1 Timóteo 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Di Spirit tok sey for di last days, some pipol go leave di faith kon dey bilive lie-lie spirits and follow wetin demons dey tish.
1 Mas o Espírito expressamente diz que nos últimos tempos apostatarão alguns da fé, dando ouvidos a espíritos enganadores, e a doutrinas de demônios;
2 Dis pipol dey lie and na wayo dem sabi do and dia mind don skata.
2 Pela hipocrisia de homens que falam mentiras, tendo cauterizada a sua própria consciência;
3 Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am.
3 Proibindo o casamento, e ordenando a abstinência dos alimentos que Deus criou para os fiéis, e para os que conhecem a verdade, a fim de usarem deles com ações de graças;
4 Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am,
4 Porque toda a criatura de Deus é boa, e não há nada que rejeitar, sendo recebido com ações de graças.
5 bikos God word and prayer don make am klean.
5 Porque pela palavra de Deus e pela oração é santificada.
6 If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.
6 Propondo estas coisas aos irmãos, serás bom ministro de Jesus Cristo, criado com as palavras da fé e da boa doutrina que tens seguido.
7 But make una rijet lie-lie and yeye story. Instead make una dey train unasef with betta words from God.
7 Mas rejeita as fábulas profanas e de velhas, e exercita-te a ti mesmo em piedade;
8 Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.
8 Porque o exercício corporal para pouco aproveita, mas a piedade para tudo é proveitosa, tendo a promessa da vida presente e da que há de vir.
9 Dis na true word and e good make evribody asept am with betta mind.
9 Esta palavra é fiel e digna de toda a aceitação;
10 Na dis make wi dey work hard and dey struggol, bikos awa hope dey with God wey dey alive and E dey save evribody, especially doz wey bilive am.
10 Porque para isto trabalhamos e somos injuriados, pois esperamos no Deus vivo, que é o Salvador de todos os homens, principalmente dos fiéis.
11 Make yu tish di pipol dis tins and make sure sey, dem do dem.
11 Manda estas coisas e ensina-as.
12 Nor let anybody opress yu bikos of yor age; but make yu show ezample to doz wey bilive thru yor word, karata, love, faith and as yu pure rish.
12 Ninguém despreze a tua mocidade; mas sê o exemplo dos fiéis, na palavra, no trato, no amor, no espírito, na fé, na pureza.
13 Until I kom back, make yu dey read God Word for church, dey enkourage di bilivers and tish dem.
13 Persiste em ler, exortar e ensinar, até que eu vá.
14 Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.
14 Não desprezes o dom que há em ti, o qual te foi dado por profecia, com a imposição das mãos do presbitério.
15 Make yu dey learn dis tins; dey do am with all yor mind, so dat pipol go si as yu dey progress.
15 Medita estas coisas; ocupa-te nelas, para que o teu aproveitamento seja manifesto a todos.
16 Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.
16 Tem cuidado de ti mesmo e da doutrina. Persevera nestas coisas; porque, fazendo isto, te salvarás, tanto a ti mesmo como aos que te ouvem.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Timóteo 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.