1 Samuel 17
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 Filistia pipol gada dia sojas to go fight. Dem gada for Soko wey dey Judah. Dia kamp dey for Efes-Dammim wey dey between Sokoh and Azeka.
1 Os filisteus reuniram seu exército para a batalha e acamparam em Efes-Damim, entre Socó, em Judá, e Azeca.
2 Saul and Israel men kamp for Ela Valley where dem for dey ready to go fight Filistia pipol.
2 Em resposta, Saul reuniu as tropas israelitas perto do vale de Elá.
3 Filistia pipol stand for one side, while Israel pipol dey di oda side and na di valley separate dem.
3 Assim, os filisteus e os israelitas ficaram frente a frente, em colinas opostas, com o vale entre eles.
4 Den di champion for Filistia pipol kamp kon kom out. En name na Goliat and e kom from Gat. E tall rish seven fit.
4 Então Golias, um guerreiro filisteu de Gate, saiu das fileiras do exército filisteu. Ele tinha 2,90 metros de altura,
5 E wear bronze helmet for head and e wear iron koat wey heavy rish one hundred and twenty-five pounds.
5 usava um capacete de bronze e vestia uma couraça de escamas de bronze que pesava sessenta quilos.
6 Wetin e take protet en leg na bronze and di spear wey dey en shoulder na bronze too.
6 Também usava caneleiras de bronze e carregava no ombro um dardo de bronze.
7 En spear mout tick well-well and di iron heavy rish fifteen pounds. Di pesin wey dey karry en shield, dey waka for en front.
7 A haste de sua lança era pesada e grossa, como o eixo de um tear, e a ponta de ferro da lança pesava cerca de sete quilos. Seu escudeiro caminhava à frente dele.
8 E stand kon shaut for Israel pipol, “Wetin una dey do for der? Make una kom out kon fight? I bi Filistia pesin and una na Saul savants. Make una choose one of una man make e kon fight mi.
8 Golias parou e gritou para as tropas israelitas: “Por que saíram todos para lutar? Eu sou filisteu, e vocês são servos de Saul. Escolham um homem para vir aqui e lutar comigo!
9 If e fight kon win mi, wi go bi una savants. But if I win and kill-am, una go bikom awa savant kon serve us.”
9 Se ele me matar, seremos seus escravos. Mas, se eu o matar, vocês serão nossos escravos!
10 Den e kon sey, “I dey shalenge Israel sojas today sey, ‘Make una pick one pesin, make e kon fight mi!’ ”
10 Desafio hoje os exércitos de Israel. Mandem um homem para lutar comigo!”.
11 Wen Saul and Israel pipol hear wetin di Filistia man tok, dem vex well-well and fear kon dey katch dem.
11 Quando Saul e os israelitas ouviram isso, ficaram aterrorizados e muito abalados.
12 Naw, David na one Efrat man pikin and di man kom from Betlehem for Judah and en name na Jesse. Di man get eight boys and wen Saul dey rule, di man don old well-well.
12 Davi era filho de Jessé, efrateu de Belém, na terra de Judá. Na época do rei Saul, Jessé já era idoso e tinha oito filhos.
13 Jesse three first boys don follow Saul go di war and dia names na, Eliab wey bi di first-born, sekond to Abinadab and Shammah wey bi di third.
13 Os três filhos mais velhos de Jessé — Eliabe, Abinadabe e Simeia — haviam se alistado no exército de Saul para lutar contra os filisteus.
14 Na David bi di last born among en papa sons, while di first three shidren dey follow Saul.
14 Davi era o mais novo. Seus três irmãos mais velhos seguiam o exército de Saul,
15 David dey go kom back from Saul palis, so dat e go fit take kare of en papa sheep for Betlehem.
15 enquanto Davi ia e voltava para ajudar seu pai a cuidar das ovelhas em Belém.
