1 Samuel 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”
1 Então Davi fugiu da casa dos profetas , em Ramá, foi até o lugar onde Jônatas estava e disse: — O que foi que eu fiz? Qual foi o meu crime? Que mal fiz eu ao seu pai, para ele querer me matar?
2 Jonatan ansa am, “Nor-tin go fit kill yu! My papa nor go fit do anytin escept e tell mi first. Wetin make my papa nor gri tell mi about dis matter? E nor go fit happen!”
2 Jônatas respondeu: — Que Deus não permita que você morra! O meu pai me conta tudo o que faz, seja importante ou não. Ele não esconderia isso de mim. Isso não é bem assim!
3 But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”
3 Mas Davi respondeu: — O seu pai sabe muito bem o quanto você gosta de mim. Por isso, resolveu não deixar que você fique sabendo dos planos dele, para você não sofrer muito. Eu juro pela sua vida e pela vida de Deus, o
4 Jonatan ansa David, “Tell mi wetin yu wont make I do for yu.”
4 — O que você quer que eu faça? — perguntou Jônatas.
5 David ansa, “Tumoro na new moon and I suppose dey with di king for evening food. I go-go hide for di field for like three evening.
5 Davi respondeu: — Amanhã é a
6 If yor papa notis sey I nor dey di tabol, make yu tell am sey, ‘I beg yu make I go Betlehem, bikos di time wey di whole family dey sakrifice evry year, don rish.’
6 Se o seu pai notar que eu não estou à mesa, diga que eu pedi a você para me deixar ir com urgência a Belém, pois está na época de toda a minha família oferecer lá o sacrifício anual.
7 If yor papa kon sey, ‘No wahala,’ den make yu know sey I dey save. But if e vex, make yu know sey e won kill mi.
7 Se ele disser: “Está bem”, eu estarei salvo. Mas, se ele ficar com raiva, então você ficará sabendo que ele está com más intenções.
8 Abeg, make yu do dis favor for mi, bikos yu don promise yor savant with God name. If I do wrong, na yu go kill mi my yorsef! Wetin go make yu take mi go meet yor papa?”
8 Peço que você me faça este favor e cumpra assim a promessa sagrada que me fez. Porém, se eu sou culpado, mate-me você mesmo! Por que deixar o seu pai fazer isso?
9 Jonatan kon ansa, “Make yu nor even tink like dat! If to sey I know since sey my papa won kill yu, nor bi mi go first tell yu about am?”
9 — Nem pense numa coisa dessas! — respondeu Jônatas. — Se eu soubesse que o meu pai estava mesmo resolvido a acabar com você, acha que eu não o avisaria?
10 David kon tell Jonatan, “Who go kom tell mi if yor papa nor ansa yu well?”
10 Então Davi perguntou: — E, se o seu pai responder com raiva, quem vai me avisar?
11 Jonatan ansa David, “Kom make wi go di field.”
11 Jônatas respondeu: — Venha comigo, vamos até o campo. Eles foram,
12 Jonatan tell David, “Di Oga wey bi Israel God na my witness. I go tell my papa dis tin for di day afta tumoro. If wetin e tok favor David, I nor go send word kon give yu?
12 e Jônatas disse a Davi: — Que o
13 But if really sey my papa get mind to kill yu, make God do all dis tin and many more to Jonatan if I nor kon tell yu, so dat yu go run go hide. Make God dey with yu, as E bin dey with my papa.
13 Mas, se ele tiver a intenção de fazer alguma coisa contra você, que o Senhor Deus me mate se eu não enviar uma mensagem a você e não deixá-lo ir embora são e salvo! Que o Senhor esteja com você, assim como esteve com o meu pai!
14 As long as I dey, make yu keep yor promise to mi, but if I die,
14 E agora, se eu continuar vivo, cumpra a sua promessa sagrada e seja fiel a mim. Mas, se eu morrer,
15 make yu show di same love wey yu get for mi to my family forever. Wen God don kill all yor enemies finish,
15 trate sempre a minha família com bondade. E, quando o Senhor destruir completamente todos os nossos inimigos,
16 make awa promise to each oda nor break. If e break, God go ponish yu.”
