2 Coríntios 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 So as wi get dis ministry, just as God don show us mesi, awa hope don strong well-well.
1 Pelo que, tendo este ministério, assim como já alcançamos misericórdia, não desfalecemos;
2 But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
2 pelo contrário, rejeitamos as coisas ocultas, que são vergonhosas, não andando com astúcia, nem adulterando a palavra de Deus; mas, pela manifestação da verdade, nós nos recomendamos à consciência de todos os homens diante de Deus.
3 But even if dem use klot take kover di gospel wey wi dey prish, doz wey don lost, na only dem nor go si am,
3 Mas, se ainda o nosso evangelho está encoberto, é naqueles que se perdem que está encoberto,
4 bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.
4 nos quais o deus deste século cegou os entendimentos dos incrédulos, para que lhes não resplandeça a luz do evangelho da glória de Cristo, o qual é a imagem de Deus.
5 Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.
5 Pois não nos pregamos a nós mesmos, mas a Cristo Jesus como Senhor; e a nós mesmos como vossos servos por amor de Jesus.
6 Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
6 Porque Deus, que disse: Das trevas brilhará a luz, é quem brilhou em nossos corações, para iluminação do conhecimento da glória de Deus na face de Cristo.
7 But dis betta tin wey God give us, wi dey karry am for inside awa body wey go die like klay pot wey break and na God give us di pawa.
7 Temos, porém, este tesouro em vasos de barro, para que a excelência do poder seja de Deus, e não da nossa parte.
8 Wi dey face wahala for difren korna, but awa body nor skata; wi dey konfuse sometaim, but wi nor dey luz hope,
8 Em tudo somos atribulados, mas não angustiados; perplexos, mas não desesperados;
9 pipol dey ponish us, but God nor let us die; dem dey nak us for groun, but dem nor fit distroy us.
9 perseguidos, mas não desamparados; abatidos, mas não destruídos;
10 As wi dey waka, wi karry Christ deat for awa body, so dat pipol go si Jesus life for awa body too.
10 trazendo sempre no corpo o morrer de Jesus, para que também a vida de Jesus se manifeste em nossos corpos;
11 Dem always dey won kill wi wey dey alive bikos of Jesus Christ, so dat dem go si Jesus life for awa ordinary body.
11 pois nós, que vivemos, estamos sempre entregues à morte por amor de Jesus, para que também a vida de Jesus se manifeste em nossa carne mortal.
12 Bikos of dis, deat dey work inside us, but life dey work inside una.
12 De modo que em nós opera a morte, mas em vós a vida.
13 But as e bi sey wi get di same spirit wey dey give faith, just as dem rite sey, “I bilive; naim make mi dey tok.” So wisef bilive, naim make us dey tok too.
13 Ora, temos o mesmo espírito de fé, conforme está escrito: Cri, por isso falei; também nós cremos, por isso também falamos,
14 Wi do like dis, bikos wi know sey di Pesin wey raiz-up Jesus, go still raiz us up with Jesus and E go take wi and una enter en kingdom.
14 sabendo que aquele que ressuscitou o Senhor Jesus, nos ressuscitará a nós com Jesus, e nos apresentará convosco.
15 All dis tins na for una good, so dat God grace wey dey rish many pipol evriday, go make pipol dey tank God more-more and all di glory go bi en own.
15 Pois tudo é por amor de vós, para que a graça, multiplicada por meio de muitos, faça abundar a ação de graças para glória de Deus.
16 So, make wi nor luz hope, bikos even if awa body dey die go small-small, di Pesin wey dey inside us, dey fresh evriday.
16 Por isso não desfalecemos; mas ainda que o nosso homem exterior se esteja consumindo, o interior, contudo, se renova de dia em dia.
17 Bikos di small trobol wey wi dey face naw, go bring glory wey big well-well, wey go last forever and wey betta pass anytin for dis world.
17 Porque a nossa leve e momentânea tribulação produz para nós cada vez mais abundantemente um eterno peso de glória;
18 Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.
18 não atentando nós nas coisas que se vêem, mas sim nas que se não vêem; porque as que se vêem são temporais, enquanto as que se não vêem são eternas.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.