1 Samuel 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 One day, Saul pikin, Jonatan kon tell en savant wey dey karry en tins, “Make wi go Filistia sojas kamp wey dey di oda side.” But e nor let en papa know.
1 Um dia, Jônatas, filho de Saul, disse ao seu escudeiro: Vem, passemos até ao acampamento dos filisteus que está do outro lado. Mas nada disse ao seu pai.
2 Saul sidan for outside for Gibeah under one tree wey en fruit bi like gold for Migron. Di sojas wey dey with am na about six hundred.
2 Saul estava acampado na extremidade de Gabaa, debaixo da romãzeira de Magron, com uma tropa de seiscentos homens aproximadamente.
3 (Di priest wey wear di priest garment na Ahijah wey bi Ahitub broda Ikabod pikin and na Finehas wey Eli di priest for Shiloh born, na-im bi Ahitub papa.) Di men nor know sey Jonatan don leave dem.
3 Aquias, filho de Aquitob, irmão de lcabod, filho de Finéias, filho de Heli, o sacerdote do Senhor em Silo, levava o efod. O povo ignorava a saída de Jônatas.
4 For Mikmash road wey Jonatan must pass before e rish Filistia sojas kamp, two big rock dey der for each side: dem dey koll one Bozez and di oda one na Seneh.
4 Ora, no desfiladeiro que Jônatas tentava atravessar para atingir a guarnição dos filisteus, havia rochedos altos, em forma de dentes, de um e outro lado, um dos quais se chamava Boses e o outro Sene.
5 Di rock wey face nort dey near Mikmash and di oda one wey dey sout dey near Gibeah.
5 Um desses se elevava ao norte, defronte de Macmas, e o outro ao sul, do lado de Gabaa.
6 Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”
6 Disse, pois, Jônatas ao seu escudeiro: Vem, ataquemos a guarnição desses incircuncisos; talvez o Senhor combaterá por nós. Nada impede que ele dê a vitória a poucos tão bem como a muitos.
7 Di savant ansa, “Make yu do evritin wey dey yor mind. Do as yor mind dey tell yu. I dey with yu go rish di end.”
7 Seu escudeiro respondeu-lhe: Faze como te aprouver; vai aonde quiseres, que eu te seguirei aonde deliberares.
8 Jonatan kon sey, “Okay! Wi go-go fight doz men.
8 Pois bem, replicou Jônatas; marchemos contra esses homens e mostremos-nos a eles.
9 If dem sey, ‘Make una wait, wi dey kom meet una’, wi go stay for der until dem kom.
9 Se nos disserem: Esperai até que vamos ter convosco, ficaremos em nosso posto, e não subiremos a eles.
10 But if dem sey, ‘Make una kom’, wi go-go meet dem. Bikos like dat, wi go know sey God go help us and na dis go bi di sign to us.”
10 Se, porém, nos disserem: Subi a nós - iremos, porque o Senhor no-los terá entregue nas mãos. Isso nos servirá de sinal.
11 Wen Jonatan and en savant kon let Filistia sojas know sey dem dey around, Filistia pipol kon sey, “Si! Hibru pipol dey kom out from di hole wey dem hide put.”
11 Então, mostraram-se ambos à guarnição dos filisteus. Estes disseram: Eis os hebreus que saem das cavernas onde se tinham escondido.
12 Den Filistia sojas wey dey for Mikmash road kon tell Jonatan and en savant, “Make una kom meet us, so dat wi go show una pepper!”
12 E os homens da guarda gritaram a Jônatas e ao escudeiro: Subi a nós; queremos dizer-vos uma coisa. Jônatas disse ao escudeiro: Segue-me, porque o Senhor os entregou nas mãos de Israel.
13 Jonatan and en savant kon waka go with dia belle for groun. E attack all Filistia sojas for der and en and en savant kon kill dem.
