1 Timóteo 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Make yu nor tok anyhow to pesin wey old pass yu, but dey tok to am with respet like sey yu dey tok to yor papa. Tok to yong men as yu go take tok to yor broda.
1 NÃO repreendas asperamente o ancião, mas admoesta-o como a pai; aos moços como a irmãos;
2 Make yu trit wimen wey old pass yu like sey dem bi yor mama and wimen wey yu senior, make yu trit dem with good mind like sey dem bi yor sistas.
2 As mulheres idosas, como a mães, às moças, como a irmãs, em toda a pureza.
3 Respet and kare for wimen wey dia husband don die.
3 Honra as viúvas que verdadeiramente são viúvas.
4 But if di woman get shidren or grand-shidren, di first tin wey dem go do for dia family, na to show sey dem dey fear God, as dem dey kare for dia papa and mama. Dis na wetin dey make belle sweet God.
4 Mas, se alguma viúva tiver filhos, ou netos, aprendam primeiro a exercer piedade para com a sua própria família, e a recompensar seus pais; porque isto é bom e agradável diante de Deus.
5 Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am.
5 Ora, a que é verdadeiramente viúva e desamparada espera em Deus, e persevera de noite e de dia em rogos e orações;
6 But if e just dey enjoy ensef anyhow for dis world, dat mean sey en spirit don die, even doh e still dey alive.
6 Mas a que vive em deleites, vivendo está morta.
7 Make yu always dey give dis kommand so dat dem nor go get fault.
7 Manda, pois, estas coisas, para que elas sejam irrepreensíveis.
8 But if anybody nor fit kare for en pipol, especially en family membas, e don deny di faith bi dat and e worse pass sina.
8 Mas, se alguém não tem cuidado dos seus, e principalmente dos da sua família, negou a fé, e é pior do que o infiel.
9 Woman wey don pass sixty years and e dey faithful to en husband bi for di man die, make una put am join doz wey di church dey help.
9 Nunca seja inscrita viúva com menos de sessenta anos, e só a que tenha sido mulher de um só marido;
10 Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.
10 Tendo testemunho de boas obras: Se criou os filhos, se exercitou hospitalidade, se lavou os pés aos santos, se socorreu os aflitos, se praticou toda a boa obra.
11 But yong woman wey en husband just die, make una nor put am join doz wey di church dey help, bikos wen dem dey hongry to marry again, dem go fit leave Christ kon bigin sin.
11 Mas não admitas as viúvas mais novas, porque, quando se tornam levianas contra Cristo, querem casar-se;
12 So God go judge dem, bikos dem don break dia promise.
12 Tendo já a sua condenação por haverem aniquilado a primeira fé.
13 For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.
13 E, além disto, aprendem também a andar ociosas de casa em casa; e não só ociosas, mas também paroleiras e curiosas, falando o que não convém.
14 So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem.
14 Quero, pois, que as que são moças se casem, gerem filhos, governem a casa, e não dêem ocasião ao adversário de maldizer;
15 Bikos some pipol don already dey follow Satan.
15 Porque já algumas se desviaram, indo após Satanás.
16 If anybody wey bilive get rilashons wey en husband don die, make e help dem. Make e nor worry di church about dem, so dat dem go fit help di oda wimen wey dia husband don die.
16 Se algum crente ou alguma crente tem viúvas, socorra-as, e não se sobrecarregue a igreja, para que se possam sustentar as que deveras são viúvas.
17 Doz wey dey lead well, make dem pay dem well, especially doz wey dey work and tish well-well, so dat di gospel go stand.
17 Os presbíteros que governam bem sejam estimados por dignos de duplicada honra, principalmente os que trabalham na palavra e na doutrina;
18 Bikos God word sey, “Animal wey dey harvest korn, make una nor tie en mout.” Anybody wey dey work, suppose get en pay.
18 Porque diz a Escritura: Não ligarás a boca ao boi que debulha. E: Digno é o obreiro do seu salário.
19 Make yu nor asept any words wey dem tok against any leader, unless two or three pipol bear witness sey na true.
19 Não aceites acusação contra o presbítero, senão com duas ou três testemunhas.
20 Doz wey dey sin, make yu korrect dem for evribody front, so dat e go bi warnin to odas.
20 Aos que pecarem, repreende-os na presença de todos, para que também os outros tenham temor.
21 For God, Jesus Christ and di angels wey dey with us, I dey enkourage yu make yu obey all di kommand without wayo.
21 Conjuro-te diante de Deus, e do Senhor Jesus Cristo, e dos anjos eleitos, que sem prevenção guardes estas coisas, nada fazendo por parcialidade.
22 Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.
22 A ninguém imponhas precipitadamente as mãos, nem participes dos pecados alheios; conserva-te a ti mesmo puro.
23 Nor dey drink only wota, but make yu still drink small wine bikos of yor belle wey dey make yu sick anyhow.
23 Não bebas mais água só, mas usa de um pouco de vinho, por causa do teu estômago e das tuas freqüentes enfermidades.
24 Remember sey some pipol dey sin make evribody si am and dis dey judge dem. But e get some wey yu nor go know dia sins naw, but leta, e go kom out for publik.
24 Os pecados de alguns homens são manifestos, precedendo o juízo; e em alguns manifestam-se depois.
25 Like dis too, pipol dey si di good work wey odas dey do and one day, di good work wey dem do for sekret, go kom out for publik.
25 Assim mesmo também as boas obras são manifestas, e as que são de outra maneira não podem ocultar-se.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Timóteo 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.