2 Coríntios 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 For wetin I won tok naw, make una bear with mi like sey I nor get sense!
1 Quisera eu me suportásseis um pouco mais na minha loucura. Suportai-me, pois.
2 I dey jealous for una with God jealousy, bikos I promise sey na one man una go marry. Like woman wey nor no man, na so I won give una to Christ.
2 Porque zelo por vós com zelo de Deus; visto que vos tenho preparado para vos apresentar como virgem pura a um só esposo, que é Cristo.
3 But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.
3 Mas receio que, assim como a serpente enganou a Eva com a sua astúcia, assim também seja corrompida a vossa mente e se aparte da simplicidade e pureza devidas a Cristo.
4 So, if anybody kon prish anoda Christ wey wi nor prish for una and una receive anoda spirit wey una nor receive before, or anoda gospel wey una neva hear before, dat mean sey, una don asept dem well.
4 Se, na verdade, vindo alguém, prega outro Jesus que não temos pregado, ou se aceitais espírito diferente que não tendes recebido, ou evangelho diferente que não tendes abraçado, a esse, de boa mente, o tolerais.
5 I nor tink sey doz “supper apostle” betta pass mi.
5 Porque suponho em nada ter sido inferior a esses tais apóstolos.
6 But even doh I nor know how to tok, I know book. True-true, wi don let una know dis tins wey happen.
6 E, embora seja falto no falar, não o sou no conhecimento; mas, em tudo e por todos os modos, vos temos feito conhecer isto.
7 As I honbol mysef dey do di work, na sin I kommit? I dey do am, so dat una go fit grow up and wen I prish give una, I nor kollect money.
7 Cometi eu, porventura, algum pecado pelo fato de viver humildemente, para que fôsseis vós exaltados, visto que gratuitamente vos anunciei o evangelho de Deus?
8 I shit di oda church dem, bikos I dey kollect money from dem, so dat I go dey work with una for free!
8 Despojei outras igrejas, recebendo salário, para vos poder servir,
9 Wen I nid anytin for di time wen I dey with una, I nor put my load for anybody head, bikos awa brodas wey Masidonia dey give mi evritin wey I nid. I nor allow mysef to bi problem for anybody and I nor go ever do am.
9 e, estando entre vós, ao passar privações, não me fiz pesado a ninguém; pois os irmãos, quando vieram da Macedônia, supriram o que me faltava; e, em tudo, me guardei e me guardarei de vos ser pesado.
10 True-true, as Christ trut dey inside mi, nobody go fit stop mi for di way I dey boast for Akaia.
10 A verdade de Cristo está em mim; por isso, não me será tirada esta glória nas regiões da Acaia.
11 Why? Na bikos I nor love una? No! God know sey I love una!
11 Por que razão? É porque não vos amo? Deus o sabe.
12 And I go kontinue to do wetin I dey do, so dat doz apostles nor go get rizin to boast sey, dem dey do di same work with us.
12 Mas o que faço e farei é para cortar ocasião àqueles que a buscam com o intuito de serem considerados iguais a nós, naquilo em que se gloriam.
13 Bikos dem bi fake apostles; pipol wey dey lie and pritend like sey dem bi Jesus Christ apostles.
13 Porque os tais são falsos apóstolos, obreiros fraudulentos, transformando-se em apóstolos de Cristo.
14 E nor sopraiz us, bikos even Satan dey pritend sey en na angel wey get lite.
14 E não é de admirar, porque o próprio Satanás se transforma em anjo de luz.
15 So e nor sopraiz us sey, en savants dey pritend too like sey dem bi savant wey dey do wetin good for God eye. For di end, dem go gain wetin fit di tins wey dem dey do.
15 Não é muito, pois, que os seus próprios ministros se transformem em ministros de justiça; e o fim deles será conforme as suas obras.
16 I dey tell una again, make anybody nor tink sey I bi fool. But if una tink so, den make una asept mi as fool, so dat misef go boast small.
16 Outra vez digo: ninguém me considere insensato; todavia, se o pensais, recebei-me como insensato, para que também me glorie um pouco.
