1 Timóteo 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Una wey bi savants, make una dey respet una masta, so dat nobody go tok bad about God and wetin wi dey tish.
1 Todos os servos que estão debaixo do jugo considerem seus senhores dignos de toda honra, para que o nome de Deus e a doutrina não sejam blasfemados.
2 Make una nor disobey una masta, bikos dem bi bilivers. But make una serve and love dem well, bikos di mastas wey una dey serve, na Christian dem bi.
2 E os que têm senhores crentes não os desprezem, porque são irmãos; antes os sirvam melhor, porque eles, que se utilizam do seu bom serviço, são crentes e amados. Ensina estas coisas.
3 If anybody dey tish wetin nor korrect and nor gri with awa Oga God Jesus Christ tishing and as God wont make wi dey live awa life,
3 Se alguém ensina alguma doutrina diversa, e não se conforma com as sãs palavras de nosso Senhor Jesus Cristo, e com a doutrina que é segundo a piedade,
4 dat pesin dey proud and na only to dey argue and kworel, e know. Dis kind tin nor good, bikos jealousy; kworel; lie-lie; to dey suspet odas anyhow
4 é soberbo, e nada sabe, mas delira acerca de questões e contendas de palavras, das quais nascem invejas, porfias, injúrias, suspeitas maliciosas,
5 and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.
5 disputas de homens corruptos de entendimento, e privados da verdade, cuidando que a piedade é fonte de lucro;
6 To live as God wont and dey happy with wetin E give yu, dey bring betta reward.
6 e, de fato, é grande fonte de lucro a piedade com o contentamento.
7 Bikos wi nor bring anytin kom dis world and true-true, wi nor go take one singol tin komot from dis world afta wi don die.
7 Porque nada trouxe para este mundo, e nada podemos daqui levar;
8 But if wi get food to chop and klot to wear, make dem rish us.
8 tendo, porém, alimento e vestuário, estaremos com isso contentes.
9 Pipol wey won get money by force, dey fall enter temptashon and dem dey get troat for yeye tins wey go distroy and put dem for wahala.
9 Mas os que querem tornar-se ricos caem em tentação e em laço, e em muitas concupiscências loucas e nocivas, as quais submergem os homens na ruína e na perdição.
10 Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.
10 Porque o amor ao dinheiro é raiz de todos os males; e nessa cobiça alguns se desviaram da fé, e se traspassaram a si mesmos com muitas dores.
11 But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
11 Mas tu, ó homem de Deus, foge destas coisas, e segue a justiça, a piedade, a fé, o amor, a constância, a mansidão.
12 Make yu fight di fight wey dey make faith strong and whole di life wey nor dey end, wey go make pipol praiz God, bikos na dis make am koll yu.
12 Peleja a boa peleja da fé, apodera-te da vida eterna, para a qual foste chamado, tendo já feito boa confissão diante de muitas testemunhas.
13 Before God wey dey give life to all tins and Jesus Christ wey tok well for Pontius Pilate front, I dey tell yu from my heart sey,
13 Diante de Deus, que todas as coisas vivifica, e de Cristo Jesus, que perante Pôncio Pilatos deu o testemunho da boa confissão, exorto-te
14 make yu obey dia kommand without fault or blame, until awa Oga God Jesus Christ go kom.
14 a que guardes este mandamento sem mácula e irrepreensível até a vinda de nosso Senhor Jesus Cristo;
15 Bikos wen di time don rish, Christ go kom from heaven with God mighty pawa: Na God bi di King for all kings and Oga God of all oga.
15 a qual, no tempo próprio, manifestará o bem-aventurado e único soberano, Rei dos reis e Senhor dos senhores;
16 Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!
16 aquele que possui, ele só, a imortalidade, e habita em luz inacessível; a quem nenhum dos homens tem visto nem pode ver; ao qual seja honra e poder sempiterno. Amém.
17 Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.
17 manda aos ricos deste mundo que não sejam altivos, nem ponham a sua esperança na incerteza das riquezas, mas em Deus, que nos concede abundantemente todas as coisas para delas gozarmos;
18 Tell dem sey, make dem use dia money take do good. Make dem dey do plenty good works kon dey give doz wey nor get and make dem always dey ready to share with odas.
18 que pratiquem o bem, que se enriqueçam de boas obras, que sejam liberais e generosos,
19 If dem dey do like dis, dem go dey use dia money and propaty take lay good foundashon for dia future, so dat dem go get life wey nor dey end.
19 entesourando para si mesmos um bom fundamento para o futuro, para que possam alcançar a verdadeira vida.
20 Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know.
20 Ó Timóteo, guarda o depósito que te foi confiado, evitando as conversas vãs e profanas e as oposições da falsamente chamada ciência;
21 Some pipol don fall komot from di faith, bikos dem dey listin to pipol wey dey do doz bad tins.
21 a qual professando-a alguns, se desviaram da fé. A graça seja convosco.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Timóteo 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.