2 Coríntios 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 E good to dey boast, even doh gain nor dey inside. I go still dey tok about di vishon and revelashon wey Jesus Christ show mi.
1 É necessário gloriar-me, embora não convenha; mas passarei a visões e revelações do Senhor.
2 Fourteen years ago, I know one man wey bi Christ savant. Weda na for vishon or Fisical, I nor know, but God know. God karry am go di heaven wey high pass.
2 Conheço um homem em Cristo que há catorze anos {se no corpo não sei, se fora do corpo não sei; Deus o sabe} foi arrebatado até o terceiro céu.
3 And I know dis man (but na only God know weda e dey for en body or for spirit).
3 Sim, conheço o tal homem {se no corpo, se fora do corpo, não sei: Deus o sabe},
4 God karry am go paradise and e hear tins wey dey too holy to tok; tins wey God nor give human being pawa to tok.
4 que foi arrebatado ao paraíso, e ouviu palavras inefáveis, as quais não é lícito ao homem referir.
5 Na dat pesin make mi dey boast and I nor go boast about mysef, escept di tins wey show sey, I nor dey strong.
5 Desse tal me gloriarei, mas de mim mesmo não me gloriarei, senão nas minhas fraquezas.
6 Even if I won boast, I nor go bi fool, bikos na trut I go still tok, but I nor do am make anybody for tink sey na mi know pass, bikos e si and hear mi dey tok
6 Pois, se quiser gloriar-me, não serei insensato, porque direi a verdade;
7 about di betta tins wey I si for vishon. Make I for nor dey karry body up, God put sometin inside mi, wey bi Satan messenja, so dat e go dey trobol mi.
7 E, para que me não exaltasse demais pela excelência das revelações, foi-me dado um espinho na carne, a saber, um mensageiro de Satanás para me esbofetear, a fim de que eu não me exalte demais;
8 Na three times I ask Christ sey, make e take dis tin komot from my body.
8 acerca do qual três vezes roguei ao Senhor que o afastasse de mim;
9 But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body.
9 e ele me disse: A minha graça te basta, porque o meu poder se aperfeiçoa na fraqueza. Por isso, de boa vontade antes me gloriarei nas minhas fraquezas, a fim de que repouse sobre mim o poder de Cristo.
10 I dey happy as I dey weak with all di curse, trobols, ponishment and wahala wey I dey sofa bikos of Christ, bikos anytime wey I dey weak, na dat time, I dey-dey strong.
10 Pelo que sinto prazer nas fraquezas, nas injúrias, nas necessidades, nas perseguições, nas angústias por amor de Cristo. Porque quando estou fraco, então é que sou forte.
11 I don turn to fool! Na una force mi, bikos una suppose to praiz mi. Even if I nor bi anytin, e nor get anytin wey doz una “supper apostles” take betta pass mi.
11 Tornei-me insensato; vós a isso me obrigastes; porque eu devia ser louvado por vós, visto que em nada fui inferior aos demais excelentes apóstolos, ainda que nada sou.
12 True-true for una present, wi do mirakles and wonders to show sey wi bi apostles too.
12 Os sinais do meu apostolado foram, de fato, operados entre vós com toda a paciência, por sinais, prodígios e milagres.
13 Bikos di way wey dem trit us worse pass di oda church, escept sey I nor dey put my load for una head. Make una forgive mi for dis tins wey I do!
13 Pois, em que fostes feitos inferiores às outras igrejas, a não ser nisto, que eu mesmo vos não fui pesado? Perdoai-me esta injustiça.
14 Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food.
14 Eis que pela terceira vez estou pronto a ir ter convosco, e não vos serei pesado, porque não busco o que é vosso, mas sim a vós; pois não são os filhos que devem entesourar para os pais, mas os pais para os filhos.
15 I go dey happy to spend all my money and even my life, as long as una soul go dey save. Una love for mi dey small, bikos my love for una plenty?
15 Eu de muito boa vontade gastarei, e me deixarei gastar pelas vossas almas. Se mais abundantemente vos amo, serei menos amado?
16 Even if e bi like dat, I nor put my load for una head. But dem sey, bikos I bi wayo pesin, I dey deceive una!
16 Mas seja assim; eu não vos fui pesado; mas, sendo astuto, vos tomei com dolo.
17 I nor play anybody wayo thru di pesin wen I send kom meet una, abi I dey lie?
17 Porventura vos explorei por algum daqueles que vos enviei?
18 Abeg Titus make e visit una and I send dat broda make e follow am kom. Dem play una wayo? Nor bi di same mind wi awasef take follow una? Abi nor bi di same way wi dey bihave?
18 Exortei a Tito, e enviei com ele o irmão. Porventura Tito vos explorou? Não andamos porventura no mesmo espírito? Não seguimos as mesmas pegadas?
19 May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong.
19 Há muito, de certo, pensais que nos estamos desculpando convosco. Perante Deus, falamos em Cristo, e tudo isto, amados, é para vossa edificação.
20 Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
20 Porque temo que, quando chegar, não vos ache quais eu vos quero, e que eu seja achado por vós qual não me quereis; que de algum modo haja contendas, invejas, iras, porfias, detrações, mexericos, orgulhos, tumultos;
21 I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.
21 e que, quando for outra vez, o meu Deus me humilhe perante vós, e chore eu sobre muitos daqueles que dantes pecaram, e ainda não se arrependeram da impureza, prostituição e lascívia que cometeram.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.