1 Samuel 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Den Saul tell en pikin Jonatan and all en savants sey make dem kill David. But Saul pikin Jonatan like David well-well.
1 Saul falou ao seu filho Jônatas e a todos os servos, ordenando-lhes que matassem Davi. Mas Jônatas, que tinha grande afeição por Davi,
2 So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.
2 preveniu-o disso: Saul, meu pai, procura matar-te. Está de sobreaviso amanhã cedo; esconde-te.
3 I go-go meet my papa for di field where yu dey kon ask about yu. Wen e tell mi di problem, I go kom tell yu.”
3 Sairei em companhia de meu pai ao campo onde estiveres. Falar-lhe-ei de ti, para ver o que ele diz, e te avisarei depois.
4 So Jonatan tok to en papa about David, “Make di king nor sin against en savant David, bikos e neva sin against di king. To tink am sef, David don really help di king.
4 Jônatas falou bem de Davi ao seu pai, e ajuntou: Que o rei não faça mal algum ao seu servo Davi, pois que ele nunca te fez mal algum. Ao contrário, prestou-te grandes serviços.
5 E risk en life wen e fight and kill Filistia pipol. God win big viktory for Israel pipol. Wen yu si and hear am, yu yorsef kon dey happy. So wetin go make yu won sin against pesin wey nor do any bad tin? Wetin go make yu won kill David yor savant for no rizin?”
5 Arriscou a sua vida para matar o filisteu, e o Senhor deu uma grande vitória a Israel. Foste testemunha disso e te alegraste. Por que queres pecar contra o sangue inocente, matando Davi sem motivo?
6 Saul gri with en pikin Jonatan kon swear sey, “As long as God dey alive, nobody go kill David.”
6 Saul ouviu a voz de Jônatas, e fez este juramento: Pela vida do Senhor, Davi não morrerá!
7 Den Jonatan bring David kon meet Saul and di boy kon dey serve am as e dey do before.
7 Então Jônatas chamou Davi e contou-lhe tudo isso. Levou-o em seguida a Saul, para que ele retomasse o seu lugar como dantes.
8 War kon start again. So David kon go fight Filistia pipol. E win dem well-well and di remainin ones, run from am.
8 Tendo recomeçado a guerra, marchou Davi contra os filisteus, combatendo-os e infligindo-lhes uma grande derrota, e eles fugiram diante dele.
9 Den one wiked spirit from God kon enter Saul again. E sidan for en house with en spear for en hand, while David dey play di jita.
9 O mau espírito do Senhor, porém, veio novamente sobre Saul. Estava ele sentado em sua casa, com a lança na mão; Davi tocava a cítara.
10 Saul kon try to nail David for di wall with en spear, but David dodge komot from Saul front and di spear kon pin for di wall. David kwik-kwik run go hide dat nite.
10 Saul, então, arremessou-lhe a lança, procurando cravá-lo na parede; Davi desviou-se e a lança foi cravar-se na parede. Davi esquivou-se e fugiu naquela mesma noite.
11 Saul send pipol go guide David house and make dem kill-am wen day break. Den David wife, Mikal tell David, “If yu nor save yorsef dis nite, by dis time tumoro, yu go don bikom dead body!”
11 Ora, mandou o rei emissários à casa de Davi, para terem-no seguro e assassiná-lo pela manhã. Mas Micol, mulher de Davi, disse-lhe: Se não fugires esta noite, amanhã serás um homem morto.
12 So di woman help David pass thru window and e kon run.
12 Fê-lo, pois, descer pela janela, e ele fugiu são e salvo.
13 Den Mikal take one doll-baby for di house kon put am for bed. E put goat hair for di doll-baby head kon kover am with klot.
13 Micol tomou o terafim, meteu-o na cama, colocou-lhe em redor da cabeça uma cobertura de pele de cabra, e cobriu tudo com um manto.
14 Wen Saul send pipol make dem go arrest David kom, Mikal kon tell dem, “David nor well.”
14 Quando chegaram os enviados de Saul para prender Davi, ela disse-lhes: Ele está doente.
15 Den Saul send pipol go back sey, “Make una karry am kom like dat, so dat I go kill-am with my hand.”
15 Saul mandou-os de novo, com ordem de vê-lo, dizendo: Trazei-mo com sua cama, e eu o matarei.
16 Wen di pipol rish der, dem kon si only di doll-baby for di bed wey dem put goat hair for en head.
16 Tendo chegado os mensageiros, só encontraram na cama o terafim com uma cobertura de pele de cabra no lugar da cabeça.
17 So, Saul tell Mikal, “Wetin make yu deceive mi like dis kon make my enemy run? Naw, e don eskape.”
17 Saul disse a Micol: Por que me enganaste assim, deixando escapar o meu inimigo? Micol respondeu: Porque ele me disse: deixa-me partir, senão te mato!
18 Naw, David don run go hide. E run go meet Samuel for Rama kon tell am evritin wey Saul do am. Den en and Samuel kon go stay Naiot.
18 Davi fugiu, pois, e foi ocultar-se junto de Samuel, em Ramá; e contou-lhe tudo o que Saul lhe fizera. E foram ambos morar em Naiot.
19 Dem kon tell Saul sey, “David dey Naiot for Rama.”
19 Disseram a Saul: Davi está em Naiot, perto de Ramá.
20 So Saul send men go katch David kom. Wen di men si some profet dey tok wetin go happen with Samuel as dia leaders, God Spirit kon enter dem and demsef kon dey tok like di profets.
20 Saul mandou homens para prendê-lo, mas quando viram a comunidade dos profetas em delírio, tendo Samuel à sua frente, o espírito de Deus veio sobre os enviados de Saul que começaram, também eles, a profetizar.
21 Wen Saul hear wetin happen to en men, e kon send anoda set go, but di same tin happen to dem too. So e send di third set go and dem kon join di rest dey tok like di profets.
21 Contaram-no a Saul, que enviou outros mensageiros, mas também estes se puseram a cantar como os primeiros. Saul mandou um terceiro grupo, os quais também profetizaram.
22 Den Saul kon go Rama by ensef. Wen e rish di big well for Seku, e kon ask, “Where Samuel and David dey?”
22 Então ele foi pessoalmente a Ramá. Chegando à grande cisterna de Soco, perguntou: Onde estão Samuel e Davi? Estão em Naiot, responderam-lhe, perto de Ramá.
23 So Saul go Naiot for Rama. God Spirit kon enter en body and e kon bigin tok wetin go happen as e dey waka till e rish Naiot for Rama.
23 Mas, no caminho para Naiot, assaltou-o também o espírito de Deus, e Saul foi tomado de transes por todo o caminho até chegar a Naiot.
24 E even tear en klot komot from en body kon dey tell Samuel wetin go happen. E sleep naked for der from morning till di next day. Na dis tin make pipol dey ask weda, “Saul sef don bi profet?”
24 Despiu suas vestes, profetizando diante de Samuel e ficou assim despido, prostrado por terra durante todo o dia e toda a noite. Daí o ditado: Está Saul também entre os profetas?
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.