16 So for forty days, di Filistia man dey kom out evry morning and evening dey shaut.
16 Durante quarenta dias, pela manhã e à tarde, o guerreiro filisteu se apresentava diante do exército israelita e o desafiava.
17 So one day, Jesse kon tell David, “Make yu take dis korn wey dem roast and ten bread go give yor brodas.
17 Um dia, Jessé disse a Davi: “Leve depressa para seus irmãos que estão no acampamento este cesto com grãos tostados e estes dez pães.
18 Den give dia oga dis biscuits. Make yu find out how yor brodas dey, den kom back kon tell mi weda dem get evritin wey I dey send yu go give dem.
18 Leve também estes dez queijos para o capitão deles. Veja como estão seus irmãos e traga notícias deles”.
19 Dem dey with Saul and Israel men wey won fight Filistia pipol for Ela Valley.”
19 Os irmãos de Davi estavam com Saul e o exército israelita no vale de Elá, lutando contra os filisteus.
20 So David get up before day break kon give en papa animal to pesin make e guide dem. Afta e don pak evritin, e kon go just as Jesse tell am. E rish di kamp as di sojas dey go di war front and dem dey sing war song.
20 Davi deixou as ovelhas com outro pastor e, na manhã seguinte, partiu bem cedo com os presentes, como Jessé havia ordenado. Chegou ao acampamento quando o exército israelita saía para o campo de batalha com gritos de guerra.
21 Israel pipol and Filistia pipol stand opposite each oda and dem dey ready to fight.
21 Logo, filisteus e israelitas estavam frente a frente, exército contra exército.
22 Afta David don give wetin e karry kom to di pesin wey dey divide tins give di sojas, e kon run go di war front. Wen e rish der, e kon ask en brodas, how una dey?
22 Davi deixou suas coisas com o responsável pelos suprimentos e correu até a frente de batalha para saudar seus irmãos.
23 As e dey tok to dem, Goliat di Filistia champion wey kom from Gat kon kom out from Filistia pipol side. E tok as e always dey do and David kon hear am.
23 Enquanto falava com eles, Golias, o guerreiro filisteu de Gate, saiu das fileiras do exército filisteu. Davi o ouviu gritar seu desafio habitual.
24 Wen Israel men si Goliat, dem go hide, bikos of fear.
24 Quando os israelitas viram Golias, começaram a fugir, apavorados.
25 Di men for Israel kon sey, “Yu si dis man wey dey kom out always? E dey do like dis to shalenge all Israel. But awa king don sey, ‘Anybody wey go fit kill di man, e go gi-am money and en dota make e marry and di pesin papa house nor go dey pay tax again.’ ”
25 “Vocês viram aquele homem?”, perguntavam uns aos outros. “Ele sai todos os dias para desafiar Israel. O rei ofereceu uma grande recompensa para quem o matar. Dará uma de suas filhas como esposa e isentará toda a família dele de pagar impostos!”
26 David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”
26 Então Davi perguntou aos soldados que estavam por perto: “O que receberá o homem que matar esse filisteu e acabar com suas provocações contra Israel? Afinal de contas, quem é esse filisteu incircunciso para desafiar os exércitos do Deus vivo?”.
27 Di sojas kon tell am wetin di king promise, “Dis na wetin I go do for di man wey go kill Goliat.”
27 Os soldados repetiram o que tinham dito e confirmaram: “Sim, essa será a recompensa para quem o matar”.
28 Wen en senior broda Eliab hear am dey tok to di men, e kon vex tell David, “Wetin make yu kom der? Na who yu sey make e guide doz sheep for di desert? I know sey yu like to show yorsef! Yu just kom here to wosh di fight!”
28 Quando Eliabe, irmão mais velho de Davi, o ouviu falando com os soldados, ficou furioso e perguntou: “O que você está fazendo aqui? Não devia estar tomando conta daquelas poucas ovelhas? Conheço sua arrogância e suas más intenções. Você quer apenas ver a batalha!”.
