2 Coríntios 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive.
1 Na qualidade de colaboradores seus, exortamo-vos a que não recebais a graça de Deus em vão.
2 Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!
2 Pois ele diz: Eu te ouvi no tempo favorável e te ajudei no dia da salvação {Is 49,8}. Agora é o tempo favorável, agora é o dia da salvação.
3 Wi nor dey do anytin wey go make anybody vex, so dat nobody go si any fault for awa work.
3 A ninguém damos qualquer motivo de escândalo, para que o nosso ministério não seja criticado.
4 But wi dey show sey wi bi God savant for evritin wey wi dey do. Wi dey sofa well-well and face trobol for dis time; even for wiked times;
4 Mas em todas as coisas nos apresentamos como ministros de Deus, por uma grande constância nas tribulações, nas misérias, nas angústias,
5 for di time wey dem dey beat us and put us for prison; for di time wey dem dey fight; for wahala time; for nite wey wi nor fit sleep and for hongry time.
5 nos açoites, nos cárceres, nos tumultos populares, nos trabalhos, nas vigílias, nas privações;
6 Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol;
6 pela pureza, pela ciência, pela longanimidade, pela bondade, pelo Espírito Santo, por uma caridade sincera,
7 thru di word wey wi dey tish with God pawa; with wetin wi take dey defend awa raitiousness both for awa rite and left hand;
7 pela palavra da verdade, pelo poder de Deus; pelas armas da justiça ofensivas e defensivas,
8 for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut.
8 através da honra e da desonra, da boa e da má fama.
9 Dat time, e bi like sey nobody know us, but evribody know us; e bi like sey wi don die, but wi dey alive; wi still dey alive like pipol wey dem dey ponish, but dem nor fit kill us;
9 Tidos por impostores, somos, no entanto, sinceros; por desconhecidos, somos bem conhecidos; por agonizantes, estamos com vida; por condenados e, no entanto, estamos livres da morte.
10 wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.
10 Somos julgados tristes, nós que estamos sempre contentes; indigentes, porém enriquecendo a muitos; sem posses, nós que tudo possuímos!
11 So, una wey bi Korint pipol, wi don open awa heart tell una evritin.
11 Ó coríntios, acabamos de vos falar com toda a franqueza. O nosso coração está todo ele aberto.
12 Wi nor dey whole awa love from una, but na una dey whole una love from us.
12 Não é estreito o lugar que nele ocupais. Estreito, isso sim, é vosso íntimo.
13 So make wi make am ekwol. I dey tok to una like sey una bi my shidren, so make una open una heart for us too.
13 Correspondei-me com igual ternura. Falo como a meus filhos: também vós outros abri largamente os vossos corações.
14 Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda?
14 Não vos prendais ao mesmo jugo com os infiéis. Que união pode haver entre a justiça e a iniqüidade? Ou que comunidade entre a luz e as trevas?
15 And na wish kind agriment Christ and devil get? Wetin koncern pesin wey bilive and pesin wey nor bilive?
15 Que compatibilidade pode haver entre Cristo e Belial? Ou que acordo entre o fiel e o infiel?
16 Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
16 Como conciliar o templo de Deus e os ídolos? Porque somos o templo de Deus vivo, como o próprio Deus disse: Eu habitarei e andarei entre eles, e serei o seu Deus e eles serão o meu povo {Lv 26,11s}.
17 Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una
17 Portanto, saí do meio deles e separai-vos, diz o Senhor. Não toqueis no que é impuro, e vos receberei.
18 kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.
18 Serei para vós um Pai e vós sereis para mim filhos e filhas, diz o Senhor todo-poderoso {Is 52,11; Jr 31,9}.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.