1 Tessalonicenses 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Awa brodas and sistas, una know sey awa visit nor dey yuzles.
1 Irmãos, vocês mesmos sabem que a visita que lhes fizemos não foi inútil.
2 Before wi kom meet una for Tesalonika, dem sofa and trit us anyhow for Filippi and many pipol nor wont make wi tok, but awa God give us pawa to prish en Good News.
2 Apesar de termos sido maltratados e insultados em Filipos, como vocês sabem, com a ajuda de nosso Deus tivemos coragem de anunciar-lhes o evangelho de Deus, em meio a muita luta.
3 Bikos wetin wi dey prish nor bi with mistake, dirty mind or wayo,
3 Pois nossa exortação não tem origem no erro nem em motivos impuros, nem temos intenção de enganá-los;
4 but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef.
4 pelo contrário, como homens aprovados por Deus, a ponto de nos ter sido confiado por ele o evangelho, não falamos para agradar a pessoas, mas a Deus, que prova os nossos corações.
5 As una know, wi nor ever try to win una with sweet words.
5 Vocês bem sabem a nossa linguagem nunca foi de bajulação nem de pretexto para ganância; Deus é testemunha.
6 Wi nor ever sey make pipol praiz us; weda na una or odas.
6 Nem buscamos reconhecimento humano, quer de vocês quer de outros.
7 Wen wi dey with una, wi dey gentol like as mama dey kare for en pikin, even doh wi for fit kollect money from una since wi bi Christ apostles.
7 Embora, como apóstolos de Cristo, pudéssemos ter sido um peso, tornamo-nos bondosos entre vocês, como uma mãe que cuida dos próprios filhos.
8 Bikos wi love una, wi dey happy as wi dey share God word and awa own life with una.
8 Sentindo, assim, tanta afeição por vocês, decidimos dar-lhes não somente o evangelho de Deus, mas também a nossa própria vida, porque vocês se tornaram muito amados por nós.
9 But awa brodas and sistas, wi hope sey una remember as wi dey work for both day and nite, so dat as wi dey prish di gospel, wi nor go bi problem to una.
9 Irmãos, certamente vocês se lembram do nosso trabalho esgotante e da nossa fadiga; trabalhamos noite e dia para não sermos pesados a ninguém, enquanto lhes pregávamos o evangelho de Deus.
10 As wi dey live with una wey bilive Christ, una and God na awa witness sey, wi dey holy and dey do good tins for God eye without fault.
10 Tanto vocês como Deus são testemunhas de como nos portamos de maneira santa, justa e irrepreensível entre vocês, os que crêem.
11 As unasef know, wi dey trit una as papa dey trit en shidren.
11 Pois vocês sabem que tratamos cada um como um pai trata seus filhos,
12 Wi dey advise, beg and tok to una sey, una must live una life as God wont, bikos na-im koll una enter en own kingdom and glory.
12 exortando, consolando e dando testemunho, para que vocês vivam de maneira digna de Deus, que os chamou para o seu Reino e glória.
13 Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.
13 Também agradecemos a Deus sem cessar, pois, ao receberem de nossa parte a palavra de Deus, vocês a aceitaram não como palavra de homens, mas segundo verdadeiramente é, como palavra de Deus, que atua com eficácia em vocês, os que crêem.
14 My brodas and sistas, na di same tin happen to God church for Judea and una wey bilive Christ for der don still sofa pain from una kountry-men wey bi Jew pipol.
14 Porque vocês, irmãos, tornaram-se imitadores das igrejas de Deus em Cristo Jesus que estão na Judéia. Vocês sofreram da parte dos seus próprios conterrâneos as mesmas coisas que aquelas igrejas sofreram da parte dos judeus,
15 Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.
15 que mataram o Senhor Jesus e os profetas, e também nos perseguiram. Eles desagradam a Deus e são hostis a todos,
16 Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.
16 esforçando-se para nos impedir que falemos aos gentios, e estes sejam salvos. Dessa forma, vão sempre completando a medida dos seus pecados. Sobre eles, finalmente, veio a ira.
17 My brodas and sistas, afta wi leave una (even doh wi still dey tink about una), wi kon dey try to make sure sey wi si una again bikos of di love wey wi get for una.
17 Nós, porém, irmãos, privados da companhia de vocês por breve tempo, em pessoa, mas não no coração, esforçamo-nos ainda mais para vê-los pessoalmente, pela saudade que temos de vocês.
18 Wi bin won kom si una (mi wey bi Paul don try to kom many times), but Satan spoil awa plan.
18 Quisemos visitá-los. Eu mesmo, Paulo o quis, e não apenas uma vez, mas duas; Satanás, porém, nos impediu.
19 Nor bi una bi awa hope, joy and crown wey wi go take boast give Jesus wen E kom? Yes! Na una!
19 Pois quem é a nossa esperança, alegria ou coroa em que nos gloriamos perante o Senhor Jesus na sua vinda? Não são vocês?
20 Bikos na una bi awa joy and glory!
20 De fato, vocês são a nossa glória e a nossa alegria.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Tessalonicenses 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.