1 Samuel 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 E get one man from Benjamin tribe, en name na Kish and en papa na Abiel wey Zeror born and na Bekorat wey en papa na Afia from Benjamin tribe, born Zeror. Dem know Kish well-well for evriwhere.
1 Havia um homem de Benjamim, chamado Cis, filho de Abiel, filho de Seror, filho de Becorat, filho de Afia, de família benjaminita, que era um homem valente.
2 E get one pikin, en name na Saul and e fine well-well. E nor get anybody for Israel wey fine rish am and e tall pass evribody for Israel.
2 Tinha um filho chamado Saul, que era jovem e belo. Não havia em Israel outro mais belo do que ele; dos ombros para cima sobressaía a todo o povo.
3 One day, Saul papa donkey kon waka lost, so Kish kon tell Saul, “Make yu take one savant follow body, den make una go find di donkey.”
3 Tendo-se perdido as jumentas de Cis, pai de Saul, disse aquele ao seu filho: Toma um servo contigo e vai procurar as jumentas.
4 So Saul cross Efraim hill kountries kon pass thru Shalisha land, but dem nor si di donkey.
4 Saul atravessou a montanha de Efraim e entrou na terra de Salisa, sem nada encontrar; percorreu a terra de Salim, mas em vão. Na terra de Benjamim não as encontrou tampouco.
5 Wen dem rish Zuf land, Saul kon tell en savant wey dey with am sey, “Make wi dey go back before my papa go stop to worry for di donkey kon dey worry for us.”
5 Tendo chegado à terra de Suf, Saul disse ao seu servo: Vem, voltemos. Meu pai poderia não mais pensar nas jumentas e ficar com cuidados por nós.
6 But di savant ansa, “Si, one God savant dey dis town wey evribody dey respet. Evritin wey e tok really dey happen. So make wi go der, may bi e fit tell us wetin wi go do.”
6 Nesta cidade, disse-lhe o servo, há um homem de Deus, varão muito considerado; tudo o que ele prediz se cumpre. Vamos lá; talvez ele nos mostrará o caminho que devemos tomar.
7 So Saul ansa, “Okay! Make wi go der. But wetin wi go give di man since wi don finish all di food for awa bag? Wi nor get any gift wey wi go give God savant.” Den e ask en savant, “Na wetin wi still get?”
7 Saul respondeu: Está bem, vamos; mas o que havemos de oferecer-lhe? Nossos alforjes estão vazios, e não temos presente algum para dar ao homem de Deus. O que nos resta?
8 Di savant ansa, “Si, I still get small money for my hand. Wi go gi-am to God savant and e go tell us wetin wi go do.”
8 Tenho aqui um quarto de siclo de prata, respondeu o servo; dá-lo-ei ao homem de Deus para que ele nos mostre o caminho.
9 (For dat time for Israel, if anybody won go hear from God, e go sey, “Kom make wi go si di pesin wey dey si vishon.” Bikos dat time, dem dey koll profet, “Pesin wey dey si vishon.”)
9 {Antigamente, em Israel, todo o que ia consultar a Deus, dizia: Vinde, vamos ao vidente. Chamava-se então vidente ao que hoje se chama profeta.}
10 Saul tell en savant, “Yu wise well-well! Kom make wi dey go.” So dem kon go di town where God savant dey.
10 Saul disse ao seu servo: Tens razão. Anda, vamos E foram à cidade onde estava o homem de Deus.
11 As dem dey waka enter di town, dem kon meet some girls wey go draw wota dey kom. So dem ask dem, “Di man wey dey si vishon, na here e dey stay?”
11 Subindo eles a encosta da cidade, encontraram umas moças que saíam a buscar água. Há um vidente aqui?, perguntaram-lhes.
12 Di girls ansa, “Yes! Make una still waka go strait. But una go waka fast, bikos na today e kom di town and di pipol dey do sakrifice for di altar wey dey di hill.
12 Sim, responderam elas; ali diante de ti. Apressa-te; ele veio hoje à cidade, porque o povo oferece um sacrifício no lugar alto.
13 And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”
13 Ao entrar na cidade, encontrá-lo-eis seguramente antes que suba ao lugar alto para o festim. O povo não comerá antes que ele chegue, pois ele deverá abençoar o sacrifício; os convidados só comerão depois. Subi, pois; hoje o encontrareis.
14 So dem kon waka enter di town. As dem dey waka go di town centre, Samuel dey waka kom dia way and e dey go di altar for di hill.
