1 Reis 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Solomon koll all di leaders for Israel tribe and villages kon tell dem, “Make una karry God Kovenant Box go di temple for Zion wey bi David Town.”
1 Aí o rei Salomão convocou todos os chefes das tribos e dos grupos de famílias de Israel para irem encontrar-se com ele em Jerusalém a fim de levarem a arca da aliança de Deus, de Sião , a Cidade de Davi , para o Templo.
2 Wen dem dey do Shelta Feast for Etanim mont (wey bi di sevent mont), all of dem kon gada,
2 Todos os israelitas se reuniram durante a Festa das Barracas , no mês de etanim , que é o sétimo mês.
3 den di priest lift di Kovenant Box
3 Quando todos os chefes chegaram, os sacerdotes pegaram a arca da aliança
4 kon karry am go put for di temple. Levi pipol and di priest still karry di tent wey God for dey meet di pipol, with all di oda tins, go di temple.
4 e a levaram para o Templo. Os levitas e os sacerdotes levaram também a Tenda da Presença de Deus com todos os seus equipamentos para o Templo.
5 Solomon and Israel pipol gada for di Kovenant Box front kon sakrifice plenty sheep and melu.
5 O rei Salomão e todo o povo de Israel se reuniram em frente da arca da aliança e ofereceram em sacrifício um grande número de ovelhas e touros, tantos que nem dava para contar.
6 Den di priest karry di Kovenant Box enter di temple kon put am for di Most Holy Place; under di creatures wey get feadas.
6 Então os sacerdotes levaram a arca para dentro do Templo e a colocaram onde devia ficar, no Lugar Santíssimo , debaixo das asas dos querubins .
7 Di creature feadas kover di pole wey dem take karry am.
7 Pois as suas asas estendidas cobriam a arca e os seus cabos.
8 Na only di pesin wey sidan for di Most Holy Place front, fit si di pole end and nobody fit si dem from any oda place. Di poles still dey der till today.
8 As pontas dos cabos podiam ser vistas por qualquer pessoa que ficasse diretamente em frente ao Lugar Santíssimo, mas não podiam ser vistas de nenhum outro lugar. (Os cabos ainda estão ali até hoje .)
9 Na only di stone tablets wey God take make Kovenant with Israel pipol as dem dey kom from Egypt, dey inside di Kovenant Box and na Moses put am wen dem dey Mount Sinai.
9 Dentro da arca estavam somente as duas placas de pedra que Moisés havia colocado ali, quando, no monte Sinai, o Senhor Deus havia feito uma aliança com os israelitas depois que eles saíram do Egito.
10 As di priests dey komot from di temple, kloud kon kover di temple.
10 Quando os sacerdotes estavam saindo do Lugar Santo , uma nuvem encheu o Templo do Senhor
11 Di priest nor fit do anytin again, bikos God present don full di temple.
11 com a glória do Senhor , e eles não puderam voltar para dentro a fim de realizar os seus atos de culto.
12 Den Solomon kon pray, “Oga God, Yu sey Yu go stay for darkness.
12 Aí Salomão disse: — Tu, ó embora tivesses resolvido viver entre as nuvens escuras.
13 Naw! I don build big temple for Yu, place wey Yu fit stay forever.”
13 Mas agora eu construí para ti uma casa, um lugar onde viverás para sempre.
14 As di pipol stand for der, Solomon turn face dem kon bless dem with God name.
14 Aí Salomão virou-se, olhou para o povo, que estava todo de pé, e pediu a bênção de Deus para todos.
15 E sey, “Di Oga wey bi Israel pipol God, make all di praiz bi en own! E don do wetin E promise David my papa, wen E tell am sey,
15 Depois disse: — Bendito seja o
16 ‘From di time wey I bring my pipol kom out from Egypt, I neva choose any town among Israel land where dem go build temple put to woship mi, but I choose yu, David, so dat yu go rule my pipol.’ ”
16 “Desde o dia em que tirei do Egito o meu povo de Israel, eu não escolhi nenhuma cidade de todas as tribos da terra de Israel para ali construir um templo a fim de ser adorado nele. Mas escolhi você, Davi, para governar o meu povo.”
17 Solomon still sey, “David my papa plan sey e go build temple where dem go for woship di Oga wey bi Israel pipol God,
17 E Salomão continuou: — Davi, o meu pai, tinha planos de construir um templo para a adoração do
18 but God tell am, ‘Yu do well as yu won build temple for mi,
18 mas o Senhor lhe disse: “Você fez bem quando planejou construir um templo para mim,
19 but yu nor go ever build am. Na yor own pikin go build my temple.’
19 mas você não o construirá. Será o seu filho quem construirá o meu Templo.”
