1 Samuel 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Den, Kiriat-Jearim pipol kom karry di Kovenant Box go Abinadab house wey dey di hill. Dem kon santify Abinadab pikin, Eleazar, so dat e go dey guide di box.
1 Vieram, pois, os habitantes de Cariatiarim, transportaram a arca do Senhor, puseram-na em casa de Aminadab, sobre a colina, e consagraram o seu filho Eleazar para que a guardasse.
2 So di Kovenant Box stay for Kiriat-Jearim for twenty years. For dis time, Israel pipol dey kry give God make E help dem.
2 E o tempo passou. Decorridos vinte anos desde o dia em que a arca fora levada para Cariatiarim, todo o Israel se lamentava, invocando o Senhor.
3 Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”
3 E Samuel falou a todo o povo de Israel, dizendo: Se voltardes de todo o vosso coração para o Senhor, tirando do meio de vós os deuses estranhos e as Astarot, se vos apegardes de todo o vosso coração ao Senhor e só a ele servirdes, então ele vos livrar das mãos dos filisteus.
4 So di pipol remove all Ashtoret gods and juju and dem kon dey serve only God.
4 Os israelitas afastaram os Baal e as Astarot, e serviram só ao Senhor.
5 Den Samuel sey, “Make una gada evribody for Israel kom Mizpa and I go pray to God for una.”
5 Convocai todo o Israel em Masfa, disse Samuel, e orarei por vós ao Senhor.
6 Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.
6 Reuniram-se em Masfa, tiraram água, derramaram-na diante do Senhor, e jejuaram aquele dia, dizendo: Pecamos contra o Senhor. Samuel era juiz de Israel em Masfa.
7 Wen Filistia pipol hear sey Israel pipol don gada for Mizpa, dia leaders kon gada dia sojas make dem for go fight Israel pipol. As Israel pipol hear sey Filistia pipol dey kom, fear kon katch dem.
7 Os filisteus foram informados de que os israelitas tinham-se juntado em Masfa, e os seus príncipes marcharam contra Israel. Os israelitas o souberam e ficaram aterrorizados.
8 So dem kon tell Samuel, “Abeg! Make yu still pray to di Oga awa God, so dat E go save us from Filistia pipol!”
8 Disseram a Samuel: Não cesses de clamar por nós ao Senhor, nosso Deus, para que ele nos salve das mãos dos filisteus.
9 So Samuel take one small sheep kon offa am as one full ofrin to God. Samuel pray to God for Israel pipol and God kon ansa am.
9 Samuel tomou um cordeiro de leite e ofereceu-o inteiro em holocausto ao Senhor; depois clamou ao Senhor por Israel, e o Senhor o ouviu.
10 As Samuel dey burn di ofrin, Filistia pipol dey kom fight Israel pipol. But for dat day, God kon send tonda from heaven go meet Filistia pipol. E make dem fear well-well and Israel pipol kon kill dem well-well.
10 Enquanto Samuel oferecia o holocausto, os filisteus começaram o combate contra Israel; o Senhor, porém, trovejou com a sua a voz fortíssima sobre os filisteus naquele momento, e eles se dispersaram, sendo batidos pelos israelitas.
11 Den, Israel men kon from Mizpa porshu Filistia pipol kon kill dem rish one aria for Bet-Car.
11 Os vencedores, saindo de Masfa, perseguiram os filisteus e feriram-nos até o lugar que está por baixo de Bet-Car.
12 Samuel put one stone between Mizpa and Shen. E koll di place Ebeneza, bikos e sey, “Na God help us rish here.”
12 Tomou Samuel uma pedra e pô-la entre Masfa e Sen, dando-lhe o nome de Eben-Ezer, pois disse: Até aqui nos socorreu o Senhor.
13 So Israel pipol win Filistia pipol and dem nor fight Israel pipol again. Thru-out Samuel time, God dey against Filistia pipol.
13 Humilhados dessa forma, os filisteus não tentaram mais voltar ao território de Israel. A mão do Senhor pesou sobre o filisteus durante toda a vida de Samuel.
14 All di towns wey Filistia pipol don take from Israel before, Israel pipol kon take dem back from Ekron go rish Gat. Israel pipol take dia aria from Filistia pipol hand and peace kon dey between Israel and Amor pipol.
14 Foram devolvidas a Israel as cidades que os filisteus lhes tinham tomado, desde Acaron até Get. Israel livrou sua terra das mãos dos filisteus, e havia paz entre Israel e os amorreus.
15 So Samuel lead Israel pipol till e die.
15 Samuel foi juiz em Israel durante toda a sua vida.
16 Evry year, e dey travel go Bethel and from der, e go-go Gilgal till e rish Mizpa kon dey judge Israel pipol for evriwhere.
16 Ia a cada ano visitar Betel, Gálgala e Masfa, onde pronunciava os seus juízos em favor de todo o Israel.
17 Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.
17 Voltava depois para Ramá, onde habitava. Ali também julgava Israel, e edificou naquele lugar um altar ao Senhor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.