1 Samuel 25

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Samuel die and evribody for Israel gada kon mourn for am. Dem beri am for en house for Rama. Den David kon go Paran desert.
1 Samuel morreu. Todo o Israel se juntou para chorá-lo. Sepultaram-no na sua propriedade em Ramá. E Davi retirou-se para o deserto de Farã.
2 E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.
2 Havia um homem em Maon cujas propriedades estavam em Carmelo. Era um homem muito rico: possuía três mil ovelhas e mil cabras. Ele encontrava-se então em Carmelo para a tosquia de suas ovelhas.
3 Di man name na Nabal and en wife na Abigail. Di woman get sense and e fine well-well, but di man bad and na wiked tins e dey do. Na Kaleb tribe e from kom.
3 Chamava-se Nabal, e sua esposa Abigail, mulher de grande inteligência e formosura. Ele, porém, era grosseiro e mau; descendia de Caleb.
4 Wen David hear for inside di desert sey Nabal dey barb en sheep hair,
4 Davi, no deserto, sabendo que Nabal tosquiava o seu rebanho,
5 e send ten savant kon tell dem, “Make una go meet Nabal for Karmel kon tell am sey I dey greet am.
5 mandou-lhe dez homens com esta ordem: Subi a Carmelo e dirigi-vos a Nabal,
6 Den una go tell am, ‘Make peace dey with yu and yor house! Make peace dey with evritin wey bi yor own!
6 saudando-o em meu nome e dizendo-lhe: Pela vida! A paz seja contigo! Paz à tua casa e paz a todos os teus bens!
7 “ ‘Naw, I hear sey pipol dey barb sheep for yu. Wen yor pipol wey dey guide di sheep dey with us for Karmel, wi nor curse or fight dem.
7 Soube que há tosquia em tua casa. Ora, os teus pastores estiveram perto de nós e nunca lhes fizemos mal algum. Nada lhes faltou durante todo o tempo que ficaram em Carmelo.
8 Ask yor savants and e go tell yu! Make yu favor yor savants, bikos na holiday wi kom for. Abeg make yu give yor savant and David anytin wey yu go fit give us.’ ”
8 Pergunta-o aos teus servos e eles to dirão. Que os meus encontrem agora graça aos teus olhos, porque chegamos em um dia de festa. Rogo-te que dês aos teus servos e ao teu filho Davi o que tiveres à mão.
9 So David savants go tell Nabal all dis word with David name. Den dem nor tok again.
9 Os homens de Davi foram e repetiram a Nabal todas estas palavras em nome de Davi, e ficaram esperando.
10 But Nabal tell David savants, “Na who bi David and na who bi dis Jesse pikin sef? Na dis kind time many savants dey run leave dia oga.
10 Nabal, porém, respondeu-lhes: Quem é Davi? E quem é o filho de Isaí? Há hoje muitos escravos que fogem da casa de seus senhores!
11 Make I give una di bread, wota and meat wey I won give doz wey dey barb di sheep? I nor even know where una from kom!”
11 Irei eu tomar meu pão, minha água e a carne que preparei para os meus tosquiadores, e dá-los a homens que vêm não se sabe de onde?
12 So David savant kon go back. Wen dem kom back, dem tell David evritin.
12 Os servos de Davi retomaram o caminho e voltaram. Ao chegarem, contaram tudo ao seu senhor.
13 Den David kommand en men, “Make una karry una swod,” and David karry en swod too. Like four hundred men kon follow David, while two hundred dey house with evritin wey dem get.
13 Então disse Davi aos seus homens: Cinja cada um a sua espada! Todos o fizeram, inclusive Davi. Cerca de quatrocentos homens seguiram Davi, ficando duzentos com as bagagens.
14 But one savant kon tell Abigail, Nabal wife sey, “David send pipol from desert make dem kon greet awa oga, but awa oga shaut give dem.
14 Mas Abigail, mulher de Nabal, fora informada por um dos servos de seu marido: Davi mandou, do deserto, mensageiros para saudar o nosso amo, mas ele os recebeu mal.
15 Di men dem dey good to us. Dem nor curse or wound us wen wi dey with dem for di field.
15 No entanto, esses homens nos trataram sempre muito bem, e jamais nos fizeram mal algum, nem nos causaram prejuízo durante todo o tempo que estivemos com eles no campo.
16 Both for nite and day time, dem dey guide us wen wi dey guide awa sheep.
16 Pelo contrário, serviram-nos de defesa, dia e noite, durante todo o tempo em que estivemos com eles apascentando os rebanhos.