13 Subiu, pois, Jônatas, trepando com as mãos e com os pés, seguido do escudeiro. Os filisteus caíram diante de Jônatas, e o seu escudeiro matava-os atrás dele.
14 For di first fight, Jonatan and en savant kill about twenty men and di aria big rish half-akar land.
14 Esse foi o primeiro massacre que fizeram Jônatas e o seu escudeiro, metade de uma jeira de terra.
15 Den fear kon katch di remainin Filistia sojas wey dey di kamp, field and evriwhere. Dem fear and di eart kon dey shake. Na God kause dis fear.
15 Espalhou-se o terror no acampamento dos filisteus, assim como na região e entre todo o povo. A guarnição e os saqueadores ficaram tomados de espanto, e a terra ficou em pânico: pois aquilo era como um terror de Deus.
16 Saul men wey dey wosh for Gibeah for Benjamin kon si as all Filistia sojas dey run anyhow.
16 As sentinelas de Saul que estavam em Gabaa de Benjamim, viram a multidão de fugitivos que se dispersava por todos os lados.
17 So Saul kon tell di soja wey dey with am, “Gada evribody make wi si who nor dey here with us.” Wen dem gada di sojas, Jonatan and en savant nor dey der.
17 Saul disse ao povo: Fazei uma chamada e vede quem saiu dentre nós. Fez-se a chamada e verificou-se a falta de Jônatas e de seu escudeiro.
18 So Saul tell Profet Ahijah, “Go bring di efod kom here.” (Bikos for dat day, Ahijah karry am for di sojas front.)
18 Saul disse a Aquias: Faze aproximar a arca de Deus. {Porque a arca de Deus se encontrava naquele dia com os israelitas.}
19 As Saul dey tok to di priest, di fear for Filistia pipol kamp dey strong more-more. So Saul kon tell di priest, “Time nor dey to ask God!”
19 Enquanto Saul falava ao sacerdote, o tumulto no acampamento dos filisteus crescia cada vez mais. Saul disse ao sacerdote: Retira a tua mão.
20 Den en and en men kon mash dey go fight Filistia pipol wey don dey fear and kill each oda with swod.
20 O rei e todo o povo que estavam com ele foram até o lugar do combate: os filisteus, numa extrema confusão, voltavam a espada uns contra os outros.
21 Hibru pipol wey don first go fight Filistia pipol before, kom out kon join Israel pipol wey dey with Saul and Jonatan.
21 Os hebreus que tinham estado desde há muito tempo com os filisteus, e que os tinham seguido ao acampamento, voltaram e puseram-se do lado dos israelitas que estavam com Saul e Jônatas.
22 Wen all Israel pipol wey dey hide for Efraim kountry for hill hear sey Filistia pipol dey run, demsef kon kom out bigin porshu dem.
22 Igualmente todos os israelitas que se tinham escondido no monte de Efraim, sabendo que os filisteus tinham fugido, saíram a persegui-los para os ferir.
23 So God kon save Israel pipol dat day and di fight kontinue go rish Bet-Aven.
23 Naquele dia, o Senhor deu a vitória a Israel. O combate prosseguiu até além de Bet-Aven.
24 Naw, di men for Israel don dey hongry, bikos Saul make dem swear sey: “E nor go betta for any man wey go chop food before evening! Make nobody chop anytin until I don revensh my enemies!”
24 Os israelitas estavam extenuados naquele dia, porque Saul conjurara o povo, dizendo: Maldito seja o homem que tomar alimento antes do anoitecer, antes que eu me tenha vingado de meus inimigos. Por isso ninguém tinha comido.
25 even doh sey dem si honey full groun wen dem enter di forest.
25 Todos tinham entrado numa floresta, onde havia mel na superfície do solo.
26 Di honey dey rush like wota, but nobody try to chop from am, bikos dem dey fear di swear wey dem make.
26 o povo entrou, pois, na floresta e viu o mel que corria, mas ninguém levou a mão à boca, por respeito ao juramento.