20 And naw, God don keep en promise. I don bi king for Israel afta my papa and I don build di temple where dem go for dey woship di Oga wey bi Israel pipol God.
20 E agora Deus cumpriu a sua promessa. Eu fiquei no lugar do meu pai como rei de Israel e construí o Templo para a adoração do Senhor , o Deus de Israel.
21 I don still make place for di temple, where dem go keep di Kovenant Box and di stone wey dem rite di kovenant put, wey God make with awa grand-grand papa wen E bring dem kom out from Egypt, dey inside.”
21 Também separei no Templo um lugar para colocar a arca da aliança , onde estão guardadas as placas de pedra da aliança que o Senhor Deus fez com os nossos antepassados quando os tirou do Egito.
22 Den, for di pipol present, Solomon go stand for di altar front, raiz en hand
22 Então, na presença de todo o povo reunido, Salomão foi e ficou em frente do altar. Levantou as mãos para o céu
23 kon pray,
23 e disse: — Ó
24 Today, Yu don do wetin Yu promise David my papa. Yu don do evry word wey Yu tok.
24 Pelo teu poder cumpriste a promessa que fizeste a Davi, o meu pai; no dia de hoje todas as palavras da tua promessa foram completamente cumpridas.
25 And naw, my Oga! Yu wey bi Israel pipol God, I dey pray make Yu do all di oda tins wey Yu promise my papa wen Yu sey, na only en shidren-shidren go bi king for Israel, as long as dem obey Yu, just as dia papa, David obey Yu.
25 E agora, ó Senhor , Deus de Israel, eu te peço que cumpras a outra promessa que fizeste ao meu pai quando lhe disseste que sempre haveria um descendente dele governando como rei de Israel, contanto que eles te obedecessem com o mesmo cuidado com que ele obedeceu.
26 Naw, my Oga wey bi Israel God, make Yu do evritin wey Yu promise David my papa wey bi yor savant.
26 Portanto, ó Deus de Israel, faze com que se cumpra aquilo que prometeste a Davi, o meu pai, teu servo .
27 My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?
27 — Mas será que, de fato, ó Deus, tu podes morar no meio de nós, criaturas humanas, aqui na terra? Tu és tão grande, que não cabes nem mesmo no céu; como poderia este Templo que eu construí ser bastante grande para isso?
28 Oga wey bi my God; I bi yor savant. Make Yu listin to my prayer kon do evritin wey I go ask Yu today.
28 Ó Senhor , meu Deus, eu sou teu servo. Escuta a minha oração e atende os pedidos que te faço hoje.
29 Make Yu look dis temple both for day and for nite; di place where Yu choose sey make dem for dey woship Yu.
29 Olha de dia e de noite para este Templo, o lugar que escolheste para nele seres adorado. Ouve-me quando eu orar com o rosto virado para este lugar.
30 Make Yu hear mi anytime wey I face dis temple dey pray. Make Yu hear and forgive us from where Yu dey for heaven.
30 Escuta as minhas orações e as orações do teu povo quando eles orarem com o rosto virado para cá. Sim, da tua casa no céu, ouve-nos e perdoa-nos.
31 If dem tok sey pesin do anoda pesin bad and dem bring am kom yor altar for dis temple, den e swear sey e nor do am,
31 — Quando alguém for acusado de prejudicar outra pessoa e for trazido até o teu altar neste Templo e jurar que é inocente,
32 my Oga God, make Yu listin from heaven, den kon judge yor savants. Make Yu ponish di one wey do bad as e fit am kon free di one wey dey rite.
32 ó Senhor , ouve do céu e julga os teus servos. Castiga o culpado como ele merecer e declara que não tem culpa aquele que for inocente, recompensando-o como ele merecer.
33 Wen Israel pipol enemies win dem, bikos dem sin against Yu and if dem turn to Yu for dis temple kon sey, ‘Papa forgive us’,
33 — Quando, por ter pecado contra ti, o teu povo de Israel for derrotado pelos seus inimigos e, quando ele se virar para ti e vier a este Templo para te louvar e pedir o teu perdão,
34 make Yu listin to dem from heaven. Make Yu forgive dem kon bring dem back to di land wey Yu promise dia grand-grand papa.
34 escuta-o do céu. Perdoa o pecado do teu povo e leva-o de volta para a terra que deste aos seus antepassados.
35 If Yu hold di rain, bikos yor pipol sin against Yu, wons dem turn from sin kom meet Yu kon pray to Yu for dis temple,
35 — Quando o céu se fechar, e não chover, porque o teu povo pecou contra ti, e eles se arrependerem e virarem o rosto na direção deste Templo e orarem e te louvarem, depois que os tiveres castigado,
36 make Yu listin and ansa dem from heaven. Make Yu forgive di king and Israel pipol for dia sins kon tish dem di rite way. Den, my Oga God, make Yu send rain kom dis land wey Yu give yor pipol as dia own forever.
