1 Samuel 18

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef.
1 Depois dessa conversa de Davi com Saul, surgiu tão grande amizade entre Jônatas e Davi que Jônatas tornou-se o seu melhor amigo.
2 Dat day, Saul take David and e nor let am go house go meet en papa.
2 Daquele dia em diante, Saul manteve Davi consigo e não o deixou voltar à casa de seu pai.
3 Jonatan kon make kovenant with David, bikos e love am as e love en own life.
3 E Jônatas fez um acordo de amizade com Davi, pois se tornara o melhor amigo de Davi.
4 Jonatan remove di gown wey e wear kon gi-am to David, plus en gear, en swod, en bow and even en belt.
4 Jônatas tirou o manto que estava vestindo e deu-o a Davi, junto com sua túnica, e até sua espada, seu arco e seu cinturão.
5 Anytin wey Saul send David go do, e dey do am well with sense. So Saul kon make am oga ova di sojas. Dis tin kon make belle sweet di sojas and even Saul savants.
5 Tudo que Saul lhe ordenava fazer, Davi fazia com tanta habilidade que Saul lhe deu um posto elevado no exército. Isto agradou a todo o povo, bem como aos conselheiros de Saul.
6 Wen dem kom back afta David don kill Filistia pipol, di wimen for di town kom out kon dey sing, dey dance go meet King Saul. Dem dey happy as dem dey play dia instruments dey kom.
6 Quando os soldados voltavam para casa, depois de Davi ter matado o filisteu, as mulheres saíram de todas as cidades de Israel ao encontro do rei Saul com cânticos e danças, com tamborins, com músicas alegres e instrumentos de três cordas.
7 Di wimen wey dey play di music kon dey sing sey,
7 Enquanto dançavam, as mulheres cantavam: "Saul matou milhares, e Davi, dezenas de milhares".
8 Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?”
8 Saul ficou muito irritado, com esse refrão e, aborrecido disse: "Atribuíram a Davi dezenas de milhares, mas a mim apenas milhares. O que mais lhe falta senão o reino? "
9 So Saul kon dey look David one kind from dat day go.
9 Daí em diante Saul olhava com inveja para Davi.
10 Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand,
10 No dia seguinte, um espírito maligno mandado por Deus apoderou-se de Saul e ele entrou em transe profético em sua casa, enquanto Davi tocava harpa, como costumava fazer. Saul estava com uma lança na mão
11 den Saul trow di spear, bikos e tink for en mind sey, “I go nail David for di wall!” But David dodge am two difren times.
11 e a atirou, dizendo: "Encravarei Davi na parede". Mas Davi desviou-se duas vezes.
12 So Saul kon dey fear David, bikos God Spirit wey don komot from am, dey with David.
12 Saul tinha medo de Davi porque o Senhor o havia abandonado e agora estava com Davi.
13 Saul sey make David komot en present, but e still make am di sojas oga. David dey karry di sojas go war and bring dem back.
13 Então afastou Davi de sua presença e deu-lhe o comando de uma tropa de mil soldados, e Davi a conduzia em suas campanhas.
14 David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.
14 Ele tinha êxito em tudo o que fazia, pois o Senhor estava com ele.
15 Wen Saul si as David wise rish, e kon dey fear am.
15 Quando Saul como ele tinha habilidade, teve muito medo dele.
16 But evribody for Israel and Judah like David, bikos na en dey take dem go war and bring dem back.
16 Todo Israel e Judá, porém, gostava de Davi, pois ele os conduzia em suas batalhas.
17 Den Saul tell David, “Na my senior girl bi dis, en name na Merab. I wont make yu marry am. I just wont make yu dey strong for mi and fight God war.” Bikos Saul tink sey, “No nid for mi to kill-am, make Filistia pipol kill-am!”
