2 Coríntios 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.
1 É esta a terceira vez que vou visitar-vos. Pelo depoimento de duas ou três testemunhas se resolve toda a questão.
2 Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,
2 Quando de minha segunda visita, já adverti àqueles que pecaram, e hoje, que estou ausente, torno a repeti-lo a eles e aos demais: se eu for outra vez, não usarei de perdão!
3 bikos una sey make I show sey Christ dey tok thru mi. Christ nor dey weak to una, bikos e show en pawa among una.
3 Simplesmente porque exigis a prova de que é Cristo que fala em mim. Ora, para convosco ele não é fraco, mas exerce o seu poder entre vós.
4 True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.
4 É verdade que ele foi crucificado por fraqueza, mas está vivo pelo poder de Deus. Também nós somos fracos nele, mas com ele viveremos, pelo poder de Deus para atuar entre vós.
5 Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!
5 Examinai-vos a vós mesmos, se estais na fé. Provai-vos a vós mesmos. Acaso não reconheceis que Cristo Jesus está em vós? A menos que a prova vos seja, talvez, desfavorável.
6 I hope sey una go know sey wi neva fail di test!
6 Mas espero que reconhecereis que ela não é contra nós.
7 Wi dey pray to God make una nor do anytin bad; wi nor dey do am to show sey wi pass di test, but make una for do wetin good, even if e bi like sey wi fail di test.
7 Entretanto, rogamos a Deus que não façais mal algum, não para que pareçamos aprovados, mas para que vós façais o bem, embora nós sejamos tidos como reprovados.
8 Wi nor go fit do anytin against di trut, but na di trut go make us do evritin.
8 Contra a verdade não temos poder algum; temo-lo apenas em prol da verdade.
9 Belle dey sweet us wen ever wi dey weak and una dey strong. And na wetin wi dey pray for bi dis, “Una go get evritin wey una suppose get.”
9 Alegramo-nos de ver-vos fortes, enquanto nós somos fracos. E até oramos por vossa perfeição.
10 Na dis make mi dey rite all dis tins since I nor dey with una, so dat wen I kom, I nor go vex for una bikos of di authority wey I get and God give mi dis authority to build; nor bi to distroy.
10 Eis por que eu vos escrevo de longe para que, estando presente, não tenha que usar de rigor, em vista do poder que o Senhor me conferiu para edificar, e não para destruir.
11 Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.
11 Por fim, irmãos, vivei com alegria. Tendei à perfeição, animai-vos, tende um só coração, vivei em paz, e o Deus de amor e paz estará convosco.
12 Make una greet each oda for Christian way.
12 Saudai-vos uns aos outros no ósculo santo.
13 All God pipol for here dey greet una.
13 Todos os santos vos saúdam.
14 Make di grace wey awa Oga God Jesus Christ give us and di love wey God get for us, plus di Holy Spirit fellowship, dey with una.
14 A graça do Senhor Jesus Cristo, o amor de Deus e a comunhão do Espírito Santo estejam com todos vós!
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.