1 Tessalonicenses 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Finally, my brodas and sistas, wi dey ask and beg una bikos of Christ sey, as una don hear from us about how una suppose live as God wont (as una dey do naw), make una kontinue to dey live like dat.
1 Finalmente, irmãos, vos rogamos e exortamos no Senhor Jesus que, assim como recebestes de nós, de que maneira convém andar e agradar a Deus, assim andai, para que continueis a progredir cada vez mais;
2 Una know di kommand wey wi give una thru Christ.
2 porque vós bem sabeis que mandamentos vos temos dado pelo Senhor Jesus.
3 Na wetin God wont bi dis: Make una dey holy; komot hand for bad tins; nor sleep with who nor bi yor wife or husband.
3 Porque esta é a vontade de Deus, a vossa santificação: que vos abstenhais da prostituição,
4 Una wey bi man, make una dey live with una wife for holiness and with respet,
4 que cada um de vós saiba possuir o seu vaso em santificação e honra,
5 nor bi to dey follow who yu nor marry, just as Gentile pipol wey nor know God dey do.
5 não na paixão de concupiscência, como os gentios, que não conhecem a Deus.
6 Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.
6 Ninguém oprima ou engane a seu irmão em negócio algum, porque o Senhor é vingador de todas estas coisas, como também, antes, vo-lo dissemos e testificamos.
7 Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.
7 Porque não nos chamou Deus para a imundícia, mas para a santificação.
8 So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.
8 Portanto, quem despreza isto não despreza ao homem, mas, sim, a Deus, que nos deu também o seu Espírito Santo.
9 No nid to rite give una about love for una fellow Christians, bikos God ensef don tish una about how una suppose love each oda.
9 Quanto, porém, ao amor fraternal, não necessitais de que vos escreva, visto que vós mesmos estais instruídos por Deus que vos ameis uns aos outros;
10 And una really dey show love to di Christian brodas and sistas for Masidonia. My brodas and sistas, wi dey beg una sey, make una kontinue to dey do like dat.
10 porque também já assim o fazeis para com todos os irmãos que estão por toda a Macedônia. Exortamo-vos, porém, a que ainda nisto continueis a progredir cada vez mais,
11 Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.
11 e procureis viver quietos, e tratar dos vossos próprios negócios, e trabalhar com vossas próprias mãos, como já vo-lo temos mandado;
12 Like dis, doz sinnas go dey respet una and una go get evritin wey una nid.
12 para que andeis honestamente para com os que estão de fora e não necessiteis de coisa alguma.
13 Awa brodas and sistas, wi wont make una know di trut about doz pipol wey don die, so dat una nor go dey sad like pipol wey nor get hope.
13 Não quero, porém, irmãos, que sejais ignorantes acerca dos que já dormem, para que não vos entristeçais, como os demais, que não têm esperança.
14 Since wi bilive sey Jesus die and e wake-up; na so too wi bilive sey, doz wey bi Christian before dem die, God go raiz dem up.
14 Porque, se cremos que Jesus morreu e ressuscitou, assim também aos que em Jesus dormem Deus os tornará a trazer com ele.
15 Bikos wetin wi dey tish una naw, na wetin Christ tish sey: Wi wey dey alive wen Jesus go kom, nor go follow am go kon leave doz wey don die bikos, all of us go-go with am.
15 Dizemo-vos, pois, isto pela palavra do Senhor: que nós, os que ficarmos vivos para a vinda do Senhor, não precederemos os que dormem.
16 God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.
16 Porque o mesmo Senhor descerá do céu com alarido, e com voz de arcanjo, e com a trombeta de Deus; e os que morreram em Cristo ressuscitarão primeiro;
17 God go karry wi wey remain for dis world go meet dem for sky, den all of us go-go meet Christ for heaven.
17 depois, nós, os que ficarmos vivos, seremos arrebatados juntamente com eles nas nuvens, a encontrar o Senhor nos ares, e assim estaremos sempre com o Senhor.
18 So make una dey enkourage each oda with all dis word.
18 Portanto, consolai-vos uns aos outros com estas palavras.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Tessalonicenses 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.