17 Wetin I dey boast about so, nor bi as Christ wont make I boast, instead, I dey tok like fool.
17 O que falo, não o falo segundo o Senhor, e sim como por loucura, nesta confiança de gloriar-me.
18 Since some pipol dey boast like dis world pipol, make mi mysef still boast.
18 E, posto que muitos se gloriam segundo a carne, também eu me gloriarei.
19 Una sey una get sense well-well, yet una dey use happiness asept wetin fool dey tok.
19 Porque, sendo vós sensatos, de boa mente tolerais os insensatos.
20 Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.
20 Tolerais quem vos escravize, quem vos devore, quem vos detenha, quem se exalte, quem vos esbofeteie no rosto.
21 (Na shame for mi, but I must tell una sey awa heart nor strong rish to do una doz kind tins!) But anytin wey anybody fit boast about (I dey tok like fool naw o-o), misef fit boast about dat tin too.
21 Ingloriamente o confesso, como se fôramos fracos. Mas, naquilo em que qualquer tem ousadia (com insensatez o afirmo), também eu a tenho.
22 Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too.
22 São hebreus? Também eu. São israelitas? Também eu. São da descendência de Abraão? Também eu.
23 Na Christ savants bi? (I don dey tok like sey I dey kraze again!) Misef na Christ savant wey betta pass dem! I don work hard pass dem, I don dey prison plenty times pass dem, dem don beat mi well-well pass dem, I don nearly die plenty times.
23 São ministros de Cristo? (Falo como fora de mim.) Eu ainda mais: em trabalhos, muito mais; muito mais em prisões; em açoites, sem medida; em perigos de morte, muitas vezes.
24 Na five times Jew pipol don flog mi thirty-nine times.
24 Cinco vezes recebi dos judeus uma quarentena de açoites menos um;
25 Rome pipol don beat mi three times. Dem stone mi wons until I nearly die. Sheep wey I dey inside, don spoil for wota three times. I don float wons for wota from morning go rish di next day.
25 fui três vezes fustigado com varas; uma vez, apedrejado; em naufrágio, três vezes; uma noite e um dia passei na voragem do mar;
26 I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas.
26 em jornadas, muitas vezes; em perigos de rios, em perigos de salteadores, em perigos entre patrícios, em perigos entre gentios, em perigos na cidade, em perigos no deserto, em perigos no mar, em perigos entre falsos irmãos;
27 I don do hard work; nor sleep for many nites; food and wota go dey hongry mi; many times, I nor get food to chop. I don dey for kold and I nor get klot to kover body.
27 em trabalhos e fadigas, em vigílias, muitas vezes; em fome e sede, em jejuns, muitas vezes; em frio e nudez.
28 Apart from dis tins, my mind dey heavy mi evriday as I dey tink of how I go take help all di pipol wey dey God church.
28 Além das coisas exteriores, há o que pesa sobre mim diariamente, a preocupação com todas as igrejas.
29 If pesin dey weak, misef dey weak too. If dem deceive pesin enter sin, e dey pain mi well-well.
29 Quem enfraquece, que também eu não enfraqueça? Quem se escandaliza, que eu não me inflame?
30 If I go must boast, den I go boast about di tins wey show sey I dey weak.
30 Se tenho de gloriar-me, gloriar-me-ei no que diz respeito à minha fraqueza.
31 God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, wey dem go praiz forever, know sey nor bi lie I dey tok.
31 O Deus e Pai do Senhor Jesus, que é eternamente bendito, sabe que não minto.
32 For Damaskus, King Aretas sey make di govnor put sojas for di town gate, so dat dem go arrest mi.
32 Em Damasco, o governador preposto do rei Aretas montou guarda na cidade dos damascenos, para me prender;
33 But awa pipol for der kon put mi for basket wey dem tie rope put kon drop mi small-small from di window and na so I take eskape from di man hand.
33 mas, num grande cesto, me desceram por uma janela da muralha abaixo, e assim me livrei das suas mãos.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Coríntios 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.