em tudo, vos falamos com verdade, também a nossa exaltação na presença de Tito se verificou ser verdadeira.
15 And wen e remember how una obey and welkom am with respet and fear, di love wey e get for una, kon strong well-well.
15 E o seu entranhável afeto cresce mais e mais para convosco, lembrando-se da obediência de todos vós, de como o recebestes com temor e tremor.
16 Evritin dey make mi happy, bikos di trust wey I trust una, nor dey shake.
16 Alegro-me porque, em tudo, posso confiar em vós.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.