1 Samuel 10
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.
1 Samuel pegou um vaso de azeite e o derramou sobre a cabeça de Saul. Então ele o beijou e disse: — O
2 Wen yu leave mi today, yu go si two men near Rashel Grave for Benjamin borda wey dey Zelzah. Dem go tell yu, ‘Di donkey dem wey yu dey fine, dem don si dem. Yor papa nor dey worry for di donkey again, but e dey worry for una too. E dey ask sey, “Wetin I go do naw wey I nor si my pikin?” ’
2 Hoje, quando você se afastar de mim, encontrará dois homens junto ao túmulo de Raquel, no território de Benjamim, em Zelza. Eles lhe dirão: “Já foram achadas as jumentas que você foi procurar. E eis que agora o seu pai já não pensa no caso delas e está aflito por causa de vocês, dizendo: ‘Que posso fazer por meu filho?’”
3 “As yu dey go from here, yu go rish dat tall tree for Tabor. Dat time, three men wey dey go meet God for Bethel, go meet yu. One of dem go karry three bread and one go karry one kontaina wey get wine.
3 Ao seguir adiante, você chegará ao carvalho de Tabor. Ali virão ao seu encontro três homens, que vão subindo a Deus em Betel. Um estará levando três cabritos; outro, três pães; e o outro, um odre de vinho.
4 Dem go ask yu how yu dey and dem go give yu two bread. Make yu kollect dem.
4 Eles irão saudar você e lhe darão dois pães, que você deve aceitar.
5 “Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.
5 Então você seguirá para Gibeá-Eloim, onde está a guarnição dos filisteus. Ao entrar na cidade, você encontrará um grupo de profetas que descem do lugar alto. Eles estarão tocando liras, tambores, flautas e harpas. E estarão profetizando.
6 Den God Spirit go enter yu and yu go dey profesai as dem dey do. Yu go bi like anoda pesin.
6 O Espírito do Senhor se apossará de você, e você profetizará com eles e será mudado em outro homem.
7 Wen dis signs don happen, make yu do anytin wey yu fit do, bikos God go dey with yu.
7 Quando estes sinais se cumprirem, faça o que a ocasião exigir, porque Deus está com você.
8 “Yu go-go Gilgal before mi. I go kom meet yu for der kon offa ofrin and make peace ofrin for der. Yu go wait for seven days, until I go kom tell yu wetin yu go do.”
8 Vá na minha frente para Gilgal. Eis que eu descerei para junto de você, a fim de oferecer holocaustos e apresentar ofertas pacíficas. Espere sete dias, até que eu venha para junto de você e diga o que você deve fazer.
9 As Saul turn leave Samuel dey go, God kon shange as Saul dey tink. All di signs happen for dat same day.
9 Aconteceu que, no momento em que Saul se virou para se despedir de Samuel, Deus lhe mudou o coração. E todos esses sinais aconteceram naquele mesmo dia.
10 Wen dem rish Gibeah, some profets kom meet am. Den God Spirit enter Saul body and e kon bigin tok like di profets.
10 Quando eles chegaram a Gibeá, eis que um grupo de profetas saiu ao encontro deles. O Espírito de Deus se apossou de Saul, e ele profetizou no meio deles.
11 Wen evribody wey know am before si am dey tok like profet, dem kon dey ask each oda, “Wetin dey happen to Kish pikin? Saul sef don bi profet?”
11 Todos os que já o conheciam, vendo que ele profetizava com os profetas, perguntavam uns aos outros: — Que é isso que aconteceu com o filho de Quis? Está também Saul entre os profetas?
12 One man wey kom from der kon ansa, “Na who bi dia papa?” So dis tin kon turn parabol: “Saul sef dey among di profets?”
12 Então um homem do lugar perguntou: — E quem é o pai dos outros? Por isso surgiu este provérbio: “Está também Saul entre os profetas?”
13 Wen Saul don tok finish, e kon go di altar for di hill.
13 E, depois de profetizar, Saul seguiu para o alto do monte.
14 Saul papa broda kon ask en and en savant, “Na where una go?”
14 O tio de Saul perguntou a ele e ao seu servo: — Aonde vocês foram? Saul respondeu: — Fomos procurar as jumentas e, quando vimos que não apareciam, fomos falar com Samuel.
15 Saul papa broda kon sey, “Make yu tell mi wetin Samuel tell yu.”
15 Então o tio de Saul disse: — Conte-me, por favor, o que Samuel disse a vocês.
16 Saul ansa am, “E tell us sey dem don si di donkey.” But Saul nor tell am wetin Samuel tell am about to bi Israel pipol king.
16 Saul respondeu: — Ele nos disse que as jumentas tinham sido encontradas. Porém Saul não contou ao tio o que Samuel tinha dito a respeito do reino.
17 Den Samuel koll di pipol make dem kom meet God for Mizpa.
17 Samuel convocou o povo para comparecer diante do Senhor , em Mispa,
18 E tell dem, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I bring una kom out from Egypt kon diliver una from dia pawa and from all di kingdoms wey dey opress una.
18 e disse aos filhos de Israel: — Assim diz o
19 But today, una don rijet di God wey save una from all una trobols and wahala. Una don sey, “No! Choose king wey go rule us.” Naw make una stand for God present akordin to una tribe and family.’ ”
19 Mas hoje vocês rejeitaram o seu Deus, que os livrou de todos os seus males e trabalhos. Vocês lhe disseram: ‘Não! Queremos um rei sobre nós.’ Agora, pois, reúnam-se diante do Senhor , por tribos e grupos de milhares.”
20 Den Samuel bring all di tribe for Israel and dem kon trow dice take choose Benjamin tribe.
20 Samuel fez com que todas as tribos se aproximassem, e a tribo sorteada foi a de Benjamim.
21 Den e bring Benjamin tribe akordin to family and na Matri family dem choose. At last, dem kon choose Kish pikin wey en name na Saul wen dem trow di dice. But wen dem look for am, dem nor si am.
21 Então Samuel chamou a tribo de Benjamim pelas suas famílias, e foi indicada a família de Matri. E da família de Matri foi indicado Saul, filho de Quis. Mas, quando o procuraram, não puderam encontrá-lo.
22 So dem kon ask God again sey, “Di man don rish here?”
22 Então perguntaram ao Senhor se aquele homem já havia chegado ali. E o Senhor respondeu: — Ele está aí escondido entre a bagagem.
23 So dem run go karry am kom from der. Wen e stand with di pipol, e tall pass all of dem.
23 Então correram e o tiraram de lá. Ele ficou em pé no meio do povo, e era o mais alto de todos; dos ombros para cima, ele sobressaía a todo o povo.
24 Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!”
24 Então Samuel disse a todo o povo: — Vocês estão vendo quem o Então todo o povo começou a gritar: — Viva o rei!
25 Samuel tell di pipol how di king go work. E rite evritin down for book kon put am for God present. Den Samuel sey make evribody dey go dia house.
25 Samuel explicou ao povo o direito do reino, escreveu-o num livro e o pôs diante do Senhor . Então Samuel despediu todo o povo, cada um para sua casa.
26 Even Saul sef go en house for Gibeah. But some strong men wey God don tosh dia heart, follow am go en house for Gibeah.
26 Também Saul foi para a sua casa, em Gibeá. Com ele foi uma tropa de homens cujo coração Deus havia tocado.
27 But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.
27 Mas alguns homens malignos disseram: — Como poderá este homem nos salvar? E o desprezaram e não lhe trouxeram presentes. Mas Saul se fez de surdo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.