36 escuta-os do céu. Perdoa os pecados do rei e do povo de Israel e ensina-os a fazer o que é direito. Então, ó Deus, faze cair chuva sobre esta tua terra que deste ao teu povo para ser deles para sempre.
37 Wen honga dey di land; sickness or plants don spoil, bikos of strong wind, plenty lokust or wen enemies attack yor pipol; or sickness and diziz katch dem,
37 — Quando nesta terra houver falta de alimentos, ou houver pragas, ou as colheitas forem destruídas por ventos muito quentes ou por bandos de gafanhotos, ou quando o teu povo for atacado pelos seus inimigos, ou quando houver peste ou doença entre o povo,
38 make Yu listin to dia prayers and if anybody wey dey face pain for Israel, stresh en hand pray for dis temple,
38 escuta as suas orações. Se alguém do teu povo de Israel, sentindo no seu coração o peso da desgraça, estender as mãos na direção deste Templo e orar,
39 make Yu hear dia prayer and listin to dem from where Yu dey for heaven. Make Yu forgive and help dem. Na only Yu know wetin human being dey tink. Make Yu ponish or bless anybody as e fit am,
39 escuta a sua oração. Lá do teu lar no céu, ouve o teu povo, perdoa-o e ajuda-o. Só tu conheces os pensamentos secretos do coração humano. Trata cada pessoa como merecer,
40 so dat yor pipol go always obey Yu as long as dem dey dis land wey Yu give dia grand-grand papa.
40 para que o teu povo te tema e te obedeça durante todo o tempo em que eles viverem na terra que deste aos nossos antepassados.
41 Wen pesin from anoda land hear di big-big tins wey Yu do for yor pipol,
41 — ausente —
42 dem go kon woship and pray to Yu for dis temple.
42 — ausente —
43 My Oga God, make Yu listin to dia prayer. For heaven wey Yu dey, make Yu hear and do wetin dem sey make Yu do, so dat evribody for di world go know and obey Yu, just as yor pipol Israel dey do. Den dem go know sey dis temple wey I build, na di place where dem go for dey woship Yu.
43 ouve a sua oração. Lá do céu, onde vives, escuta-o e faze tudo o que ele te pedir, para que todos os povos da terra possam te conhecer e temer, como faz o teu povo de Israel. Então eles ficarão sabendo que este Templo que eu construí é o lugar onde deves ser adorado.
44 Wen Yu kommand yor pipol make dem fight war with dia enemies, if dem pray to Yu from anywhere and dem face dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu,
44 — Quando ordenares que o teu povo saia para a guerra contra os seus inimigos, e o teu povo orar a ti, virados para esta cidade que escolheste e para este Templo que construí em honra do teu nome,
45 make Yu listin to dia prayer. Make Yu hear dem from heaven kon give dem viktory.
45 escuta do céu as suas orações e os seus pedidos. Ouve-os e dá-lhes a vitória.
46 Wen yor pipol sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin) and Yu vex kon let dia enemies defeat and karry dem like prisonas go anoda land. Even if di land far well-well,
46 — Quando eles pecarem contra ti — e não há ninguém que não peque — e na tua ira deixares que os inimigos deles os derrotem e os levem prisioneiros para alguma terra inimiga, longe ou perto daqui,
47 make Yu still listin to yor pipol prayer. If dem turn kom meet Yu for dat land kon pray and konfess dia sin and di wiked tins wey dem don do, my Oga God, make Yu hear dia prayers.
47 ouve as orações do teu povo. Se ali, naquela terra, eles se arrependerem e orarem a ti, confessando que foram pecadores e maus, escuta as suas orações, ó Senhor .
48 If dem really turn from sin kon pray to Yu for dat land as dem face dis town wey Yu give awa grand-grand papa dem (dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu),
48 Se naquela terra eles verdadeiramente e sinceramente se arrependerem e orarem a ti, virados na direção desta terra que deste aos nossos antepassados, desta cidade que escolheste e deste Templo que construí em honra do teu nome,
49 den make Yu listin to dia prayers. Make Yu hear from heaven kon sorry for dem.
49 escuta as orações deles. Do teu lar no céu ouve-os e dá-lhes a vitória.
50 Make Yu forgive dem wen dem sin against Yu kon make dia enemies dey respet dem.
50 Perdoa os pecados que o teu povo tem cometido contra ti e a sua revolta contra ti e faze com que os seus inimigos os tratem com bondade.
