1 Samuel 30
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 For di third day, David and en men kon rish Ziklag. But Amalek pipol attack Negev and Ziklag. Dem burn Ziklag rish groun.
1 Sucedeu, pois, que, chegando Davi e os seus homens ao terceiro dia a Ziclague, já os amalequitas com ímpeto tinham dado sobre o Sul e sobre Ziclague, e tinham ferido a Ziclague, e a tinham posto a fogo.
2 Dem katch di wimen wey dey der, from di small ones go rish di old ones, but dem nor kill anybody. Dem just karry dem follow body.
2 E levaram cativas as mulheres que estavam nela, porém a ninguém mataram, nem pequenos nem grandes; tão somente os levaram consigo e foram pelo seu caminho.
3 Wen David and en men rish di town, dem kon si sey Amalek pipol don burn am kon karry dia wimen, sons and dotas go.
3 E Davi e os seus homens vieram à cidade, e eis que estava queimada a fogo, e suas mulheres, seus filhos e suas filhas eram levados cativos.
4 Den David and en men kon kry well-well until dem nor fit kry again.
4 Então, Davi e o povo que se achava com ele alçaram a sua voz e choraram, até que neles não houve mais força para chorar.
5 Dem katch David two wifes, Ahinoam wey kom from Jezrel and Abigail from Karmel wey bi Nabal wife before.
5 Também as duas mulheres de Davi foram levadas cativas; Ainoã, a jezreelita, e Abigail, a mulher de Nabal, o carmelita.
6 David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.
6 E Davi muito se angustiou, porque o povo falava de apedrejá-lo, porque o ânimo de todo o povo estava em amargura, cada um por causa dos seus filhos e das suas filhas; todavia, Davi se esforçou no Senhor , seu Deus.
7 Den David tell priest Abiatar wey bi Ahimelek pikin, “Bring di efod kon give mi.” So Abiatar bring di efod kom.
7 E disse Davi a Abiatar, o sacerdote, filho de Aimeleque: Traze-me, peço-te, aqui o éfode. E Abiatar trouxe o éfode a Davi.
8 So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?”
8 Então, consultou Davi ao Senhor , dizendo: Perseguirei eu a esta tropa? Alcançá-la-ei? E o Senhor lhe disse: Persegue-a, porque, decerto, a alcançarás e tudo libertarás.
9 So David porshu dem with en six hundred men. Wen David rish River Besor, some of en men kon stay der.
9 Partiu, pois, Davi, ele e os seiscentos homens que com ele se achavam, e chegaram ao ribeiro de Besor, onde os que ficaram atrás pararam.
10 David and 400 men kon kontinue to porshu dem and two hundred men wey don taya well-well kon stay for River Besor.
10 E seguiu-os Davi, ele e os quatrocentos homens, pois que duzentos homens ficaram atrás, por não poderem, de cansados que estavam, passar o ribeiro de Besor.
11 Den dem si one Egypt man for di field wey almost dey faint, so dem kon bring am kom meet David. Dem gi-am bread and wota make e chop and drink kon still gi-am
11 E acharam no campo um homem egípcio e o trouxeram a Davi; deram-lhe pão, e comeu, e deram-lhe a beber água.
12 some fig wey don dry and two raisin. Dis food kon make am strong well-well, bikos e neva chop food or drink wota for three days and three nites.
12 Deram-lhe também um pedaço de massa de figos secos e dois cachos de passas, e comeu; e voltou-lhe o seu espírito, porque havia três dias e três noites que não tinha comido pão nem bebido água.
13 David kon tell am, “Na who yu bi and where yu from kom?” Di yong man kon ansa, “I kom from Egypt and my oga na Amalek pesin. My oga go leave mi, bikos I dey sick for three days naw.
13 Então, Davi lhe disse: De quem és tu e de onde és? E disse o moço egípcio: Sou servo de um homem amalequita, e meu senhor me deixou, porque adoeci há três dias.
14 Wi go distroy Keret wey dey Negev for Judah aria and Negev aria wey bi Kaleb own. Wi burn Ziklag.”
14 Nós demos com ímpeto para a banda do sul dos queretitas, e para a banda de Judá, e para a banda do sul de Calebe e pusemos fogo a Ziclague.
15 David kon tell am, “Yu fit take us go where yor pipol dey?”
15 E disse-lhe Davi: Poderias, descendo, guiar-me a essa tropa? E disse-lhe: Por Deus, me jura que me não matarás, nem me entregarás na mão de meu senhor, e, descendo, te guiarei a essa tropa.
