1 Samuel 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Nahash dem wey bi Ammon pipol kon mash dey go fight Jabesh pipol. All di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Make wi make peace with una and wi go serve una.”
1 Então, subiu Naás, amonita, e sitiou a Jabes-Gileade; e disseram todos os homens de Jabes a Naás: Faze aliança conosco, e te serviremos.
2 But Nahash pipol wey bi Ammon pipol kon ansa, “Di only way wey wi fit make peace with una, na if una agri make wi blind evribody rite eye and dis go bi disgrace for Israel pipol!”
2 Porém Naás, amonita, lhes respondeu: Farei aliança convosco sob a condição de vos serem vazados os olhos direitos, trazendo assim eu vergonha sobre todo o Israel.
3 Di leaders for Jabesh kon tell dem, “Make una give us seven days, so dat wi go send message go evriwhere for Israel. If nobody dey to diliver us, den wi go do as una wont.”
3 Então, os anciãos de Jabes lhe disseram: Concede-nos sete dias, para que enviemos mensageiros por todos os limites de Israel e, não havendo ninguém que nos livre, então, nos entregaremos a ti.
4 Wen di pesin wey dem send rish Gibeah (where Saul dey stay) kon tell dem wetin dey happen, all di pipol kon bigin kry.
4 Chegando os mensageiros a Gibeá de Saul, relataram este caso ao povo. Então, todo o povo chorou em voz alta.
5 Naw, Saul just dey bring en animals kom back from farm. Wen Saul si di pipol, e kon ask, “Wetin happen? Wetin make una dey kry?” Dem kon tell am about di men for Jabesh.
5 Eis que Saul voltava do campo, atrás dos bois, e perguntou: Que tem o povo, que chora? Então, lhe referiram as palavras dos homens de Jabes.
6 As Saul hear dis word, God Spirit enter en body and e kon dey vex.
6 E o Espírito de Deus se apossou de Saul, quando ouviu estas palavras, e acendeu-se sobremodo a sua ira.
7 Saul kut two melu to many parts kon tell some pipol make dem karry di parts go evriwhere for Israel sey, “Anybody wey nor gri follow Saul and Samuel, make e know sey na so dem go do en melu!” Den God make fear enter di pipol and dem kon go fight as one family.
7 Tomou uma junta de bois, cortou-os em pedaços e os enviou a todos os territórios de Israel por intermédio de mensageiros que dissessem: Assim se fará aos bois de todo aquele que não seguir a Saul e a Samuel. Então, caiu o temor do Senhor sobre o povo, e saíram como um só homem.
8 Wen Saul kount all of dem for Bezek, Israel pipol na 300,000 strong men, while Judah men, na 30,000.
8 Contou-os em Bezeque; dos filhos de Israel, havia trezentos mil; dos homens de Judá, trinta mil.
9 Dem kon tell di pesin wey dem send kom, “Dis na wetin yu go tell Jabesh: ‘Tumoro, una go dey save wen di sun don dey shine well-well.’ ” Wen di messenja go tell Gilead pipol di message, belle sweet dem well-well.
9 Então, disseram aos mensageiros que tinham vindo: Assim direis aos homens de Jabes-Gileade: Amanhã, quando aquentar o sol, sereis socorridos. Vindo, pois, os mensageiros, e, anunciando-o aos homens de Jabes, estes se alegraram
10 Di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Tumoro, wi go kom surenda to una and make una trit us as una like.”
10 e disseram aos amonitas: Amanhã, nos entregaremos a vós outros; então, nos fareis segundo o que melhor vos parecer.
11 Di next day, Saul kon divide di pipol into three group. Dem go Ammon pipol kamp for morning kon kill all of dem until aftanoon. And di pipol wey remain, run skata go difren place.
11 Sucedeu que, ao outro dia, Saul dividiu o povo em três companhias, que, pela vigília da manhã, vieram para o meio do arraial e feriram a Amom, até que se fez sentir o calor do dia. Os sobreviventes se espalharam, e não ficaram dois deles juntos.
12 Den di pipol kon tell Samuel, “Na who bi di pipol wey dey ask sey, ‘So Saul go kon rule us?’ Tell us who dem bi, so dat wi go kill all of dem!”
12 Então, disse o povo a Samuel: Quem são aqueles que diziam: Reinará Saul sobre nós? Trazei-os para aqui, para que os matemos.
13 But Saul ansa, “Una nor go kill anybody today. Bikos God don make Israel pipol win!”
13 Porém Saul disse: Hoje, ninguém será morto, porque, no dia de hoje, o Senhor salvou a Israel.
14 Samuel tell di pipol, “Make una kom make wi go Gilgal go crown Saul.”
14 Disse Samuel ao povo: Vinde, vamos a Gilgal e renovemos ali o reino.
15 So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.
15 E todo o povo partiu para Gilgal, onde proclamaram Saul seu rei, perante o Senhor , a cuja presença trouxeram ofertas pacíficas; e Saul muito se alegrou ali com todos os homens de Israel.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.