1 Samuel 12

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Samuel tell Israel pipol, “I don do evritin where una ask for. I don give una king.
1 Samuel disse a todo Israel: Obedeci à vossa voz em tudo o que me pedistes, e estabeleci um rei sobre vós.
2 Naw, make una listin! Na dis king go lead una. I don old and get white hair full body, but my sons dey with una. I don dey lead una since wen I yong kon rish today.
2 Agora tendes o rei que vos governará doravante. Quanto a mim, estou velho e encanecido, e meus filhos estão no meio de vós. Estive à vossa frente desde a minha juventude até este dia.
3 Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”
3 Agora, aqui me tendes! Dai testemunho de mim em presença do Senhor e do seu ungido: tomei o boi ou o jumento de alguém? Oprimi ou prejudiquei alguém? Recebi presentes de alguém para fechar os olhos ao seu proceder? Restituirei.
4 Di pipol ansa, “Yu neva do us wrong or opress us. Yu neva take anytin from anybody hand.”
4 Responderam-lhe: Tu não nos prejudicaste, nem nos oprimiste, nem recebeste coisa alguma da mão de ninguém.
5 Samuel kon tell dem, “God and di king wey E choose na witness sey una neva akuiz mi for any bad tin.”
5 Samuel replicou: O Senhor é testemunha contra vós, e também o seu ungido, de que vós não encontrastes coisa alguma nas minhas mãos. Sim, eles são testemunhas, responderam eles.
6 Samuel tell di pipol, “Na God choose Moses and Aaron and na en take una grand-grand papa komot from Egypt.
6 Samuel disse ao povo: É, pois, testemunha o Senhor que estabeleceu Moisés e Aarão, e tirou os vossos pais do Egito.
7 Naw, make una stand for God present, so dat I go remind una about all di good-good tins wey God don do for una and una grand-grand papa.
7 Agora, apresentai-vos. Vou pleitear convosco diante do Senhor a respeito de todos os benefícios que ele vos concedeu a vós e a vossos pais.
8 “Wen Jakob enter Egypt, una grand-grand papa dem kon kry to God. God send Moses and Aaron and dem lead dem komot from Egypt kon stay for here.
8 Depois que Jacó entrou no Egito, vossos pais invocaram o Senhor, e o Senhor enviou Moisés e Aarão para os tirar do Egito e colocá-los neste lugar.
9 “But dem forget di Oga wey bi dia God, so E give dem to Sisera wey bi oga for Hazor sojas, den to Filistia pipol; Moab pipol king and dem kon fight and opress Israel pipol.
9 Mas esqueceram-se do Senhor, seu Deus, e ele os entregou nas mãos de Sísara, general do exército de Hazor, nas mãos dos filisteus e na mão do rei de Moab, os quais combateram contra eles.
10 Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’
10 Depois clamaram ao Senhor, dizendo: Pecamos, porque abandonamos o Senhor para servir aos Baal e às Astarot: agora livrai-nos das mãos de nossos inimigos, e nós vos serviremos.
11 So, God send Jerub-Baal, Barak, Jeftah and Samuel and E kon save una from una enemies.
11 O Senhor enviou Jerobaal, Badã, Jefté e Samuel, para salvar-vos das mãos dos inimigos que vos cercavam, a fim de habitantes em segurança nas vossas casas.
12 “Wen una si sey King Nahash for Ammon dey kom fight una, una sey, ‘No! Wi wont king’, even doh na di Oga una God bi una king!
12 Mas quando vistes Naas, rei dos amonitas, marchar contra vós, dissestes-me: Não! Um rei nos governará!, quando o Senhor, nosso Deus, era o vosso rei.
13 Naw make una look! Na di king wey una choose bi dis; di king wey una ask for. Si, God don give una king.
13 Eis, pois, o rei que escolhestes e pedistes. O Senhor estabeleceu-o sobre vós.
14 If una fear God kon serve and obey am and una nor go against wetin E tok and if una and di king wey dey rule una follow di Oga una God, den evritin go dey well with una.
14 Esteja em vós o temor ao Senhor, para o servirdes, e obedecerdes à sua voz e não vos rebelardes contra as suas vontades! Que vós sejais, vós e o vosso rei, dóceis ao Senhor, vosso Deus.
15 But if una nor obey God kon go against wetin E tok, God hand go dey against both una and una king.
15 Mas se não ouvirdes a sua voz, e vos revoltardes contra as suas ordens, a mão do Senhor pesará sobre vós como pesou sobre vossos pais.
16 “So, make una stand for where una dey kon wosh di great tins wey God go do and una go si am with una eye.
16 Agora, ficai ainda um pouco aqui para assistirdes ao prodígio que o Senhor vai realizar aos vossos olhos.
17 Abi nor bi di time to harvest grain bi dis? I go koll God, so dat E go send betta tonda and rain kom. Make una open una eye kon si how una don sin rish, wen una ask God for king wey go lead una.”
17 Não é porventura agora a sega do trigo? Vou invocar o Senhor e ele fará trovejar e chover. Compreendereis então que fizestes mal aos seus olhos pedindo um rei.
18 So Samuel koll God and God kon make tonda and rain fall thru-out dat day. All di pipol kon dey fear God and Samuel.
18 Samuel pôs-se em oração e o Senhor mandou no mesmo instante trovões e chuva; todo o povo temeu grandemente ao Senhor e a Samuel.
19 Dem kon tell Samuel, “Make yu help us pray to God, so dat all of us nor go die, bikos wi don add join awa sins, wen wi ask for king.”
19 E disseram todos a Samuel: Roga pelos teus servos ao Senhor, teu Deus, para que não morramos, porque a todos nossos pecados ajuntamos o mal de pedirmos um rei.
20 Den Samuel tell di pipol, “Make una nor fear. True-true, una don sin. But make una nor turn from God. Make una serve God with all una heart.
20 Não temais, respondeu Samuel. O mal está feito; agora não vos desvieis do Senhor e servi-o de todo o vosso coração.
21 Make una nor bigin follow tins wey nor mean anytin, tins wey una nor go gain from or tins wey nor fit save una.
21 Não vos afasteis dele para seguintes coisas vãs, que não salvam nem livram, porque são vãs.
22 God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol.
22 O Senhor, por causa do seu grande nome, não abandonará o seu povo, porque foi do seu agrado fazer de vós uma nação.
23 As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.
23 Longe de mim também esse pecado contra o Senhor de cessar de orar por vós! Eu vos mostrarei o caminho bom e reto.
24 Make una dey fear and serve God with all una heart. Make una si all di wonderful tins wey E don do for una!
24 Temei, pois, ao Senhor e servi-o em verdade e de todo o vosso coração, considerando as maravilhas que ele fez por vós.
25 But if una kontinue to dey do bad tins, God go distroy both una and una king.”
25 Se, porém, fizerdes o mal, perecereis vós e o vosso rei.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.