1 Samuel 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Di Kovenant Box dey for Filistia pipol land for seven monts.
1 A arca do Senhor esteve sete meses na terra dos filisteus.
2 So Filistia pipol koll di priest and doz wey dey si vishon kon sey, “Wetin wi go do with di Kovenant Box? Make una tell us how wi go take karry am go back to where e suppose dey.”
2 Estes chamaram os sacerdotes e os adivinhos e perguntaram: — Que faremos com a arca do
3 Dem kon ansa, “If una won riton Israel God box go back to where e dey before, una must karry sometin join am. Una must put ofrin wey go show sey wetin una do nor good. Den una go dey well and una go know wetin make God dey ponish una.”
3 Eles responderam: — Se devolverem a arca do Deus de Israel, não a mandem vazia, mas enviem também a ele uma oferta pela culpa. Então vocês serão curados e saberão por que a mão dele continua pesando sobre vocês.
4 Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?”
4 Então os filisteus perguntaram: — Que oferta pela culpa devemos mandar? Os sacerdotes e adivinhos responderam: — Mandem cinco tumores de ouro e cinco ratos de ouro, segundo o número dos governantes dos filisteus, porque a praga é uma e a mesma sobre todos vocês e sobre todos os seus governantes.
5 Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.
5 Façam imitações dos tumores e dos ratos que andam destruindo a terra, e deem glória ao Deus de Israel. Assim ele talvez alivie a sua mão de cima de vocês e do deus e da terra de vocês.
6 Wetin make una dey sturbon like Egypt pipol and dia king? Wen God ponish dem, dem nor sey make Israel pipol dey go?
6 Por que vocês endureceriam o coração, como os egípcios e Faraó fizeram? Não é verdade que, depois que Deus os maltratou, eles deixaram os israelitas sair, e eles foram embora?
7 “So make una go make truck, plus two melu wey dem neva put wood cross dia head before. Make una karry dem for di truck kon drive dem with dia pikin go di yard.
7 — Agora, pois, façam um carro novo, arranjem duas vacas com crias, sobre as quais nunca foi colocado jugo, e amarrem as duas ao carro; quanto aos bezerros, levem-nos para casa.
8 Den make una take di Kovenant Box put for di truck kon add di gold tins wey una won give God join am, as ofrin for wetin una don do so. Den una go send am go.
8 Então peguem a arca do Senhor e a ponham sobre o carro. E num cofre, ao lado dele, ponham as figuras de ouro que vocês vão lhe enviar como oferta pela culpa; depois, deixem o carro ir.
9 But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”
9 Fiquem observando: se ele subir pelo caminho de Bete-Semes, que leva a seu território, então foi o Deus de Israel que nos fez este grande mal. Mas, se não, saberemos que não foi a sua mão que nos atingiu, e que isso nos aconteceu por acaso.
10 So di men go do as di priest tell dem. Dem take two melu kon join dem to di truck; dem put dia pikin from di yard.
10 Os homens fizeram isso: pegaram duas vacas com crias e as amarraram ao carro; e encerraram os seus bezerros em casa.
11 Dem kon put di Kovenant Box for der, plus di cupboard, di gold rat and sore image.
11 Puseram a arca do Senhor sobre o carro, junto com o cofre que continha os ratos de ouro e as imitações dos tumores.
12 Den di melu kon go strait to Bet-Shemesh. Dem dey make nois as dem dey go. Dem nor turn face left or rite. Filistia pipol leaders follow dem for back until dem rish Bet-Shemesh borda.
12 As vacas se encaminharam diretamente para Bete-Semes e, andando e berrando, seguiam sempre por esse mesmo caminho, sem se desviarem nem para a direita nem para a esquerda. Os governantes dos filisteus foram atrás delas, até a fronteira com Bete-Semes.
13 By dis time, di pipol for Bet-Shemesh dey harvest wetin dem plant for dia farm. Wen dem look up kon si di box, dem happy well-well.
13 O povo de Bete-Semes andava fazendo a colheita do trigo no vale. Quando levantaram os olhos, viram a arca e ficaram muito contentes.
14 Di truck enter one field for Bet-Shemesh and na Joshua own, den e stop for der near one big stone. Di pipol skata di truck, kill and offa di two melu as burnt ofrin give God.
14 O carro veio até o campo de Josué, o bete-semita, e parou ali, onde havia uma grande pedra. Eles cortaram a madeira do carro em pedaços e ofereceram as vacas ao Senhor , em holocausto.
15 Doz wey kom from Levi tribe, karry di Kovenant Box with di cupboard wey get di gold tins wey follow di box kon go put am near di big stone. So Bet-Shemesh pipol offa burnt ofrin and sakrifice to God.
15 Os levitas desceram a arca do Senhor e também o cofre que estava junto a ela, em que estavam os objetos de ouro, e os puseram sobre a grande pedra. No mesmo dia, os homens de Bete-Semes ofereceram holocaustos e sacrifícios ao Senhor .
16 Di five Filistia pipol leaders dey wosh wetin dey happen, but dem go back to Ekron for dat same day.
16 Os cinco governantes dos filisteus viram aquilo e voltaram para Ecrom no mesmo dia.
17 Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.
17 Estes são os tumores de ouro que os filisteus enviaram ao Senhor como oferta pela culpa: um por Asdode; outro por Gaza; outro por Asquelom; outro por Gate; e outro por Ecrom.
18 Dem still bring gold rat for each towns wey di five kings dey rule; from di strong ones go rish di village dem, plus di Great Abel where dem put di Kovenant Box, until di day wey e rish Joshua (wey kom from Bet-Shemesh), field.
18 Enviaram também os ratos de ouro, segundo o número de todas as cidades dos filisteus, pertencentes aos cinco governantes, desde as cidades fortificadas até as aldeias campestres. A grande pedra, sobre a qual puseram a arca do Senhor , está até o dia de hoje no campo de Josué, o bete-semita.
19 But God kill some of Bet-Shemesh pipol, bikos dem go look inside di box; pipol wey God kill na 50,070. Di pipol kry, bikos God kill dia pipol.
19 O Senhor feriu os homens de Bete-Semes, porque olharam para dentro da arca do Senhor , matando setenta deles. Então o povo chorou, porque o Senhor tinha feito tão grande matança entre eles.
20 Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”
20 Os homens de Bete-Semes disseram: — Quem poderia estar diante do
21 So dem kon send messenja go meet di pipol wey dey Kiriat-Jearim sey, “Filistia pipol don riton di Kovenant Box. Make una kom take am go house.”
21 Então enviaram mensageiros aos moradores de Quiriate-Jearim, dizendo: — Os filisteus devolveram a arca do

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.