1 Samuel 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Den Samuel tell Israel pipol wetin God tok.
1 Ora, saiu Israel à batalha contra os filisteus, e acampou-se perto de Ebenézer; e os filisteus se acamparam junto a Afeque.
2 Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. Wen di fight start, Filistia pipol kon win and kill about 4,000 Israel men for di war.
2 E os filisteus se dispuseram em ordem de batalha contra Israel; e, travada a peleja, Israel foi ferido diante dos filisteus, que mataram no campo cerca de quatro mil homens do exército.
3 Wen di sojas kom back to dia kamp, Israel leaders kon sey, “Wetin make God let Filistia pipol win us like dis? Make wi karry God Kovenant Box from Shiloh, follow body. If di box dey with us, e go save us from awa enemies.” Levi pipol karry di Kovenant Box |alt="Levites carrying the Ark of Kovenant" src="lb00283c.tif" size="col" loc="1SA 4:3" copy="LB" ref="4:3"
3 Quando o povo voltou ao arraial, disseram os anciãos de Israel: Por que nos feriu o Senhor hoje diante dos filisteus? Tragamos para nós de Siló a arca do pacto do Senhor, para que ela venha para o meio de nós, e nos livre da mão de nossos inimigos.
4 So dem send some sojas go Shiloh go karry God Kovenant Box wey dey for di cherubim centre. Eli two boys pikin, Hofni and Finehas, dey der with God Kovenant Box.
4 Enviou, pois, o povo a Siló, e trouxeram de lá a arca do pacto do Senhor dos exércitos, que se assenta sobre os querubins; e os dois filhos de Eli, Hofni e Finéias, estavam ali com a arca do pacto de Deus.
5 Wen God Kovenant Box rish di kamp, Israel pipol kon shaut well-well, sotey di groun kon dey shake.
5 Quando a arca do pacto do Senhor chegou ao arraial, prorrompeu todo o Israel em grandes gritos, de modo que a terra vibrou.
6 Wen Filistia pipol hear di pipol shaut, dem kon sey, “Wetin make Israel pipol dey shaut like dis for Hibru kamp?”
6 E os filisteus, ouvindo o som da gritaria, disseram: Que quer dizer esta grande vozearia no arraial dos hebreus? Quando souberam que a arca do Senhor havia chegado ao arraial,
7 Fear katch Filistia pipol, bikos dem fill sey difren gods don enter Israel kamp. Dem kon sey, “Dis one bad for us! Wi neva si anytin like dis before o-o!
7 os filisteus se atemorizaram; e diziam: Os deuses vieram ao arraial. Diziam mais: Ai de nós! porque nunca antes sucedeu tal coisa.
8 Dis one sirious well-well! Na who go save us from dis big-big gods? Dis na di gods wey kill Egypt pipol with difren diziz for di desert!
8 Ai de nós! quem nos livrará da mão destes deuses possantes? Estes são os deuses que feriram aos egípcios com toda sorte de pragas no deserto.
9 So Filistia pipol, make una dey strong kon bihave like men, if not una go serve Hibru pipol di way wey dem don serve una! Make una fight dem like men!”
9 Esforçai-vos, e portai-vos varonilmente, ó filisteus, para que porventura não venhais a ser escravos dos hebreus, como eles o foram vossos; portai-vos varonilmente e pelejai.
10 So Filistia pipol kon fight and kill Israel pipol well-well till di remainin ones, run go house. Di pipol wey dem kill many well-well; 3,000 sojas wey dey waka for groun die for di war;
10 Então pelejaram os filisteus, e Israel foi derrotado, fugindo cada um para a sua tenda; e houve mui grande matança, pois caíram de Israel trinta mil homens de infantaria.
11 dem take di Kovenant Box go and Eli two boys, Hofni and Finehas die too.
11 Também foi tomada a arca de Deus, e os dois filhos de Eli, Hofni e Finéias, foram mortos.
12 Dat day, one man from Benjamin tribe run from di war front go Shiloh. E shirt don tear and dirty full en head.
12 Então um homem de Benjamim, correndo do campo de batalha chegou no mesmo dia a Siló, com as vestes rasgadas e terra sobre a cabeça.
13 Wen e rish Shiloh, Eli sidan for chair for outside dey look di road, bikos en mind dey disturb am about di Kovenant Box. As di man enter di town go tok wetin happen, di whole town kon dey kry.
13 Ao chegar ele, estava Eli sentado numa cadeira ao pé do caminho vigiando, porquanto o seu coração estava tremendo pela arca de Deus. E quando aquele homem chegou e anunciou isto na cidade, a cidade toda prorrompeu em lamentações.
14 Wen Eli hear dem dey kry, e kon sey, “Wetin dey happen?”
14 E Eli, ouvindo a voz do lamento, perguntou: Que quer dizer este alvoroço? Então o homem, apressando-se, chegou e o anunciou a Eli.
15 Dis time, Eli na ninty-eight years. En eyes open, but e nor dey fit si well.
15 Ora, Eli tinha noventa e oito anos; e os seus olhos haviam cegado, de modo que já não podia ver.
16 Di man kon tell Eli, “I run komot from di war front today!”
16 E disse aquele homem a Eli: Estou vindo do campo de batalha, donde fugi hoje mesmo. Perguntou Eli: Que foi que sucedeu, meu filho?
17 Di man ansa, “Israel pipol don run from Filistia pipol! Dem don kill di sojas well-well! Yor two boys, Hofni and Finehas, don die too. And dem don karry God Kovenant Box go!”
17 Então respondeu o que trazia as novas, e disse: Israel fugiu de diante dos filisteus, e houve grande matança entre o povo; além disto, também teus dois filhos, Hofni e Finéias, são mortos, e a arca de Deus é tomada.
18 As di man koll God Kovenant Box, Eli kon fall from en chair go back near di gate. En neck break and e kon die, but e don old well-well. E judge Israel pipol for forty years.
18 Quando ele fez menção da arca de Deus, Eli caiu da cadeira para trás, junto à porta, e quebrou-se-lhe o pescoço, e morreu, porquanto era homem velho e pesado. Ele tinha julgado a Israel quarenta anos.
19 En pikin, Finehas wife get belle and don nearly born. Wen e hear sey Filistia pipol don take di Kovenant Box and en husband and en husband papa don die, e shaut well-well kon born. But di pains too mush for am.
19 E estando sua nora, a mulher de Finéias, grávida e próxima ao parto, e ouvindo estas novas, de que a arca de Deus era tomada, e de que seu sogro e seu marido eram mortos, encurvou-se e deu à luz, porquanto as dores lhe sobrevieram.
20 As e dey die, di wimen wey dey with am kon sey, “Nor fear! Yu don born boy!” But e nor ansa dem or listin to wetin dem dey tok.
20 E, na hora em que ia morrendo, disseram as mulheres que estavam com ela: Não temas, pois tiveste um filho. Ela, porém, não respondeu, nem deu atenção a isto.
21 E koll di pikin Ikabod, wey mean “God glory don komot from Israel,” e dey tok about di Kovenant Box wey Filistia pipol don karry go, en husband and husband papa wey don die.
21 E chamou ao menino de Icabô, dizendo: De Israel se foi a glória! Porque fora tomada a arca de Deus, e por causa de seu sogro e de seu marido.
22 E kon sey, “God glory don komot from Israel, bikos Filistia pipol don karry God Kovenant Box go.”
22 E disse: De Israel se foi a glória, pois é tomada a arca de Deus.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.