17 Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”
17 Vê, pois, o que tens a fazer, porque nosso amo e toda a sua casa está ameaçada de ruína, e ele é um malvado com quem não se pode falar.
18 So Abigail kon kwik-kwik take two hundred bread, two kontaina wey wine full, five sheep wey dem don barb well, hundred raisin and two hundred fig fruits wey dem don press. Abigail pak dem put on-top donkey
18 Apressou-se então Abigail, e tomou duzentos pães, dois odres de vinho, cinco cordeiros preparados, cinco medidas de grão torrado, cem tortas de uvas secas, duzentas de figos secos, colocando tudo em cima de jumentos.
19 kon tell en savant, “Make yu go for my front. I dey kom for yor back.” But e nor tell Nabal wey bi en husband.
19 E disse aos seus servos: Ide adiante de mim; eu vos seguirei. Mas não disse nada a Nabal, seu marido.
20 As Abigail dey ride en donkey pass under di mountin, e kon meet David and en men for road.
20 Quando descia por um caminho secreto da montanha, montada num jumento, encontrou Davi com os seus homens que vinham em sentido inverso.
21 Naw, David dey tink for en mind sey, “As I guide evritin wey bi dis man own for desert rish, so e nor mean anytin to am? I nor take anytin from am. But e don use wikedness take pay di good wey I do for am.
21 Ora, Davi dissera: Em vão, pois, guardei tudo o que esse homem possuía no deserto, sem que lhe fosse tirada coisa alguma! E ele paga-me o bem com o mal.
22 Make God ponish mi if by tumoro one of en family still dey alive!”
22 Deus trate com todo o seu rigor os inimigos de Davi! E que ele não me poupe, se de hoje até amanhã eu deixar vivo um só homem de tudo o que pertence a Nabal!
23 Wen Abigail si David, e kwik-kwik kom down from di donkey kon bow for am.
23 Quando Abigail avistou Davi, desceu prontamente do jumento e prostrou-se com o rosto por terra diante dele.
24 Abigail fall for groun kon sey, “My oga, I gri sey wi dey wrong. But abeg make yu let yor woman savant follow yu tok. Make yu listin to wetin yor savant get to tok.
24 Assim prostrada aos seus pés, disse-lhe: Sobre mim, meu senhor, caia a culpa! Deixa falar a tua serva e ouve suas palavras.
25 My oga, make yu nor listin to dat wiked Nabal. E dey bihave like en name! En name mean ‘Fool’ and e really bi fool. But mi yor savant nor si di men wey yu send kom.
25 Que o meu senhor não faça caso desse malvado Nabal, pois ele é bem o que o seu nome indica: Nabal, louco; e ele o é. Mas eu, tua escrava, não vi os homens que o meu senhor mandou.
26 “Naw my oga, as long as God dey alive and as long as yu dey alive too, God nor go let yu kill or do tins di way yu wont am. Naw, make yor enemies and doz wey dey try to wound yu, bi like Nabal.
26 Agora, por Deus e por tua vida: foi o Senhor quem te impediu de derramar sangue e de te vingar por tua mão. Sejam como Nabal os teus inimigos e os que procuram fazer mal ao meu senhor.
27 So my oga, make yu allow yor savants take dis gift dem wey I bring kom give yu.
27 Aceita, pois, este presente que tua serva trouxe ao meu senhor, e reparte-o entre os homens que te seguem.
28 Abeg, make yu forgive di sin wey wi kommit and true-true God go make yor house great, bikos yu dey fight God fight. All di days wey yu go stay for dis eart, yu nor go put hand for bad tin.
28 Rogo-te que perdoes a culpa de tua serva. Certamente o Senhor dará à casa de meu senhor uma existência durável, porque o meu senhor combate nas guerras de Deus, e nenhum mal te atingirá em todos os dias de tua vida.
29 Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.
29 Se alguém te perseguir ou conspirar contra a tua vida, a alma de meu senhor será guardada no escrínio dos vivos junto do Senhor, teu Deus, enquanto a vida de teus inimigos será lançada pelo Senhor ao longe, como a pedra de uma funda.
30 God go do evritin wey E promise yu and E go make yu oga ova Israel pipol.
30 Quando o Senhor tiver feito ao meu senhor todo o bem que lhe prometeu, e te tiver estabelecido chefe sobre Israel,
31 Yor mind nor go judge yu bikos yu kill pipol wey nor do wrong or pay pipol back for wetin dem do yu. Wen God don give yu, my oga viktory, abeg make yu remember mi.”