16 que nós não quebremos a promessa que fizemos um ao outro. Se você a quebrar, Deus o castigará.
17 Jonatan still swear again with David, bikos e love am. Jonatan love David as e love en own life.
17 Novamente Jônatas fez um juramento de amizade a Davi, pois ele amava Davi como a si mesmo.
18 Jonatan tell David, “Tumoro na new moon and I go miss yu, bikos yor seat go dey empty.
18 E disse a Davi: — Amanhã é a Festa da Lua Nova, e, se você não estiver lá, a sua falta será notada.
19 For di third day, yu go-go stay for di place where yu first hide put wen all dis tins start. Make yu stay near Ezel Stone.
19 Depois de amanhã a sua falta será notada ainda mais. Assim vá para o lugar onde você se escondeu da outra vez e fique atrás do monte de pedras que há ali.
20 I go shot three arrow near am like sey I dey target sometin.
20 Então eu atirarei três flechas, como se o monte de pedras fosse um alvo.
21 I go send one boy sey, ‘Go find di arrow.’ If I tell di boy sey, ‘Si, di arrow dem dey dis side, go find dem,’ den make yu kom. Bikos as long as God dey alive, yu go dey save from all di wahala.
21 Aí direi ao meu empregado para ir buscá-las. Se eu disser a ele: “Olhe, as flechas estão para cá de você, pegue-as” — isso quer dizer que tudo está bem, e você pode sair. Eu juro por Deus, o Senhor , que nesse caso você não estará em perigo.
22 But if I tell di boy, ‘Si, di arrow dem dey di oda side’, den make yu run go. Dat mean sey God don sey make yu run.
22 Mas, se disser a ele: “As flechas estão mais para lá de você” — então fuja, pois o Senhor estará mandando que você vá.
23 Koncerning di tin wey mi and yu tok, God na awa witness forever!”
23 Quanto à promessa que fizemos um ao outro, o Senhor Deus nos ajudará a cumpri-la para sempre.
24 So David kon hide for di field. Wen di new moon kom out, di king kon sidan to chop en food.
24 Então Davi se escondeu no campo. O rei Saul chegou para a Festa da Lua Nova
25 Di king sidan for where e dey sidan before near di wall, den Jonatan sidan face am and Abner sidan for en side. But David chair dey empty.
25 e sentou-se para comer no lugar de costume, perto da parede. Abner sentou-se ao lado de Saul, e Jônatas, na sua frente. Mas o lugar de Davi ficou vazio.
26 Dat day, Saul nor tok anytin about am, bikos e tink sey sometin don happen wey make David nor dey okay to kom chop di food.
26 Naquele dia Saul não disse nada porque pensou: “Deve ter acontecido alguma coisa com ele, e de certo ele não passou pela cerimônia de purificação .”
27 But di next morning for di sekond day for di new moon, David seat still dey empty. So Saul kon tell en pikin Jonatan, “Wetin make Jesse pikin neva kom chop for dis tabol? E nor kom yestiday and e nor dey here today.”
27 No dia seguinte, o segundo dia da Festa da Lua Nova, o lugar de Davi continuava desocupado. Aí Saul perguntou a Jônatas: — Por que Davi não veio comer nem ontem nem hoje?
28 Jonatan ansa en papa, “David ask mi make I let am go Betlehem.
28 Jônatas respondeu: — Ele me pediu licença para ir a Belém.
29 E sey, ‘Abeg, make yu let mi go, bikos wi get family sakrifice for di town and my brodas sey make I dey der. So if yu bi my friend, make yu let mi go.’ Na dis make am nor dey di king tabol.”