14 Subiram à cidade. No momento em que entravam, encontraram Samuel que saía para subir ao lugar alto.
15 Naw, di day before Saul kom, God don tell Samuel:
15 Ora, na véspera da chegada de Saul, o Senhor tinha revelado a Samuel:
16 “For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”
16 Amanhã, e esta mesma hora, mandar-te-ei um homem da terra de Benjamim, e tu o ungirás para chefe do meu povo de Israel, para que ele livre o povo das mãos dos filisteus. Porque voltei os meus olhos para o meu povo, e o seu clamor chegou até a mim.
17 Wen Samuel si Saul, God kon tell am, “Na di man wey I tell yu bi dis. E go rule my pipol.”
17 Quando Samuel viu Saul, Deus disse-lhe: Eis o homem de quem te falei: este reinará sobre o meu povo.
18 As Saul dey waka near Samuel for di gate centre, e kon ask Samuel, “Abeg tell mi where di man wey dey si vishon dey stay.”
18 Saul aproximou-se de Samuel à porta da cidade e disse-lhe: Rogo-te que me digas onde é a casa do vidente.
19 Samuel ansa Saul, “Na mi dey si tumoro. Waka for my front go di altar for hill. Today yu go follow mi chop, den yu go-go house tumoro. I go tell yu evritin wey yu dey tink.
19 Sou eu mesmo o vidente, respondeu Samuel; sobe na minha frente ao lugar alto; comereis hoje comigo. Amanhã te deixarei partir, depois de ter revelado a ti tudo o que tens no coração.
20 Make yu nor worry about di donkey dem wey lost three days ago, bikos dem don si dem. But na who Israel pipol dey look for? Na yu and evribody for yor papa house?”
20 Quanto às jumentas perdidas há dois ou três dias, não te inquietes por isso, porque já foram encontradas. E de quem será toda a beleza de Israel? Não é porventura tua e de toda a casa de teu pai?
21 Saul ansa, “Na Benjamin tribe wey small pass for Israel, I from kom and na my family small pass for Benjamin tribe, wetin kon make yu dey tok to mi like dis?”
21 Saul respondeu: Eu sou um benjaminita, filho da menor tribo de Israel; e minha família é a menor de todas as famílias de Benjamim. Por que, pois, me falas assim?
22 Den Samuel take Saul and en savant enter room kon show dem where dem go sleep. Di place betta pass di ones wey dem give doz wey dem invite. Na like thirty men kom di sakrifice.
22 Samuel, tomando Saul e o seu servo, levou-os para a sala do festim e deu-lhes o primeiro lugar entre os convidados, que eram em número de aproximadamente trinta pessoas.
23 Samuel kon tell di pesin wey dey kook sey, “Give mi di food wey I sey make yu keep for mi.”
23 Samuel disse ao cozinheiro: Serve a porção que te dei e que te mandei pôr à parte.
24 So di pesin take di meat leg kon go put am for Saul front. Samuel kon sey, “Di food wey dem keep, na-im dey yor front naw o-o. Chop, bikos na yu dem keep am for since wen I sey, ‘Make una invite pipol kom.’ ” So Saul kon follow Samuel chop.
24 Tomou, pois, o cozinheiro a espádua com o que nela havia e a serviu a Saul. Samuel disse: Eis diante de ti a porção que te foi reservada. Come-a; reservei-a para este momento quando convidei o povo. Saul e Samuel comeram juntos naquele dia.
25 Before dem kom down from di altar for di hill kon enter di town, Samuel follow Saul tok on-top di house.
25 Do lugar alto desceram para a cidade e prepararam uma cama para Saul no terraço
26 As dem wake-up for morning, Samuel koll Saul on-top di house kon sey, “Make yu get up dey go house.” So Saul get up and di two of dem kon go outside.
26 e ele foi dormir. No dia seguinte, ao romper da aurora, Samuel chamou Saul ao terraço e disse-lhe: Levanta-te, e deixar-te-ei partir. Saul levantou-se e saíram os dois juntos.
27 As dem dey waka kom di town, Samuel kon tell Saul, “Tell yor savant make e waka dey go for front.” So Saul kon tell en savant. Den Samuel sey, “Yu go stay here small, so dat I go-go do wetin God sey make I do.”
27 Quando chegaram aos limites da cidade, Samuel disse a Saul: Dize ao teu servo que passe e vá adiante de nós, e o servo passou adiante; mas tu detém-te aqui para que eu te comunique uma palavra de Deus.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.