1 Timóteo 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Paul wey bi Jesus Christ apostle thru God awa Savior kommand, na-im rite dis leta and na Jesus Christ bi di hope wey wi get:
1 Paulo, apóstolo de Cristo Jesus, por ordem de Deus, nosso Salvador, e de Cristo Jesus, nossa esperança,
2 To Timoti, my own pikin for di faith. Make favor, mesi and peace wey dey kom from God awa papa and Jesus Christ awa Oga God, dey with yu.
2 a Timóteo, verdadeiro filho na fé. Que a graça, a misericórdia e a paz, da parte de Deus Pai e de Cristo Jesus, nosso Senhor, estejam com você.
3 As I tell yu wen I dey go Masidonia, make yu korrect doz pipol for Efesus wey nor dey tish di trut
3 Quando eu estava de viagem, rumo à Macedônia, pedi a você que ainda permanecesse em Éfeso para admoestar certas pessoas, a fim de que não ensinem outra doutrina,
4 but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.
4 nem se ocupem com fábulas e genealogias sem fim. Essas coisas mais promovem discussões do que o serviço de Deus, na fé.
5 But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
5 O objetivo desta admoestação é o amor que procede de um coração puro, de uma boa consciência e de uma fé sem hipocrisia.
6 Some disobey dis kommand kon dey tok tins wey nor dey good.
6 Algumas pessoas se desviaram destas coisas e se perderam em discussões inúteis,
7 Dem won tish pipol di law, but dem nor undastand wetin dem dey tok, even doh dem dey tok with strong heart.
7 pretendendo passar por mestres da lei, não compreendendo, porém, nem o que dizem, nem os assuntos sobre os quais falam com tanta ousadia.
8 But wi know sey di law dey good wen pipol dey obey am.
8 Sabemos que a lei é boa, se alguém se utiliza dela de modo legítimo,
9 God nor give di law, bikos of good pipol, but na for pipol wey dey disobey and do anyhow. Dis kind pipol dey like to sin and dem nor dey fear God. Dem nor dey holy or get respet for anytin and dem fit kill dia papa, mama or anybody.
9 tendo em vista que não se promulga lei para quem é justo, mas para os transgressores e rebeldes, para os ímpios e pecadores, para os iníquos e profanos, para os que matam o pai ou a mãe, para os homicidas,
10 Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
10 para os que praticam a imoralidade, para os que se entregam a práticas homossexuais, para os sequestradores, para os mentirosos, para os que fazem juramento falso e para tudo o que se opõe à sã doutrina,
11 wey dey dis betta gospel, wey awa Oga God sey make I dey prish.
11 segundo o evangelho da glória do Deus bendito, do qual fui encarregado.
12 I tank Christ awa Oga God, wey give mi pawa to do en work. Even doh I dey tok bad about am and dey opress en pipol before,
12 Dou graças a Cristo Jesus, nosso Senhor, que me fortaleceu e me considerou fiel, designando-me para o ministério,
13 e si mi as good pesin kon choose mi to serve am. But God sorry for mi, bikos den I nor know wetin I dey do and I nor bilive en gospel.
13 a mim, que, no passado, era blasfemo, perseguidor e insolente. Mas alcancei misericórdia, pois fiz isso na ignorância, na incredulidade.
14 But God grace big well-well with faith and love wey dey for Jesus Christ.
14 Transbordou, porém, a graça de nosso Senhor com a fé e o amor que há em Cristo Jesus.
15 Dis na true word and e good for evribody to asept and bilive am sey: “Jesus Christ kom dis world kon save sinnas” and na mi worse pass.
15 Esta palavra é fiel e digna de toda aceitação: que Cristo Jesus veio ao mundo para salvar os pecadores, dos quais eu sou o principal.
16 But God sorry for mi, so dat Christ go use mi as betta ezample to show sey, e dey patient with even di pesin wey sin pass. Den odas go know sey, demsef go fit bilive am kon get life wey nor dey end.
16 Mas, por esta mesma razão, me foi concedida misericórdia, para que, em mim, que sou o principal pecador, Cristo Jesus pudesse mostrar a sua completa longanimidade, e eu servisse de modelo para todos os que hão de crer nele para a vida eterna.
17 Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!
17 Assim, ao Rei eterno, imortal, invisível, Deus único, honra e glória para todo o sempre. Amém!
18 Timoti my pikin, na as dem tok for di words wey dem profesai about yu before, na-im make mi give yu dis kommand. So make dis words make yu strong as yu dey fight for Christ.
18 Esta é a admoestação que faço a você, meu filho Timóteo, segundo as profecias que anteriormente foram feitas a seu respeito: que, firmado nelas, você combata o bom combate,
19 Whole yor faith for Christ well and make yor mind dey klear. Bikos some pipol nor dey use good mind and bikos of dat, dia faith don skata.
19 mantendo a fé e a boa consciência, porque alguns, tendo rejeitado a boa consciência, vieram a naufragar na fé.
20 Hymenaeus and Alexanda na ezample of doz kind pipol. I don give dem to Satan, so dat dem go stop to dey tok anyhow about God.
20 Entre esses estão Himeneu e Alexandre, os quais entreguei a Satanás para serem castigados, a fim de que aprendam a não blasfemar.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Timóteo 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.