16 So di man take David go where Amalek pipol dey and David kon si sey dem full di land. Dem dey chop and drink; dey enjoy diasef, bikos of evritin wey dem karry from Filistia pipol and Judah land.
16 E, descendo, o guiou. E eis que estavam espalhados sobre a face de toda a terra, comendo, e bebendo, e dançando, por todo aquele grande despojo que tomaram da terra dos filisteus e da terra de Judá.
17 But David kill dem from morning until di next evening. Non of dem eskape, escept di 400 men wey enter kamel kon run.
17 E feriu-os Davi, desde o crepúsculo até à tarde do dia seguinte, e nenhum deles escapou, senão só quatrocentos jovens que, montados sobre camelos, fugiram.
18 David kollect evritin wey Amalek pipol take before; e save en two wifes.
18 Assim, livrou Davi tudo quanto tomaram os amalequitas; também as suas duas mulheres livrou Davi.
19 Nor-tin lost, weda na small or big tin. E save pipol sons and dotas; di tins wey Amalek pipol take from dem and evry oda tin wey dem take before. David bring evritin kom back.
19 E ninguém lhes faltou, desde o menor até ao maior e até os filhos e as filhas; e também desde o despojo até tudo quanto lhes tinham tomado: tudo Davi tornou a trazer.
20 David take all di sheep kon put dem for di oda animals front. Pipol kon dey sey, “Dis na di tins wey David karry!”
20 Também tomou Davi todas as ovelhas e vacas, e levavam-nas diante do outro gado e diziam: Este é o despojo de Davi.
21 Naw, David don near di two hundred men wey don taya well-well to follow am go; doz wey dem live for River Besor. Dem kon go meet David and di pipol wey dey with am. Wen David rish where di two hundred men dey, e kon ask dem, “How una body!”
21 E, chegando Davi aos duzentos homens que, de cansados que estavam, não puderam seguir a Davi e que deixaram ficar no ribeiro de Besor, estes saíram ao encontro de Davi e do povo que com ele vinha; e, chegando-se Davi ao povo, os saudou em paz.
22 But all di wiked men among di ones wey follow David kon sey, “Since dem nor follow us go, wi nor go give dem anytin from di tins wey wi karry so. Make dem take only dia wifes and shidren dey go!”
22 Então, todos os maus e filhos de Belial, dentre os homens que tinham ido com Davi, responderam e disseram: Visto que não foram conosco, não lhes daremos do despojo que libertamos; mas que leve cada um sua mulher e seus filhos e se vá.
23 But David sey, “Nor bi so, my brodas! Make una nor do like dis. Si wetin God don give us! E don protet and save us from Amalek pipol wey kom fight against us.
23 Porém Davi disse: Não fareis assim, irmãos meus, com o que nos deu o Senhor , que nos guardou e entregou a tropa que contra nós vinha nas nossas mãos.
24 Who go listin to una for dis matter? Di tins wey dem give doz wey go fight di war, na di same tin dem go give dis men. Make evribody share am ekwol.”
24 E quem em tal vos daria ouvidos? Porque qual é a parte dos que desceram à peleja, tal também será a parte dos que ficaram com a bagagem; igualmente repartirão.
25 David make dis law and Israel pipol dey obey dis law kon rish today.
25 O que assim foi desde aquele dia em diante, porquanto o pôs por estatuto e direito em Israel, até ao dia de hoje.
26 Wen David go back to Ziklag, e kon send some of di tins wey dem karry, go give di leaders for Judah wey bi en friends sey, “Dis gift na for una, wi take dem from God enemies.”
26 E, chegando Davi a Ziclague, enviou do despojo aos anciãos de Judá, seus amigos, dizendo: Eis aí para vós uma bênção do despojo dos inimigos do Senhor :
27 Di gift na for di pipol wey dey: Bethel, Ramot Negev and Jattir;
27 aos de Betel, e aos de Ramote do Sul, e aos de Jatir,
28 doz wey dey Aroer, Sifmot, Eshtemoa,
28 e aos de Aroer, e aos de Sifmote, e aos de Estemoa,
29 and Rakal. Doz wey dey Jerahmeel and Ken town;
29 e aos de Racal, e aos que estavam nas cidades jerameelitas e nas cidades dos queneus,
30 plus Hormah, Bor-Ashan, Atak,
30 e aos de Horma, e aos de Borasã, e aos de Atace,
31 Hebron and doz wey dey di oda arias wey David and en men don travel pass before.
31 e aos de Hebrom, e a todos os lugares em que andara Davi, ele e os seus homens.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 30, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.