27 But Jonatan nor hear about di swear wey en papa and di sojas swear. E kon take di rod wey dey en hand take pak di honey. Wen e chop am, en body kon fresh.
27 Mas Jônatas, ignorando o juramento que o seu pai obrigara o povo a fazer, estendeu a ponta da vara que tinha na mão, mergulhou-a num favo de mel e o levou à boca. Então seus olhos {fatigados} brilharam.
28 Den one soja kon tell am, “Yor papa make all di sojas dem swear sey, ‘E nor go betta for any man wey go chop food today!’ Dis na why di sojas dem don taya.”
28 Um homem do grupo disse-lhe: Teu pai fez jurar o povo, dizendo: Maldito o homem que hoje tomar alimento. E o povo estava esgotado.
29 Den Jonatan ansa, “My papa don kause wahala for di land. Si as my body just fresh wen I taste only small for di honey.
29 Jônatas disse: Meu pai fez mal à terra. Vede como se me iluminaram os olhos, porque comi um pouco de mel.
30 True-true, if to sey di sojas chop some for Filistia pipol food, yu nor know sey wi for fit kill dem well-well?”
30 Ah! se o povo tivesse hoje comido da presa tomada ao inimigo, não teria sido muito maior a derrota dos filisteus?
31 Dat day Israel sojas kill Filistia pipol from Mikmash go rish Aijalon and dem kon taya.
31 Eles bateram, naquele dia, os filisteus desde Macmas até Ajalon.
32 So di sojas kon rush with honga, bigin kill both sheep, kattle and melu. Dem kill dem kon chop di animal, di blood and evritin.
32 O povo, esgotado de fadiga, lançou-se sobre a presa e tomou as ovelhas, os bois e os bezerros, que degolou sobre a terra, comendo a carne juntamente com o sangue.
33 So dem kon tell Saul wetin dey happen, “Si, di sojas don sin against God as dem dey chop evritin plus blood sef.”
33 Eis que o povo está pecando contra o Senhor, vieram dizer a Saul, comendo carne com sangue. Isso é uma impiedade, exclamou o rei; revolvei-me já para aqui uma grande pedra.
34 Den e kon kommand: “Make una go tell di pipol make all of dem bring dia animals kom here. Dem go kill-am chop for my front; but make dem nor chop di blood, so dat God nor go vex for dem.” So for dat nite, all of dem kon bring dia animal kill and chop for der.
34 Ide por todo o povo, ajuntou, e dizei-lhes que cada um me traga as suas ovelhas e os seus bois, para que sejam degolados aqui. Comê-los-eis então, sem pecar contra o Senhor, comendo carne com sangue. Cada um deles levou naquela noite o gado que tinha em mãos e o degolou ali.
35 Den Saul build one altar for God and dis na di first time wen e dey build altar for God.
35 Saul edificou um altar ao Senhor. Este foi o primeiro altar que ele levantou.
36 Saul kon sey, “Make wi go porshu Filistia pipol for nite; wi go kill dem until day go break and make wi nor sorry for anybody.”
36 Depois Saul disse: Desçamos durante a noite contra os filisteus e despojemo-los até os primeiros albores do dia e não deixemos vivo um só homem deles. O povo disse: Faze tudo o que melhor te parecer. Então o sacerdote disse: Aproximemo-nos aqui de Deus.
37 So Saul ask God, “Make wi porshu Filistia pipol? Yu go give dem to us?” But God nor ansa am dat day.
37 Saul consultou a Deus: Perseguirei os filisteus? Entregá-los-eis nas mãos de Israel? Mas Deus não lhe respondeu dessa vez.
38 Den Saul sey, “Una wey bi di sojas oga, make una kom. Make una find out who make di pipol sin today.
38 Saul disse: Fazei vir aqui todos os chefes do povo; investigar e dizei-me qual é o pecado que hoje se cometeu.
39 Bikos as long as God wey save Israel dey alive, even if na Jonatan my pikin kause am, e must die today!” But nobody for di sojas tok anytin.