29 Ele me disse: “Deixe-me ir a Belém porque a minha família está lá fazendo a festa do sacrifício, e o meu irmão mandou que eu também fosse. Se você é meu amigo, deixe que eu vá ver os meus parentes.” E Jônatas continuou: — É por isso que ele não está no seu lugar, à mesa.
30 Saul vex well-well with Jonatan den e kon tell am, “Yu nor get papa! Na naw I know sey yu dey support David and yu dey disgrace yorsef and yor mama!
30 Então Saul ficou muito zangado com Jônatas e disse: — Seu filho de uma mulher à toa! Agora eu sei que você passou para o lado de Davi, trazendo desonra para você e para a sua mãe!
31 Yu nor know sey as long as David dey alive, yu nor go ever bi king for Israel? Naw, make yu go bring am kom here, bikos e must die!”
31 Enquanto Davi for vivo, você não será rei deste país. Vá agora e traga-o aqui porque é preciso que ele morra!
32 Jonatan kon ask en papa, “Wetin go make am die? Wetin e do wey go make dem kill-am?”
32 — Por que é que ele deve morrer? — perguntou Jônatas. — O que foi que ele fez?
33 Den Saul trow en spear face Jonatan, so dat e go pin am for groun. Den Jonatan kon know sey en papa won kill David.
33 Então Saul atirou a sua lança contra Jônatas para matá-lo. E assim Jônatas compreendeu que o seu pai estava mesmo resolvido a matar Davi.
34 Jonatan stand up from di tabol with vexnashon and dat day, e nor chop anytin, bikos e dey vex sey en papa won kill David.
34 Jônatas levantou-se furioso da mesa e não comeu nada naquele dia, o segundo dia da Festa da Lua Nova. Ele estava muito sentido porque Saul tinha insultado Davi.
35 Di next morning, Jonatan with en boy savant kon go di field go meet David.
35 Na manhã seguinte ele foi ao campo a fim de encontrar Davi, como tinham combinado. Levou consigo um rapazinho
36 E kon tell en savant, “Make yu run go find di arrow wey I won shot so.” As di savant dey run, Jonatan shot di arrow pass am.
36 e disse: — Corra e vá buscar as flechas que eu atirar. O rapaz correu, e Jônatas atirou uma flecha que passou além dele.
37 Wen di savant rish di place where di arrow for land, Jonatan kon shaut koll am sey, “Di arrow still dey yor front?”
37 Quando o rapaz chegou ao lugar onde a flecha tinha caído, Jônatas gritou: — A flecha caiu mais para lá de você!
38 Jonatan koll di savant, “Make yu kwik! Run go kwik-kwik! Nor stop!” Jonatan savant take di arrow kon kom back kom meet en oga.
38 Não fique aí parado! Ande logo! O rapaz pegou as flechas e voltou para perto do seu patrão,
39 Di savant nor undastand wetin dey happen. Na only Jonatan and David know wetin dey happen.
39 não sabendo o que queria dizer tudo aquilo — somente Jônatas e Davi sabiam.
40 Den Jonatan karry en swod bag give di boy wey dey with am. E kon tell am, “Make yu dey go, karry dis tins go back to di town.”
40 Aí Jônatas entregou as suas armas ao rapaz e mandou que as levasse de volta para a cidade.
41 Wen di savant don go, David stand kom out from where e hide put near di stone, e knee down kon bow three times. Den dem kiss each oda kon bigin kry, but na David kry pass.
41 Depois que o rapaz foi embora, Davi saiu de trás do monte de pedras, jogou-se no chão e encostou o rosto na terra três vezes. Então eles se beijaram chorando. E a tristeza de Davi era maior do que a de Jônatas.
42 Jonatan kon tell David, “Make yu go well, bikos di two of us don use God name take swear sey, ‘God go dey with mi and yu and even awa shidren-shidren forever.’ ” Den David get up kon run go, while Jonatan go back to di town.
42 Aí Jônatas disse a Davi: — Deus esteja com você! O Então Davi partiu, e Jônatas voltou para a cidade.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.