29 David ansa am, “Wetin I don do naw? I nor go fit tok anytin again?”
29 “O que eu fiz agora?”, disse Davi. “Só fiz uma pergunta!”
30 Den, David waka komot der kon go ask anoda pesin di same kweshon, but dem gi-am di same ansa.
30 Então foi até outros soldados, fez a mesma pergunta e recebeu a mesma resposta.
31 Wen dem hear wetin David tok, dem kon tell Saul. So Saul kon koll David.
31 Alguém contou ao rei Saul o que Davi tinha dito, e o rei mandou chamá-lo.
32 David tell Saul, “Nor let anybody mind fail am. Yor savant go-go fight dis Filistia man!”
32 Davi disse a Saul: “Ninguém se preocupe por causa desse filisteu. Seu servo vai lutar contra ele”.
33 But Saul ansa David, “Yu nor go fit fight dis Filistia man, bikos e don tey wen dis man don dey fight and yu still small!”
33 Saul respondeu: “Você não conseguirá lutar contra esse filisteu e vencer! É apenas um rapaz, e ele é guerreiro desde a juventude”.
34 David ansa Saul, “Yor savant dey guide animal for en papa. Wen ever lion or bear or wild animals kon karry one sheep from di odas,
34 Davi, porém insistiu: “Tomo conta das ovelhas de meu pai e, quando um leão ou um urso aparece para levar um cordeiro do rebanho,
35 I go porshu di animal, nak am fall kon save di sheep from en mout. If e stand up won fight, I go hold en neck, nak and kill-am.
35 vou atrás dele com meu cajado e tiro o cordeiro de sua boca. Se o animal me ataca, eu o seguro pela mandíbula e dou golpes nele com o cajado até ele morrer.
36 Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”
36 Fiz isso com o leão e o urso, e farei o mesmo com esse filisteu incircunciso, pois ele desafiou os exércitos do Deus vivo!”.
37 David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!”
37 E disse ainda: “O S enhor que me livrou das garras do leão e do urso também me livrará desse filisteu!”. Por fim, Saul consentiu. “Está bem, então vá”, disse. “E que o S
38 Den Saul wear wetin e take dey fight put for David body kon put en bronze helmet for en head. E still put iron shirt for en body.
38 Então Saul deu a Davi sua própria armadura, incluindo uma couraça e um capacete de bronze.
39 David put en swod for di tins wey e wear to go fight and e kon try to waka, but e nor fit waka, bikos e nor dey use dem before.
39 Davi prendeu a espada sobre a armadura e tentou dar alguns passos, pois nunca tinha usado essas coisas. “Não consigo andar com tudo isso, pois não estou acostumado”, disse a Saul, e tirou a armadura.
40 David karry en stik for en hand kon pick five good stone from di stream, den e put dem for en animal bag. E take en katapault kon dey go meet di Filistia man.
40 Pegou cinco pedras lisas de um riacho e as colocou em sua bolsa de pastor. Armado apenas com seu cajado e sua funda, foi enfrentar o filisteu.
41 Di Filistia man with di pesin wey karry en swod kon dey waka kom meet David.
41 Golias, com seu escudeiro à frente, caminhava em direção a Davi,
42 Wen di Filistia man near David, e kon vex well-well, bikos na small and fine boy e bi.
42 rindo com desprezo do belo jovem ruivo.
43 Di Filistia man tell David, “I bi dog wey yu dey kom meet with stik?” Di Filistia man kon use en juju name take curse David.
43 Gritou para Davi: “Por acaso sou um cão para que você venha a mim com um pedaço de pau?”. E amaldiçoou Davi em nome de seus deuses.
44 E tell am, “Kom meet mi, so dat I go give yor flesh to di birds for sky and wild animals for di field, make dem chop.”
44 “Venha cá, e darei sua carne às aves e aos animais selvagens!”, berrou Golias.
