2 Coríntios 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.
1 Porque sabemos que, se a nossa casa terrestre deste tabernáculo se desfizer, temos de Deus um edifício, uma casa não feita por mãos, eterna, nos céus.
2 Bikos for dis awa house for eart, wi dey struggol, bikos wi nor fit wait to wear awa new body for heaven.
2 E por isso também gememos, desejando ser revestidos da nossa habitação, que é do céu;
3 Afta wi don wear awa new body for heaven, wi nor go dey naked again.
3 Se, todavia, estando vestidos, não formos achados nus.
4 Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die.
4 Porque também nós, os que estamos neste tabernáculo, gememos carregados; não porque queremos ser despidos, mas revestidos, para que o mortal seja absorvido pela vida.
5 Naw, di Pesin wey prepare us for dis tins, na God wey give us di Spirit, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E get for us.
5 Ora, quem para isto mesmo nos preparou foi Deus, o qual nos deu também o penhor do Espírito.
6 So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey,
6 Por isso estamos sempre de bom ânimo, sabendo que, enquanto estamos no corpo, vivemos ausentes do Senhor
7 bikos wi dey live awa life with faith, nor bi with wetin wi dey si.
7 (Porque andamos por fé, e não por vista).
8 So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey.
8 Mas temos confiança e desejamos antes deixar este corpo, para habitar com o Senhor.
9 So, weda wi dey alive or wi don die, wi dey do evritin wey wi fit do to make Christ happy.
9 Pois que muito desejamos também ser-lhe agradáveis, quer presentes, quer ausentes.
10 Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.
10 Porque todos devemos comparecer ante o tribunal de Cristo, para que cada um receba segundo o que tiver feito por meio do corpo, ou bem, ou mal.
11 So, bikos wi know wetin e mean to fear God, naim make us dey prish and beg pipol. But God know us well-well and I hope sey una know us well-well for una mind too.
11 Assim que, sabendo o temor que se deve ao Senhor, persuadimos os homens à fé, mas somos manifestos a Deus; e espero que nas vossas consciências sejamos também manifestos.
12 Wi nor dey try to tok make una for sey wi dey good, but wi dey give una shance to boast, so dat una go fit ansa pipol wey dey boast with wetin eye fit si, but nor bi wetin dey dia mind.
12 Porque não nos recomendamos outra vez a vós; mas damo-vos ocasião de vos gloriardes de nós, para que tenhais que responder aos que se gloriam na aparência e não no coração.
13 If wi dey kraze, na bikos of God; but if wi nor dey kraze, na bikos of una.
13 Porque, se enlouquecemos, é para Deus; e, se conservamos o juízo, é para vós.
14 Bikos na Christ love dey kontrol us since wi know sey, Christ die for evribody; so evribody don die.
14 Porque o amor de Cristo nos constrange, julgando nós assim: que, se um morreu por todos, logo todos morreram.
15 And e die for evribody, so dat evribody wey dey live nor go live for diasef again, but for di Pesin wey die and wake-up afta three days.
15 E ele morreu por todos, para que os que vivem não vivam mais para si, mas para aquele que por eles morreu e ressuscitou.
16 So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.
16 Assim que daqui por diante a ninguém conhecemos segundo a carne, e, ainda que também tenhamos conhecido Cristo segundo a carne, contudo agora já não o conhecemos deste modo.
17 So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one!
17 Assim que, se alguém está em Cristo, nova criatura é; as coisas velhas já passaram; eis que tudo se fez novo.
18 All dis tins dey kom from God wey make us en friends bikos of Christ and E still give us di ministry wey go make pipol bi en friend.
18 E tudo isto provém de Deus, que nos reconciliou consigo mesmo por Jesus Cristo, e nos deu o ministério da reconciliação;
19 So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend.
19 Isto é, Deus estava em Cristo reconciliando consigo o mundo, não lhes imputando os seus pecados; e pôs em nós a palavra da reconciliação.
20 Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”
20 De sorte que somos embaixadores da parte de Cristo, como se Deus por nós rogasse. Rogamo-vos, pois, da parte de Cristo, que vos reconcilieis com Deus.
21 Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.
21 Àquele que não conheceu pecado, o fez pecado por nós; para que nele fôssemos feitos justiça de Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.