39 Pela vida do Senhor, libertador de Israel! Mesmo que fosse o meu filho Jônatas, ele morrerá! Mas ninguém na multidão lhe respondeu.
40 Den e kon tell di sojas, “Una go dey dis side, why mi and my pikin Jonatan go dey di oda side.”
40 Ponde-vos de um lado, disse ele a todo o Israel; eu e meu filho Jônatas estaremos do outro. A multidão respondeu-lhe: Faze o que te parecer melhor.
41 Den Saul sey, “My Oga wey bi Israel God! Wetin make Yu neva ansa mi today? Ansa mi with di holy stone. If na mi or my pikin kause dis sin, den make Yu ansa by Urim; but if na yor pipol kause am, make Yu ansa by Tummim.” Den God pick Saul and en pikin thru dice wey dem trow and Israel pipol kon dey save.
41 Saul disse ao Senhor: Deus de Israel, dai-nos a conhecer a verdade! Jônatas e Saul foram designados pela sorte, e o povo ficou livre.
42 Den Saul kon sey, “Make una trow di dice for mi and my pikin.” Wen dem trow am, e kon katch Jonatan.
42 Então Saul disse: Lançai a sorte entre mim e Jônatas, meu filho. E caiu a sorte em Jônatas.
43 So Saul tell Jonatan, “Tell mi wetin yu do.”
43 Confessa-me o que fizeste, disse Saul ao seu filho. Jônatas contou-lhe: Provei um pouco de mel com a ponta da vara que eu. tinha na mão. Eis que vou morrer!
44 Saul kon sey, “Make God ponish mi well-well, if I nor kill Jonatan!”
44 Saul disse: Trate-me Deus com todo o rigor, se não morreres, Jônatas!
45 But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.
45 Mas o povo interveio: Como haveria de perecer Jônatas, ele que deu essa vitória tão grande a Israel? Isso não pode ser! Viva Deus! Nem um só cabelo de sua cabeça cairá por terra, porque foi por Deus que ele operou hoje dessa forma. Assim o povo salvou Jônatas, e ele não morreu.
46 Den Saul stop to porshu Filistia pipol and dem kon go back to dia house.
46 Saul voltou e não perseguiu os filisteus, que foram para as suas terras.
47 Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.
47 Saul, depois de ter tomado posse do reino de Israel, combateu contra todos os inimigos da vizinhança: Moab, os amonitas, Edom, os reis de Soba, os filisteus; para onde quer que se voltava, ele vencia.
48 E do great tins kon kill all Amalek pipol, den save Israel pipol from dia enemies hand.
48 Portou-se valorosamente, feriu Amalec e livrou Israel das mãos dos que o devastavam.
49 Saul pikin dem name na Jonatan, Ishvi and Malki-Shua. E get two girls; di senior one na Merab, while di yonga one na Mikal.
49 Os filhos de Saul foram Jônatas, Jessui e Melquisua; a primogênita de suas duas filhas chamava-se Merob, a mais nova Micol.
50 Saul wife name na Ahinoam wey bi Ahimaaz pikin. Di oga for Saul sojas na Abner wey bi Ner pikin and Ner na Saul papa broda.
50 Sua mulher chamava-se Aquinoã, filha de Aquimaas. O general de seu exército era Abner, filho de Ner, tio de Saul.
51 Na Abiel born Kish wey bi Saul papa and Ner wey bi Abner papa.
51 Cís, pai de Saul, e Ner, pai de Abner, eram filhos de Abiel.
52 All di time wen Saul dey alive, e always dey fight with Filistia pipol. So wen ever Saul si pesin wey strong and get mind, e go add am join en sojas.
52 Durante todo o tempo da vida de Saul a guerra foi encarniçada contra os filisteus. O rei, logo que descobria um homem forte e valente, tomava-o a seu serviço.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.