1 Samuel 24
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Wen Saul don porshu Filistia pipol kom back, dem kon tell am, “Si, David dey for En-Gedi desert.”
1 Quando Saul voltou da perseguição aos filisteus, foi-lhe anunciado: Davi está no deserto de Engadi.
2 So Saul take 3,000 men wey e selet from Israel kon go find David and en men for di aria wey rock dey for where goats for mountin dey stay.
2 Tomou então Saul três mil israelitas de escol e foi em busca de Davi com sua gente nos rochedos dos Cabritos Monteses.
3 E rish one place where sheep dey for di road side and rock wey whole dey inside, dey der too. Den e go inside di rock go rest. Naw, David and en men sidan for di rock back (Dem hide for der).
3 Chegando perto dos apriscos de ovelhas que havia ao longo do caminho, entrou Saul numa gruta para satisfazer suas necessidades. Ora, no fundo dessa mesma gruta se encontrava Davi com seus homens,
4 David men kon tell am, “Today na di day wey God tell yu about sey, ‘I go put yor enemy for yor hand and yu fit do am anytin wey yu like.’ ” So David kon stand up small-small go kut di korna for Saul klot.
4 os quais disseram-lhe: Eis o dia anunciado pelo Senhor, que te prometeu entregar o teu inimigo à tua discrição. Davi, arrastando-se de mansinho, cortou furtivamente a ponta do manto de Saul.
5 Leta, David mind kon dey judge am, bikos e kut Saul klot,
5 E logo depois o seu coração bateu-lhe, porque tinha ousado fazer aquilo.
6 so e kon tell en men, “Make God nor let mi do bad tin to my oga, di king wey E choose. Afta all, na God choose am.”
6 E disse aos seus homens: Deus me guarde de jamais cometer este crime, estendendo a mão contra o ungido do Senhor, meu senhor, pois ele é consagrado ao Senhor!
7 David beg en men with di words wey e tok, so dem nor kon do King Saul anytin.
7 Davi conteve os seus homens com estas palavras e impediu que agredissem Saul. O rei levantou-se, deixou a gruta e prosseguiu o seu caminho.
8 David kom out from di rock kon shaut make Saul for hear, “My oga, di king!” Wen Saul look en back, David bow face groun for am.
8 Então Davi saiu por sua vez e bradou atrás de Saul: Ó rei, meu senhor! Saul voltou-se para ver, e Davi inclinou-se, prostrando-se até a terra.
9 David tell Saul, “Wetin make yu dey listin to pipol wey sey, ‘David won kill yu?’
9 E disse ao rei: Por que dás ouvidos aos que te dizem: Davi procura fazer-te mal?
10 Yu yorsef go know sey today God don put yu for my hand for inside di rock. Some of my men sey make I kill yu, but I sorry for yu kon sey, ‘I nor go do bad tin to my oga, bikos na God choose am.’
10 Viste hoje com os teus olhos que o Senhor te entregou a mim na gruta. {Meus homens} insistiam comigo para que te matasse, mas eu te poupei, dizendo: Não levantarei a mão contra o meu senhor, porque é o ungido do Senhor.
11 My papa, si yor klot korna for my hand. Wen I kut am komot, I nor kill yu. So make yu know and undastand sey I nor dey plan to kill or fight against yu.
11 Olha, meu pai, vê a ponta de teu manto em minha mão. Se eu cortei este pano do teu manto e não te matei, reconhece que não há perversidade nem revolta em mim. Jamais pequei contra ti, e tu procuras matar-me.
12 Make God judge between mi and yu and e go save mi from yor hand, but I nor go tosh yu with my hand.
12 Que o Senhor julgue entre mim e ti! O Senhor me vingará de ti, mas eu não levantarei minha mão contra ti.
13 E bi like dis proverb: ‘Bad tins dey kom out from bad pipol.’ But my hand nor go tosh yu.
13 O mal vem dos malvados, como diz o provérbio; por isso não te tocará a minha mão.
14 “Na who Israel king dey look for? Na who e dey porshu? Dog wey don die or ordinary ant?
14 Afinal, contra quem saiu o rei de Israel? A quem persegues? Um cão morto! Uma pulga!
15 Make God judge di matter kon tok who dey rite and wrong. Make e kom defend and save mi from yu!”
15 Pois bem! O Senhor julgará e pronunciará entre mim e ti. Que ele olhe e defenda a minha causa, fazendo-me justiça contra ti!
16 Wen David don tok finish, Saul kon sey, “David, My pikin! Na yor vois bi dat?” Den Saul kry well-well.
16 Acabando Davi de falar, Saul disse-lhe: É esta a tua voz, ó meu filho Davi? E pôs-se a chorar.
17 E kon tell David, “Yu betta pass mi, bikos since I know yu, yu dey good to mi, even doh I dey try to kill yu.
17 Tu és mais justo do que eu, replicou ele; fizeste-me bem pelo mal que te fiz.
18 Yu don show mi today how yu good rish, bikos yu nor gri kill mi, even doh God put mi for yor hand.
18 Provaste hoje a tua bondade para comigo, pois o Senhor tinha-me entregue a ti e não me mataste.
19 If pesin katch en enemy, e dey tell am make e go without sey e wound am? Today! Make God reward yu with good, bikos of wetin yu do to mi.
19 Qual é o homem que, encontrando o seu inimigo, o deixa ir embora tranqüilamente? Que o Senhor te recompense o que hoje me deste!
20 Si naw, I don know sey na yu really go bi king and yu go build Israel kingdom with yor hand.
20 Agora eu sei que serás rei, e que nas tuas mãos será firmada a realeza.
21 So naw, make yu use God name take swear sey yu nor go kill mi, my shidren or shidren-shidren or distroy my name from my papa house.”
21 Jura-me pelo Senhor que não eliminarás a minha posteridade, nem apagarás o meu nome da casa de meu pai.
22 David kon promise Saul. Den Saul kon go en house and David and en men kon go where dem go for dey save.
22 Davi jurou-lho. Depois disso, Saul voltou para a sua casa e Davi com a sua gente voltaram ao seu refúgio.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.