2 Coríntios 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am, naim and Timoti awa broda, rite dis leta go give God pipol for di church wey dey Korint and to all di good brodas for Akaia.
1 Paulo, apóstolo de Jesus Cristo, pela vontade de Deus, e o irmão Timóteo, à igreja de Deus, que está em Corinto, com todos os santos que estão em toda a Acaia.
2 Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
2 Graça a vós e paz da parte de Deus nosso Pai, e da do Senhor Jesus Cristo.
3 Make wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, di God wey dey give mesi and konfort,
3 Bendito seja o Deus e Pai de nosso Senhor Jesus Cristo, o Pai das misericórdias e o Deus de toda a consolação;
4 E dey help us wen wi dey trobol, so dat wi go fit help odas thru di help wey E help us.
4 Que nos consola em toda a nossa tribulação, para que também possamos consolar os que estiverem em alguma tribulação, com a consolação com que nós mesmos somos consolados por Deus.
5 Just as wi sofa with Christ, na so too wi go get help from God thru Christ.
5 Porque, como as aflições de Cristo são abundantes em nós, assim também é abundante a nossa consolação por meio de Cristo.
6 If wi sofa, na for una good and salvashon; if wi dey okay, den una go fit bear di kind sofa wey wi bear.
6 Mas, se somos atribulados, é para vossa consolação e salvação; ou, se somos consolados, para vossa consolação é, a qual se opera suportando com paciência as mesmas aflições que nós também padecemos;
7 So, wi get hope about una, bikos wi know sey as una dey follow us sofa, na so una go still follow us get konfort.
7 E a nossa esperança acerca de vós é firme, sabendo que, como sois participantes das aflições, assim o sereis também da consolação.
8 My brodas and sistas, wi wont make una know about di wahala wey wi face for Asia aria. Di trobol wey wi face, heavy well-well and life kon taya us.
8 Porque não queremos, irmãos, que ignoreis a tribulação que nos sobreveio na Ásia, pois que fomos sobremaneira agravados mais do que podíamos suportar, de modo tal que até da vida desesperamos.
9 True-true, wi tink sey wi go die. But dis happen so dat wi nor go just trust awasef, but wi go trust God wey dey wake pipol from deat.
9 Mas já em nós mesmos tínha- mos a sentença de morte, para que não confiássemos em nós, mas em Deus, que ressuscita os mortos;
10 E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again.
10 O qual nos livrou de tão grande morte, e livra; em quem esperamos que também nos livrará ainda,
11 As una don join dey pray for us, na so too God go ansa all di many prayers wey una dey pray for us, den E go bless us and many pipol go kon tank am, bikos of wetin E dey do for us.
11 Ajudando-nos também vós com orações por nós, para que pela mercê, que por muitas pessoas nos foi feita, por muitas também sejam dadas graças a nosso respeito.
12 Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
12 Porque a nossa glória é esta: o testemunho da nossa consciência, de que com simplicidade e sinceridade de Deus, não com sabedoria carnal, mas na graça de Deus, temos vivido no mundo, e de modo particular convosco.
13 Bikos evritin wey I rite, na wetin una go fit read and undastand. But I hope sey una go undastand am well,
13 Porque nenhumas outras coisas vos escrevemos, senão as que já sabeis ou também reconheceis; e espero que também até ao fim as reconhecereis.
14 just as una don undastand us rish and na wi make una dey proud and na una go make us proud too, for di day wey Jesus go kom.
14 Como também já em parte reconhecestes em nós, que somos a vossa glória, como também vós sereis a nossa no dia do Senhor Jesus.
15 Na with dis mind I bi won take kom meet una before, so dat wi go bless una again.
15 E com esta confiança quis primeiro ir ter convosco, para que tivésseis uma segunda graça;
16 Bikos I plan to visit una wen I dey go Masidonia and wen I dey kom back, so dat una go help mi wen I dey travel go Judea.
16 E por vós passar à macedônia, e da macedônia ir outra vez ter convosco, e ser guiado por vós à Judéia.
17 So, wen I dey plan dis tins, I nor tink before I do am? Wen I dey plan, I dey plan bikos of wetin I wont? Or na bikos I ready to sey, “Yes, yes” or “No, no” at wons?
17 E, deliberando isto, usei porventura de leviandade? Ou o que delibero, o delibero segundo a carne, para que haja em mim sim, sim, e não, não?
18 But as God dey faithful, wetin wi dey prish give una nor bi make e for bi just “Yes” or “No.”
18 Antes, como Deus é fiel, a nossa palavra para convosco não foi sim e não.
19 Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.”
19 Porque o Filho de Deus, Jesus Cristo, que entre vós foi pregado por nós, isto é, por mim, Silvano e Timóteo, não foi sim e não; mas nele houve sim.
20 And evritin wey God promise us, na “Yes” thru Jesus Christ. Dat na why awa “Amen” thru Jesus Christ dey give God glory.
20 Porque todas quantas promessas há de Deus, são nele sim, e por ele o Amém, para glória de Deus por nós.
21 Na God make wi and una dey sure sey wi dey inside Christ. Na God choose us from odas
21 Mas o que nos confirma convosco em Cristo, e o que nos ungiu, é Deus,
22 and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.
22 O qual também nos selou e deu o penhor do Espírito em nossos corações.
23 Na God bi my witness, bikos E know my heart! Na bikos I nor won disturb una naim make mi nor go Korint again.
23 Invoco, porém, a Deus por testemunha sobre a minha alma, que para vos poupar não tenho até agora ido a Corinto;
24 Wi nor dey try to force una to bilive us; wi know sey una faith strong well-well. But wi dey work with una so dat una go dey happy well-well.
24 Não que tenhamos domínio sobre a vossa fé, mas porque somos cooperadores de vosso gozo; porque pela fé estais em pé.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.