17 Saul disse a Davi: "Aqui está a minha filha mais velha, Merabe. Eu a darei em casamento a você; apenas sirva-me com bravura e lute as batalhas do Senhor". Pois Saul pensou: "Não o matarei. Deixo isso para os filisteus! "
18 David kon tell Saul, “Who I bi? Who bi my family or my papa tribe for Israel wen I go kom bi di king in-law?”
18 Mas Davi disse a Saul: "Quem sou eu, e o que é minha família ou o clã de meu pai em Israel para que eu me torne genro do rei? "
19 Wen di time rish wen dem won give Saul pikin, Merab to David, dem kon give di girl to Adriel wey kom from Meholah.
19 Por isso, quando chegou a época de Merabe, a filha de Saul, ser dada em casamento a Davi, ela foi dada a Adriel, de Meolá.
20 Mikal wey bi Saul pikin, like David. Wen dem tell Saul wetin dey happen, en belle kon sweet am.
20 Mical, a outra filha de Saul, gostava de Davi. Quando disseram isto a Saul, ele ficou contente e pensou:
21 Saul kon sey, “I go give Mikal to David, so dat Mikal go bi trap for am and Filistia pipol go kill-am.” So Saul tell David, “Today, na di sekond time for yu to bi my in-law.”
21 "Eu a darei a ele, para que lhe sirva de armadilha, fazendo-o cair nas mãos dos filisteus". Então Saul disse a Davi: "Hoje você tem uma segunda oportunidade de tornar-se meu genro".
22 Den Saul tell en savant, “Make yu use brain tell David for korna sey, ‘Di King dey happy with yu and all en savants like yu. So make yu marry di king pikin.’ ”
22 Então Saul ordenou aos seus conselheiros que falassem em particular com Davi, dizendo: "O rei está satisfeito com você, e todos os seus conselheiros o estimam. Torne-se, agora, seu genro".
23 So Saul savant go tell David wetin di king tell am make e do. David ansa, “Na betta honor to marry di king pikin. Di honor too mush for pesin like mi wey nor bi anytin!”
23 Quando falaram com Davi, ele disse: "Vocês acham que tornar-se genro do rei é fácil? Sou homem pobre e sem recursos".
24 Wen Saul savants tell am wetin David tok,
24 Quando os conselheiros de Saul lhe contaram o que Davi tinha dito,
25 Saul kon sey, “Dis na wetin una go tell David: ‘Di king nor wont money for di girl; di only tin wey e wont na hundred Filistia pipol skin, so dat e go pay en enemies back for di tins wey dem don kause.’ ” (Naw, Saul bilive sey David nor go survive dis one.)
25 Saul ordenou que dissessem a Davi: "O rei não quer outro preço pela noiva além de cem prepúcios de filisteus, para vingar-se de seus inimigos". O plano de Saul era que Davi fosse morto pelos filisteus.
26 So en savants tell David and David gri sey e go marry di king pikin. Naw, di time wey di king give David neva pass,
26 Quando os conselheiros falaram novamente com Davi, ele gostou da idéia de tornar-se genro do rei. Por isso, antes de terminar o prazo estipulado,
27 den David with en men go fight kon kill two hundred Filistia pipol. David take dia skin go give Saul, so dat e go fit marry di king pikin. So Saul give en pikin Mikal to David make e marry.
27 Davi e seus soldados saíram e mataram duzentos filisteus. Ele trouxe os prepúcios e apresentou-os ao rei para que se tornasse seu genro. Então Saul lhe deu em casamento sua filha Mical.
28 Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well,
28 Quando Saul viu claramente que o Senhor estava com Davi e que sua filha Mical o amava,
29 e kon dey fear David more-more and from dat day go, Saul kon hate David more-more.
29 temeu-o ainda mais e continuou seu inimigo pelo resto de sua vida.
30 Anytin time Filistia oga karry dia sojas kon fight, David dey win dem pass any oda Saul savants. Bikos of dis, pipol kon know David well-well.
30 Os comandantes filisteus continuaram saindo para a batalha, e, todas as vezes que o faziam, Davi tinha mais habilidade do que os outros oficiais de Saul, e ele tornou-se ainda mais famoso.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.