1 Samuel 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Dem kon tell David, “Filistia pipol dey fight for Keilah and dem dey karry dia tins go.”
1 Disseram a Davi: Os filisteus estão atacando Ceila e pilhando as eiras.
2 So David ask God, “Make I go kill all dis Filistia pipol?”
2 Davi consultou o Senhor: Devo ferir os filisteus? O Senhor respondeu: Vai; tu os ferirás e libertarás Ceila.
3 But David men kon tell am, “Wi still dey fear as wi dey here for Judah! How e go kom bi if wi go fight Filistia sojas for Keilah?”
3 Os homens de Davi, porém, disseram-lhe: Mesmo aqui em Judá estamos cheios de medo; quanto mais se formos a Ceila contra as tropas dos filisteus?
4 So David ask God again. But God tell am again sey, “Make yu go save Keilah pipol. Bikos I don put Filistia pipol for yor hand.”
4 Davi consultou novamente o Senhor, que lhe respondeu: Vai; desce a Ceila, porque entrego os filisteus nas tuas mãos.
5 So David and en men kon go Keilah go fight Filistia pipol. E karry dia animals kon kill dem well-well. Na so David take save Keilah pipol.
5 Davi foi para Ceila com os seus homens e atacou os filisteus, tomando-lhes o gado e infligindo-lhes uma grande derrota. Assim libertou os habitantes de Ceila.
6 Naw, wen Ahimelek son, Abiatar don run go meet David for Keilah, e karry one efod follow body.
6 {Ora, quando Abiatar, filho de Aquimelec, fugira para junto de Davi a Ceila, levava consigo o efod.}
7 Wen dem tell Saul sey David dey Keilah, Saul kon sey, “Today, God don put David for my hand, bikos e don put ensef for tight korna wen e enter town wey get only two gate and big-big iron.”
7 Saul foi informado de que Davi se encontrava em Ceila, e disse: Deus entregou-o nas minhas mãos, pois foi encerrar-se em uma cidade com portas e ferrolhos.
8 So Saul gada all en sojas, so dat dem go-go katch David and en men for Keilah.
8 O rei convocou todo o povo às armas para descer a Ceila e sitiar Davi com sua tropa.
9 Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.”
9 Mas Davi, sabendo que Saul maquinava perdê-lo, disse ao sacerdote Abiatar: Traze o efod!
10 Den David sey, “My Oga wey bi Israel God, yor savant don hear sey Saul dey plan to kom distroy di town bikos of mi.
10 E ajuntou: Senhor, Deus de Israel, vosso servo sabe que Saul pretende penetrar em Ceila para destruir a cidade por causa de mim.
11 Di leaders for Keilah go put mi for en hand? Saul go kom as dem tell mi yor savant? My Oga wey bi Israel God, abeg make Yu tell mi.”
11 Será que os habitantes de Ceila me entregarão nas suas mãos? Saul descerá como o vosso servo ouviu dizer? Senhor, Deus de Israel, fazei-o saber ao vosso servo. O Senhor respondeu: Ele descerá.
12 David kon ask, “Keilah leaders go give mi and my men to Saul?” God sey, “Dem go give una to am.”
12 E Davi ajuntou: Os habitantes de Ceila entregar-me-ão a mim e a meus homens, nas mãos de Saul? O Senhor respondeu: Entregarão.
13 So David and en six hundred men kon run komot Keilah; dem kon dey go from one place to anoda. Wen dem tell Saul sey David don run komot Keilah, e nor kon go der again.
13 Então Davi partiu precipitadamente com a sua tropa, em número de aproximadamente seiscentos homens, e saíram de Ceila, marchando ao acaso. Saul, informado de que Davi deixara Ceila, renunciou à expedição.
14 David kon hide for di hill near Zif desert. Saul dey find David, but God nor let am katch am.
14 Davi permaneceu no deserto, em lugares bem protegidos, e habitou no monte do deserto de Zif. Saul procurava-o sem cessar; mas Deus não o entregou nas suas mãos.
