1 Samuel 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 E get one man wey kom from Ramataim Zofim for Efraim kountry wey dey on-top hill and en name na Elkanah. Elkanah papa name na Jeroham. Elihu wey bi Tohu pikin, na-im born Jeroham and na Zuf wey kom from Efraim tribe, bi Tohu papa.
1 Houve um homem de Ramataim-Zofim, da região montanhosa de Efraim, cujo nome era Elcana, filho de Jeroão, filho de Eliú, filho de Toú, filho de Zufe, efraimita.
2 Elkanah get two wife; di first one name na Hannah, while di sekond one na Peninnah. Peninnah get shidren, but Hannah nor get.
2 Elcana tinha duas mulheres: uma se chamava Ana, e a outra se chamava Penina. Penina tinha filhos; Ana, porém, não tinha.
3 Evry year, Elkanah dey from en town go woship and sakrifice to God for Shiloh. Na der, Eli two pikin (Hofni and Finehas) dey for serve God as priest.
3 Todos os anos esse homem ia da sua cidade para adorar e sacrificar ao Senhor dos Exércitos, em Siló, onde Hofni e Fineias, os dois filhos de Eli, eram sacerdotes do Senhor .
4 Wen ever e rish Elkanah turn to woship God, e dey give meat to en wife Peninnah and all en shidren.
4 No dia em que Elcana oferecia o seu sacrifício, ele dava porções deste a Penina, sua mulher, e a todos os seus filhos e filhas.
5 But e dey give Hannah doubol part, bikos e love am well-well, but God neva give Hannah pikin.
5 A Ana, porém, dava uma porção dobrada, porque ele a amava, mesmo que o Senhor a tivesse deixado estéril.
6 Peninnah dey always laf and make yanga for Hannah, bikos God neva give Hannah shidren.
6 Penina, sua rival, a provocava excessivamente para a irritar, porque o Senhor a tinha deixado sem filhos.
7 Peninnah dey always bihave like dis evry years. Anytime wey Hannah go God house, Peninnah go laf and curse am, so Hannah go dey kry and e nor go gri chop.
7 Isso acontecia ano após ano. Todas as vezes que Ana ia à Casa do Senhor , a outra a irritava. Por isso Ana se punha a chorar e não comia nada.
8 One day, Elkanah kon ask Hannah, “Wetin make yu dey kry and nor gri chop? Why yu dey vex? I nor dey good for yu pass ten boy pikin?”
8 Então Elcana, seu marido, lhe disse: — Ana, por que você está chorando? E por que não quer comer? E por que está tão triste? Será que eu não sou melhor para você do que dez filhos?
9 So one day wen dem go Shiloh, afta dem don chop and drink finish, Hannah stand up kon go pray. (Dat time Eli wey bi priest sidan for en chair wey dey God Temple door-mot.)
9 Certa vez após terem comido e bebido em Siló, Ana se levantou, quando o sacerdote Eli estava sentado na sua cadeira, junto a um pilar do templo do Senhor .
10 Hannah nor dey happy as e dey pray give God, so e kon dey kry.
10 E Ana, com amargura de alma, orou ao Senhor e chorou muito.
11 So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”
11 Ela fez um voto, dizendo: —
12 As Hannah still dey pray give God, Eli kon dey look en mout.
12 Ana continuava a orar diante do Senhor , e o sacerdote Eli começou a observar o movimento dos lábios dela,
13 Naw, Hannah dey pray from en heart. Aldo en lips dey move, but dem nor dey hear en vois. So Eli kon feel sey Hannah don drink well-well.
13 porque Ana só falava em seu coração. Os seus lábios se moviam, porém não se ouvia voz nenhuma. Por isso Eli pensou que ela estava embriagada
14 So e tell am, “Why yu drink kom here? Make yu nor dey drink again!”
14 e lhe disse: — Até quando você vai ficar embriagada? Trate de ficar longe do vinho!
15 But Hannah ansa, “My oga! Nor bi as yu tink am! My mind nor setol at-all. I nor drink as yu dey tink o-o. I just dey tell God evritin wey dey my heart.
15 Porém Ana respondeu: — Não, meu senhor! Eu sou uma mulher angustiada de espírito. Não bebi vinho nem bebida forte. Apenas estava derramando a minha alma diante do
16 Nor tink sey yor savant dey wiked, bikos I just dey pray since bikos my heart dey heavy.”
16 Não pense que esta sua serva é ímpia. Eu estava orando assim até agora porque é grande a minha ansiedade e a minha aflição.
17 Eli kon ansa, “Make yu go! Make peace follow yu and make Israel God give yu wetin yu wont.”
17 Então Eli disse: — Vá em paz, e que o Deus de Israel lhe conceda o que você pediu.
18 So, Hannah kon sey, “Make mi, yor savant get favor for yor eyes.” So di woman go find wetin e go chop and e kon dey happy.
18 Ana respondeu: — Que eu possa encontrar favor aos seus olhos. Então ela seguiu o seu caminho, comeu alguma coisa, e o seu semblante já não era triste.
19 Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.
19 Eles se levantaram de madrugada e adoraram diante do Senhor . Depois, voltaram para casa, em Ramá. Elcana teve relações com Ana, sua mulher, e o Senhor se lembrou dela.
20 Afta sometaim, Hannah get belle kon born boy. Den Hannah koll am, Samuel, bikos e sey, “I ask God make E gi-am to mi.”
20 Ana ficou grávida e, passado o devido tempo, teve um filho, a quem deu o nome de Samuel, pois dizia: — Do
21 Di next year, Elkanah and en family kon go sakrifice give God again and dem gi-am di vow wey dem make,
21 Elcana, seu marido, foi com toda a sua casa para oferecer ao Senhor o sacrifício anual e para cumprir o seu voto.
22 but Hannah nor go. Instead, e tell en husband, “Wen di boy don big small, I go bring am to God kon gi-am to am forever.”
22 Ana, porém, não foi. Ela disse a seu marido: — Quando o menino for desmamado, eu o levarei para ser apresentado ao
23 So, Elkanah sey, “Make yu do wetin dey yor mind. Stay with di boy until e fit stay alone. Make God komplete wetin E don start.”
23 Elcana, seu marido, respondeu: — Faça o que achar melhor. Fique aqui até desmamá-lo. E que o Assim, Ana ficou em casa e amamentou o filho, até que o desmamou.
24 So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.
24 Depois de o ter desmamado, ela o levou consigo, com um novilho de três anos, uma medida de farinha e um odre de vinho, e o apresentou à Casa do Senhor , em Siló. O menino ainda era muito pequeno.
25 Afta dem don kill di melu, dem kon take di boy go give Eli.
25 Depois de terem sacrificado o novilho, levaram o menino a Eli.
26 Hannah kon sey, “Oga, yu remember mi so? Na mi bi di woman wey yu si stand for here dey pray give God.
26 E Ana disse: — Ah! Meu senhor, tão certo como você vive, eu sou aquela mulher que esteve aqui ao seu lado, orando ao
27 I ask am for pikin and E don give mi wetin I wont.
27 Era por este menino que eu orava, e o Senhor Deus me concedeu o pedido que eu fiz.
28 Naw, I don gi-am to God. From today go, I dey dedikate am give God.” Den, dem kon woship God for der.
28 Por isso também o entrego ao Senhor . Por todos os dias que viver, será dedicado ao Senhor . E ali eles adoraram o

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.