1 Samuel 28

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Afta some time, Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. So Akish kon tell David, “Hope yu know sey yu and yor men go follow mi go fight.”
1 Naqueles dias os filisteus reuniram suas tropas para lutar contra Israel. Aquis disse a Davi: "Você deve saber que você e seus soldados me acompanharão no exército".
2 David ansa, “If na so di kase bi, den yu go know wetin yor savant fit do!” Akish kon sey, “Den I go make yu my bodyguard from naw go.”
2 Disse Davi a Aquis: "Então tu saberás o que teu servo é capaz de fazer". Aquis respondeu-lhe: "Então, o colocarei como minha guarda pessoal permanente".
3 Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.
3 Samuel já havia morrido, e todo o Israel o havia pranteado e sepultado em Ramá, sua cidade natal. Saul havia expulsado do país os médiuns e os espíritas.
4 Filistia pipol gada kon kamp for Shunem. Saul gada all en sojas for Israel kon kamp for Gilboa.
4 Depois que os filisteus se reuniram, vieram e acamparam em Suném, enquanto Saul reunia todos os israelitas e acampava em Gilboa.
5 Wen Saul si sey Filistia sojas plenty well-well, e kon dey fear.
5 Quando Saul viu o acampamento filisteu, teve medo; ficou apavorado.
6 So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.
6 Ele consultou o Senhor, mas este não lhe respondeu nem por sonhos nem por Urim nem por profetas.
7 So Saul kommand en savants, “Make una go find any woman wey dey do majik kom, so dat I go-go ask am wetin go happen.” En savant ansa, “E get one majik woman for Endor.”
7 Então Saul disse aos seus auxiliares: "Procurem uma mulher que invoca espíritos, para que eu a consulte". Eles disseram: "Existe uma em En-Dor".
8 Saul dress so dat pipol nor go know sey na en den e kon go with two of en men. Wen dem rish where di woman dey for nite, e kon sey, “Abeg, make yu use yor pawa take koll di pesin spirit wey I go tell yu.”
8 Saul então se disfarçou, vestindo outras roupas, e foi à noite, com dois homens, até a casa da mulher. Ele disse a ela: "Invoque um espírito para mim, fazendo subir aquele cujo nome eu disser".
9 Di woman ansa am, “Si! Yu know wetin Saul don do; e don porshu di pipol wey dey si vishon and doz wey dey do majik komot from di land. So why yu dey kom try mi, so dat dem go kill mi?”
9 A mulher, porém, lhe disse: "Certamente você sabe o que Saul fez. Ele eliminou os médiuns e os espíritas da terra de Israel. Por que você está preparando uma armadilha contra mim que me levará à morte? "
10 But Saul kon use God take swear sey, “As long as God dey alive, nor-tin go happen to yu.”
10 Saul jurou-lhe pelo Senhor: "Juro pelo nome do Senhor que você não será punida por isso".
11 So di woman ansa, “Na wish pesin name yu wont make I koll?” Saul ansa, “Na Samuel wey don die.”
11 "Quem devo fazer subir? ", perguntou a mulher. Ele respondeu: "Samuel".
12 Wen di woman si Samuel, di woman kon kry well-well sey, “Wetin make yu deceive mi? Yu bi Saul!”
12 Quando a mulher viu Samuel, gritou e disse a Saul: "Por que me enganaste? Tu mesmo és Saul! "
13 Di king ansa, “Nor let fear katch yu. Wetin yu si?” Di woman ansa, “I dey si pesin wey bi like god dey kom out from groun!”
13 O rei lhe disse: "Não tenha medo. O que você está vendo? " A mulher disse a Saul: "Vejo um ser que sobe do chão".
14 Di king ask di woman, “Na how e look like?” Di woman ansa, “Na old man dey kom so-o! Dem wrap en body with klot!” Den Saul know sey na Samuel and e kon bow face groun.
14 Ele perguntou: "Qual a aparência dele? " E disse ela: "Um ancião vestindo um manto está subindo". Então Saul ficou sabendo que era Samuel, inclinou-se e prostrou-se, rosto em terra.
15 Samuel kon tell Saul, “Wetin make yu dey disturb mi? Wetin make yu koll mi kom back?” Saul ansa, “I dey for big wahala! Filistia pipol dey fight mi and God nor dey ansa mi again. E nor dey listin to mi or tok to mi thru profet or dream. So I kon koll yu, so dat yu go tell mi wetin I go do.”
15 Samuel perguntou a Saul: "Por que você me perturbou, fazendo-me subir? " Respondeu Saul: "Estou muito angustiado. Os filisteus estão me atacando e Deus se afastou de mim. Ele já não responde nem por profetas nem por sonhos; por isso o chamei para dizer-me o que fazer".
16 Samuel kon sey, “Wetin make yu dey ask mi naw wey God don turn from yu kon bi yor enemy?
16 Disse Samuel: "Por que você me chamou, já que o Senhor se afastou de você e se tornou seu inimigo?
17 God dey do wetin E tok. E don tear di kingdom from yor hand kon gi-am to David.
17 O Senhor fez o que predisse por meu intermédio: rasgou de suas mãos o reino e o deu a seu próximo, a Davi.
18 Since yu nor gri obey God and yu nor show en vexnashon to doz Amalek pipol, God don ponish yu today.
18 Porque você não obedeceu ao Senhor nem executou a grande ira dele contra os amalequitas, ele lhe faz isso hoje.
19 God go give yu and Israel pipol to Filistia pipol. Tumoro, both yu and yor sons go dey with mi. God go still give Israel sojas to Filistia pipol.”
19 O Senhor entregará você e o povo de Israel nas mãos dos filisteus, e amanhã você e seus filhos estarão comigo. O Senhor também entregará o exército de Israel nas mãos dos filisteus".
20 Saul kon kwik-kwik sleep for groun for der and e kon dey fear, bikos of wetin Samuel tok. E nor get any pawa to waka again, bikos e nor chop anytin from morning go rish nite.
20 Na mesma hora Saul caiu estendido no chão, aterrorizado pelas palavras de Samuel. Suas forças haviam se esgotado, pois ele tinha passado todo aquele dia e toda aquela noite sem comer.
21 Wen di woman kom meet and si how Saul dey fear rish, di woman kon tell am, “Yor savant don do wetin yu ask am. I risk my life kon do wetin yu tell mi.
21 Quando a mulher se aproximou de Saul e viu que ele estava profundamente perturbado, disse: "Olha, tua serva te obedeceu. Arrisquei minha vida e fiz o que me ordenaste.
22 Naw, na yor turn to listin to yor savant. Make I give yu some bread make yu chop. Wen yu don get pawa again, yu fit dey go.”
22 Agora, por favor, ouve tua serva e come um pouco para que tenhas forças para seguir teu caminho".
23 But Saul sey, “I nor wont chop.” En savants and di woman beg am well-well, so e kon gri with dem. E get up from groun kon sidan for di bed.
23 Ele recusou e disse: "Não vou comer". Seus homens, porém, insistiram com ele, e a mulher também; e ele os atendeu. Ele se levantou do chão e sentou-se na cama.
24 Di woman kwik-kwik kill di small melu wey e get, take some flower, prepare am kon bake bread wey nor get yist.
24 A mulher matou depressa um bezerro gordo que tinha em casa; apanhou um pouco de farinha, amassou-a e assou pão sem fermento.
25 E gi-am to Saul and en savants and dem kon chop. Den dem go back, dat same nite.
25 Então ela serviu a Saul e a seus homens, e eles comeram. E naquela mesma noite eles partiram.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 28, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.