51 Dem bi yor pipol wey Yu karry komot Egypt; place wey bi like sey na fire dey burn dem.
51 Eles são o teu povo que tiraste daquela fornalha acesa, o Egito.
52 Oga God, make Yu always dey favor Israel yor pipol and dia king, den hear dia prayer wen ever dem koll Yu for help.
52 — Ó Senhor , nosso Deus, eu te peço que olhes com simpatia para o teu povo de Israel e para o seu rei e escutes as suas orações sempre que eles te chamarem pedindo ajuda.
53 From all di pipol, Yu choose Israel pipol to bi yor own, bikos na so Yu tell dem thru Moses yor savant, wen Yu bring dem kom out from Egypt.”
53 Tu os escolheste entre todos os povos para serem o teu povo, conforme lhes disseste por meio do teu servo Moisés, quando tiraste do Egito os nossos antepassados.
54 Afta Solomon don pray to God finish, e stand for di altar front where e knee down and raiz en hand since.
54 Depois que Salomão acabou de orar ao Senhor Deus, ele se levantou e ficou em frente do altar, onde havia estado ajoelhado com as mãos levantadas para o céu.
55 Wen e stand up, e bless or di pipol as e shaut dey sey:
55 Então, em voz alta, pediu as bênçãos de Deus para todo o povo que estava reunido ali. Ele disse:
56 “Make wi praiz God wey don give en pipol peace, just as E sey E go do. E don do all di tins wey E promise Moses en savant.
56 — Bendito seja o Senhor Deus, que deu paz ao seu povo, como havia prometido! Ele tem cumprido todas as abençoadas promessas que fez por meio do seu servo Moisés.
57 Make di Oga wey bi awa God dey with us as E bin dey with awa grand-grand papa dem and make E nor leave or abandon us.
57 Que o Senhor , nosso Deus, esteja conosco assim como esteve com os nossos antepassados! Que ele nunca nos deixe, nem nos abandone!
58 Make E make us dey obey am, so dat wi go always dey live as E wont make wi live kon keep di laws wey E give awa grand-grand papa.
58 Que Deus nos faça obedientes a ele, para que sempre vivamos conforme ele quer, obedecendo a todos os mandamentos, leis e ensinos que ele deu aos nossos antepassados!
59 Make awa Oga God remember all di prayer and komplain wey I don make with am since. Make E always dey show mesi to Israel pipol and dia king wen dem koll am evriday,
59 Que o Senhor , nosso Deus, lembre sempre desta oração e dos pedidos que eu lhe fiz! Que ele sempre tenha misericórdia do povo de Israel e do seu rei, de acordo com o que precisarem!
60 so dat all di nashons go know sey na only God bi God and e nor get anoda god.
60 E assim todas as nações do mundo ficarão sabendo que somente o Senhor é Deus e que não há nenhum outro.
61 Make una wey bi en pipol dey faithful to am and dey always obey en laws and kommand.”
61 Que vocês sejam sempre fiéis ao Senhor , nosso Deus, obedecendo a todos os seus mandamentos e leis, como fazem hoje!
62 Den King Solomon and all di pipol kon sakrifice give God.
62 Então o rei Salomão e todo o povo que estava ali ofereceram sacrifícios a Deus, o Senhor .
63 Dem sakrifice 22,000 melu and 120,000 sheep as fellowship ofrin. So di king and all di pipol dedikate di temple.
63 Ele ofereceu em sacrifício vinte e dois mil bois e cento e vinte mil ovelhas como ofertas de paz. E assim o rei e todo o povo dedicaram o Templo ao serviço do Senhor .
64 Di king still dedikate di kourtyard centre with di aria for di temple front kon burn di whole sakrifice for der. E give di grain and all di fat animals as fellowship ofrins.
64 Naquele mesmo dia Salomão separou, a fim de ser sagrada para Deus, a parte central do pátio que ficava em frente ao Templo. Ali ele apresentou as ofertas que foram completamente queimadas, as ofertas de cereais e a gordura dos animais que haviam sido trazidos como ofertas de paz. Salomão fez isso porque o altar de bronze era muito pequeno para todas essas ofertas.
65 For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.
65 Naquela ocasião, ali no Templo, Salomão e todo o povo de Israel comemoraram durante sete dias a Festa das Barracas . O povo era uma enorme multidão de pessoas que tinham vindo do país inteiro, desde a subida de Hamate, no Norte, até a fronteira do Egito, no Sul.
66 For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.
66 No oitavo dia Salomão mandou o povo para casa. Todos pediram as bênçãos de Deus para ele e foram embora, felizes por causa de todas as coisas boas que o Senhor Deus tinha dado ao seu servo Davi e ao seu povo de Israel.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Reis 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.