31 não terás no coração este pesar, nem este remorso de ter derramado sangue sem motivo e de se ter vingado por si mesmo! Quando o Senhor te tiver feito bem, ó meu Senhor, lembra-te de tua serva.
32 Den David kon tell Abigail, “Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey don send yu kom meet mi today!
32 Davi respondeu a Abigail: Bendito seja o Senhor, Deus de Israel, que te mandou hoje ao meu encontro!
33 God bless yu as yu take judge di kase! Make God reward yu, bikos yu nor let mi kill pipol kon do as my own mind dey tell mi.
33 Bendita seja a tua prudência! E bendita sejas tu mesma, que me impediste hoje de derramar sangue e vingar-me pela minha mão!
34 If not, as long as di Oga wey bi Israel God dey alive, di pesin wey stop mi to kill una, if to sey yu nor kwik meet mi, by tumoro morning, no singol boy for Nabal family for dey alive.”
34 Mas, pelo Senhor, Deus de Israel, que me impediu de te fazer mal, se não tivesses vindo tão depressa ao meu encontro, nada teria ficado de Nabal até amanhã cedo, nem mesmo o último homem!
35 Den David kollect di gifts kon tell Abigail, “Make yu go back to yor house in peace. Bilive sey I don hear wetin yu tok and nor-tin go happen to una.”
35 Davi aceitou o que lhe trazia Abigail e ajuntou: Volta em paz para a tua casa. Vê que te ouvi e te fiz boa acolhida.
36 Wen Abigail go back go meet Nabal, e dey do party for en house like king. Nabal dey enjoy ensef and e don drink well-well. Abigail nor tok anytin until di next day.
36 Quando Abigail chegou à casa de Nabal, havia em sua casa um grande banquete, um verdadeiro festim de rei. Nabal tinha o coração alegre e estava completamente ébrio. Por isso nada lhe disse, nem pouco nem muito, até ao amanhecer.
37 Wen day break wen Nabal eye neva klear well-well, en wife kon tell am wetin happen. Na wons e get stroke and e nor fit waka again.
37 Mas pela manhã, tendo Nabal curtido o seu vinho, sua mulher contou-lhe tudo. Seu coração gelou-se no peito e ele tornou-se como uma pedra.
38 Afta like ten days, God nak Nabal and e kon die.
38 Dez dias depois Nabal, ferido pelo Senhor, morreu.
39 Wen David hear sey Nabal don die, e kon sey, “Make wi praiz God wey don fight for us, bikos of wetin Nabal do. God stop en savant to do bad and E don reward Nabal with di wiked wey e do.” Den David send pipol go meet Abigail sey make e bi en wife.
39 Tendo Davi notícia da morte de Nabal, exclamou: Bendito seja o Senhor que me fez justiça do ultraje recebido de sua mão, e impediu-me de fazer-lhe mal! O Senhor fez cair sobre sua cabeça a sua própria maldade! Depois disso Davi mandou propor a Abigail tornar-se sua mulher.
40 So David savant go meet Abigail for Karmel kon tell am, “Na David send us kom bring yu as en wife.”
40 Seus servos, chegando a Carmelo, disseram-lhe: Davi mandou-nos a ti, porque deseja tomar-te por mulher.
41 Abigail stand up, bow face groun kon sey, “Yor woman savant wey dey alone, go wosh my oga savants leg.”
41 Levantou-se então Abigail e prostrou-se com o rosto por terra, dizendo: Eis a tua serva, que será uma escrava para lavar os pés dos servos de meu Senhor.
42 Den Abigail kwik-kwik klimb donkey with five of en woman savants. E follow pipol wey David send kom kon go meet David and e kon bi en wife.
42 Levantou-se depressa, montou num jumento e, seguida de cinco moças, partiu com os enviados de Davi para tornar-se sua mulher.
43 David don already marry Ahinoam from Jezrel and di two of dem kon bi en wife.
43 Davi desposara também Aquinoã, de Jezrael, e ambas foram suas mulheres.
44 Naw, Saul don give en pikin Mikal wey bi David wife to Laish pikin, Paltiel wey kom from Gallim.
44 Quanto à sua mulher Micol, filha de Saul, este a tinha dado por esposa a Falti, de Galim, filho de Lais.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 25, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.