15 David know sey Saul dey find am bikos e won kill-am, so e go stay Horesh for Zif desert.
15 Davi, sabendo que Saul tinha saído para tirar-lhe a vida, ficou no deserto de Zif, em Horcha.
16 Den Saul pikin Jonatan go meet David for Horesh kon tell am, “God go always guide yu.”
16 Então Jônatas, filho de Saul, foi ter com ele em Horcha. E confortou-o em Deus, dizendo:
17 E tell am, “Make yu nor fear, bikos my papa hand nor go fit tosh yu at-all. Yu go rule Israel and I go dey by yor side. Even my papa know sey na so e go bi.”
17 Não temas, porque não te atingirá a mão de meu pai. Tu reinarás sobre Israel, e eu serei o teu segundo; meu pai bem o sabe.
18 Wen di two of dem don make kovenant for God present, David stay for Horesh, but Jonatan kon go house back.
18 Fizeram ambos aliança diante do Senhor. Davi ficou em Horcha e Jônatas voltou para a sua casa.
19 Den Zif pipol go tell Saul for Gibeah sey, “David dey hide for Horesh near Hakilah Hill wey dey Jeshimon sout.”
19 Alguns zifeus subiram a ter com Saul em Gabaa, e disseram-lhe: Davi está escondido entre nós no fortim de Horcha, na colina de Haquila, à direita do deserto.
20 Di pipol still sey, “Awa king, wi know how yu really one katch David; so make yu kom awa aria and wi go make sure sey yu katch am.”
20 Desce, pois, ó rei, já que tanto o desejas, e nós nos encarregamos de entregá-lo nas tuas mãos.
21 Saul ansa, “Make God bless una, bikos una don sorry for mi.
21 Que o Senhor vos abençoe, respondeu Saul, porque vos compadecestes de mim.
22 Make una go make betta plan and know where e really dey and di pesin wey si am. Bikos dem tell mi sey e get sense well-well.
22 Ide, informai-vos diligentemente, e procurai saber o lugar onde ele se encontra, ou se alguém o viu, porque me foi dito que ele é muito astuto!
23 Make una take time find di real place wey e dey, den kon tell mi. Den I go follow una go. If e dey di land, I go find am among doz wey dey Judah.”
23 Explorai e descobri todos os seus esconderijos, e voltai a mim com notícias seguras, a fim de eu ir convosco, pois se ele estiver na terra, eu o descobrirei entre a multidão de Judá.
24 So dem leave Saul kon go back to Zif. Naw, David and en men dey inside Maon desert for Arabah wey dey Jeshimon sout.
24 Partiram antes de Saul para Zif; mas Davi e os seus estavam já no deserto de Maon, na planície ao sul do deserto.
25 Saul and en men kon go look for David. But dem tell David, so e kon go stay di rock for Maon desert. Wen Saul hear sey e dey der, e kon porshu David go Maon desert.
25 Saul partiu com seus homens à sua procura. Mas Davi, informado disso, desceu à Rocha e permaneceu no deserto de Maon. Saul o soube e foi persegui-lo ali.
26 Saul pass one side for di mountin, while David and en men pass anoda side for di mountin. David dey hurry, so dat Saul nor go katch am, but Saul and en men don surround David and en men well-well.
26 Saul ia por um flanco da montanha, e Davi com os seus pelo outro, em fuga precipitada para escapar de Saul. No momento, porém, em que Saul com seus homens iam apoderar-se de Davi e sua gente,
27 But one pesin run kon tell Saul, “Make yu kwik-kwik kom, bikos Filistia pipol don dey skata di land!”
27 veio um mensageiro anunciar ao rei: Vem depressa; os filisteus entraram na terra.
28 So Saul stop to porshu David and e kon go fight Filistia pipol. So dem kon dey koll dat place Sela Hammahlekot.
28 Saul abandonou a perseguição e foi combater os filisteus. Por isso, àquele lugar foi dado o nome de Rocha da Separação.
29 Den, David komot der kon go stay where strong pass for En-Gedi.
29 Subindo dali, veio Davi habitar nas alturas de Engadi.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.