1 Tessalonicenses 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen wi nor fit bear-am again, wi kon sey wi go stay for Atens by awasef.
1 Por isso, quando não pudemos mais suportar, achamos por bem permanecer sozinhos em Atenas
2 So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,
2 e, assim, enviamos Timóteo, nosso irmão e cooperador de Deus no evangelho de Cristo, para fortalecê-los e dar-lhes ânimo na fé,
3 so dat nobody among una go dey fear, bikos of all dis sofa. Unasef know sey all wetin dey happen, na as God plan am.
3 para que ninguém seja abalado por essas tribulações. Vocês sabem muito bem que fomos designados para isso.
4 Wen wi dey with una, wi dey tell una before di time rish sey, wi go sofa well-well and e don dey happen as una dey si am.
4 Quando estávamos com vocês, já lhes dizíamos que seríamos perseguidos, o que realmente aconteceu, como vocês sabem.
5 So wen I nor fit bear again, I send pesin make e help mi shek how una faith bi, bikos I dey fear sey devil wey dey tempt pipol, don tempt una and all di work wey wi do among una, don dey yuzles.
5 Por essa razão, não suportando mais, enviei Timóteo para saber a respeito da fé que vocês têm, a fim de que o tentador não os seduzisse, tornando inútil o nosso esforço.
6 But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.
6 Agora, porém, Timóteo acaba de chegar da parte de vocês, dando-nos boas notícias a respeito da fé e do amor que vocês têm. Ele nos falou que vocês sempre guardam boas recordações de nós, desejando ver-nos, assim como nós queremos vê-los.
7 So, awa brodas and sistas, for all awa trobol and sofa, awa heart dey strong about una, bikos of una faith.
7 Por isso, irmãos, em toda a nossa necessidade e tribulação temos bom ânimo a seu respeito, por sabermos da sua fé;
8 Naw, wi dey alive again, bikos una stand well for Christ
8 pois agora vivemos, visto que vocês estão firmes no Senhor.
9 and wi dey tank God for una. Wi dey tank am for di joy wey wi get for en present bikos of una.
9 Como podemos ser suficientemente gratos a Deus por vocês, por toda a alegria que temos diante dele por causa de vocês?
10 Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.
10 Noite e dia com perseverança oramos para que possamos vê-los pessoalmente e suprir o que falta à sua fé.
11 Make God awa papa and Oga God Jesus prepare road for us, so dat wi go si una again.
11 Que o próprio Deus, nosso Pai, e nosso Senhor Jesus preparem o nosso caminho até vocês.
12 Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,
12 Que o Senhor faça crescer e transbordar o amor que vocês têm uns para com os outros e para com todos, a exemplo do nosso amor por vocês.
13 so dat una heart go dey strong for holiness. And for di time wey Christ go kom with en pipol, una go dey without fault for God present.
13 Que ele fortaleça os seus corações para serem irrepreensíveis em santidade diante de nosso Deus e Pai, na vinda de nosso Senhor Jesus com todos os seus santos.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Tessalonicenses 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.