45 But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge.
45 Davi respondeu ao filisteu: “Você vem a mim com uma espada, uma lança e um dardo, mas eu vou enfrentá-lo em nome do S enhor dos Exércitos, o Deus dos exércitos de Israel, que você desafiou.
46 Today, God go give yu to mi. I go kill yu for groun kon kut yor head komot. I go give yor dead body to di bird for di sky and di wild animals for di land. Den all di land go know sey Israel pipol get betta God
46 Hoje o S enhor entregará você em minhas mãos, e eu o matarei e cortarei sua cabeça. Então darei os cadáveres de seus homens às aves e aos animais selvagens, e o mundo todo saberá que há Deus em Israel!
47 and evribody for here go know sey nor bi by swod or spear, God dey take save pesin. Bikos na God get di fight and E go give yu to us.”
47 E todos que estão aqui reunidos saberão que o S enhor salva seu povo, mas não com espada nem com lança. A batalha é do S enhor , e ele entregará vocês em nossas mãos!”.
48 Goliat kon waka dey kom meet David, so dat e go attack am, den David kwik-kwik run go front go attack Goliat.
48 Quando o filisteu se aproximou para atacar, Davi foi correndo enfrentá-lo.
49 David put en hand inside di bag kon take one stone. E put am for di katapault kon shot di Filistia man for en head. Di stone enter en fore head well-well and e kon fall face groun.
49 Enfiou a mão na bolsa, pegou uma pedra e atirou-a com sua funda. A pedra acertou o filisteu na testa e ficou encravada ali. E Golias caiu com o rosto em terra.
50 David win di Filistia man with di katapault and stone. E shot di Filistia man fall kon kill-am. David nor even get swod for en hand.
50 Assim, Davi venceu o filisteu e o matou com apenas uma funda e uma pedra, pois não tinha espada.
51 So e run go stand near di Filistia man kon take en swod take kill-am, den e kut en head komot with di swod.
51 Em seguida, correu até o filisteu, puxou da bainha a espada dele e a usou para matá-lo e cortar-lhe a cabeça. Quando os filisteus viram que seu melhor guerreiro estava morto, deram meia-volta e fugiram.
52 Den di men for Israel and Judah kon bigin sing war song. Dem porshu Filistia pipol go rish di valley and Ekron gate. Di Filistia man dead body dey groun for Shaaraim road wey dem dey pass go Gat and Ekron.
52 Os soldados de Israel e de Judá soltaram um forte grito de vitória e perseguiram os filisteus até Gate e até os portões de Ecrom. E os corpos dos filisteus mortos e feridos ficaram espalhados pelo caminho de Saarim até Gate e Ecrom.
53 Wen Israel sojas kom back, dem kon karry evritin for Filistia pipol kamp.
53 Então o exército israelita voltou e saqueou o acampamento abandonado dos filisteus.
54 David take Goliat head go Jerusalem and e put Goliat swod for di tent.
54 (Davi levou a cabeça do filisteu para Jerusalém, mas guardou as armas dele em sua própria tenda.)
55 As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?”
55 Quando Saul viu Davi sair para lutar contra os filisteus, perguntou a Abner, o comandante de seu exército: “Abner, quem é o pai desse rapaz?”. “Não faço ideia, ó rei!”, disse Abner.
56 Di king kon sey, “Make yu go find out wish pesin pikin e bi?”
56 “Então descubra quem é o pai dele!”, ordenou.
57 So wen David kom back afta e don kill di Filistia man, Abner kon take am go meet Saul. David still hold Goliat head for en hand.
57 Assim que Davi voltou, depois de matar Golias, Abner o levou a Saul. Ele ainda carregava a cabeça do filisteu em suas mãos.
58 Saul ask am, “My pikin! Na wish pesin pikin yu bi? Who bi yor papa?”
58 Saul perguntou: “Quem é seu pai, meu rapaz?”. E Davi respondeu: “Sou filho de Jessé, que vive em Belém”.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.