1 Reis 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Naw, David don old well-well and even wen dem kover am with klot, kold go still dey katch am.
1 O rei Davi estava velho, avançado em anos, e por mais que o cobrissem de roupas, não se aquecia.
2 So en ofisas tell am, “My king, make wi find one yong woman wey neva sleep with man before. E go dey sleep near yu and yor body go dey warm.”
2 Seus familiares disseram-lhe: Busquemos para nosso senhor, o rei, uma donzela virgem que sirva o rei e tenha cuidado dele, e durma em seu seio para que ele se aqueça.
3 Dem find evriwhere for Israel and dem si one fine girl kon karry am go meet di king, Di girl kom from Shunem and en name na Abishag.
3 Procuraram, pois, em toda a terra de Israel, uma donzela formosa; encontraram Abisag, a sunamita, e levaram-na ao rei.
4 Di girl fine well-well, e dey kare and serve di king, but David nor sleep with am.
4 Essa donzela era muito formosa. Ela cuidava do rei e o servia, mas o rei não a possuiu.
5 For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am.
5 Ora, Adonias, filho de Hagit, encheu-se de orgulho e exclamou: Sou eu quem reinará. Adquiriu para si um carro e cavalos, e tomou uma escolta de cinqüenta homens.
6 (David neva even ask or korrect am wons sey, “Wetin make yu dey bihave like dis?” Adonijah na very fine man too and naim dem born follow Absalom.)
6 Nunca seu pai o contrariou, dizendo: Por que fazes isso? Além disso, ele era muito belo e {na idade} seguia imediatamente a Absalão.
7 E follow Joab wey Zeruaya bi en mama and Abiatar wey bi di priest plan and dem kon gri to support am.
7 Tendo feito reuniões com Joab, filho de Sarvia, e com o sacerdote Abiatar, esses tornaram-se seus adeptos.
8 But Zadok wey bi priest, Benaya wey bi Jehoiada pikin, Natan di profet, Shimei, Rei and David bodyguard, nor gri support am.
8 O sacerdote Sadoc, porém, bem como Banaías, filho de Jojada, o profeta Natã, Semei, Rei e os valentes de Davi, não abraçaram o seu partido.
9 One day wey Adonijah go sakrifice sheep and fat melu to God on-top di Snake Stone (Zohelet Stone) near En-Rogel wotaside, e invite di oda shidren wey David born and di ofisas wey kom from Judah make dem kom di sakrifice,
9 Adonias, tendo imolado ovelhas, bois e bezerros cevados junto à pedra de Zoelet, ao lado de En-Rogel, convidou todos os seus irmãos, filhos do rei, e todos os de Judá que estavam a serviço do rei.
10 but e nor invite Solomon wey bi en half broda, Natan di profet or Benaya and di king bodyguards.
10 Mas não convidou o profeta Natã, nem Banaías, nem os valentes, nem o seu irmão Salomão.
11 Den Natan go meet Batsheba wey bi Solomon mama kon ask, “Yu neva hear sey Haggit pikin, Adonijah, don make ensef king? And David nor know anytin about am!
11 Disse Natã a Betsabé, mãe de Salomão: Não soubeste que Adonias, filho de Hagit, se proclamou rei, sem que o saiba Davi, nosso senhor?
12 If yu won save yor life and Solomon own, I go advise yu sey,
12 Escuta: vou dar-te um conselho, para que salves a tua vida e a de teu filho Salomão.
13 make yu go meet David kon ask am, ‘My king, yu nor promise mi sey, Solomon my pikin go bi king? How kom Adonijah kon bi king naw?’ ”
13 Vai ter com o rei Davi e dize-lhe: Ó rei, meu senhor, não juraste à tua serva que Salomão, meu filho, reinaria depois de ti, e se sentaria no teu trono? Por que então Adonias se proclamou rei?
14 Natan still sey, “As yu still dey tok to di king, I go kom inside kon tell am sey na true yu dey tok.”
14 Enquanto estiveres falando assim ao rei, entrarei e confirmarei o que tiveres dito.
15 So Batsheba go meet David for en room, e don old well-well and di girl Abishag wey kom from Shunem dey kare for am.
15 Foi Betsabé ter com o rei no seu quarto. {O rei estava já muito velho, e Abisag, a sunamita, cuidava dele.}
16 Batsheba bow for di king front and di king kon ask am, “Wetin yu wont?”
16 Betsabé inclinou-se e prostrou-se diante do rei. Este disse-lhe: Que queres?
17 E ansa, “My king, yu use di Oga yor God name take promise mi sey ‘Yor pikin, Solomon go bi king afta mi and e go sidan for my throne.’
17 Ela respondeu: Meu senhor, prometeste com juramento à tua serva que meu filho Salomão reinaria depois de ti, e se sentaria no teu trono.
18 But Adonijah don make ensef king and yu nor know anytin about am.
18 Ora, eis que Adonias se proclamou rei, sem que o saiba o rei, meu senhor.
19 E don use many goat, sheep and fat melu take do sakrifice and e invite Abiatar di priest, yor shidren and Joab wey dey kommand yor sojas, but e nor invite Solomon.
19 Imolou bois, bezerros cevados e grande quantidade de ovelhas, e convidou todos os príncipes, o sacerdote Abiatar e o general Joab; mas não convidou o teu servo Salomão.
20 My king, Israel pipol dey wait make yu tell dem who go bi king afta yu.
20 Ó rei, meu senhor, todo o Israel tem os olhos postos em ti, esperando que declares quem há de tomar o teu lugar no trono depois de ti.
21 If yu nor tok, as yu just die, dem go trit mi and my pikin Solomon, like bad pipol.”
21 Do contrário, logo que o rei, meu senhor, dormir com os seus pais, eu e meu filho Salomão seremos tratados como criminosos.
22 As Solomon mama still dey tok to di king, Natan kon kom di house.
22 Falava ela ainda ao rei, quando se apresentou o profeta Natã.
23 Dem tell di king sey, “Natan wey bi profet dey der.” Natan enter di room kon bow for di king front.
23 Disseram ao rei: Está aí o profeta Natã. Ele entrou e prostrou-se com o rosto por terra diante do rei.
24 Natan sey, “My king, yu don announce sey na Adonijah go bi king afta yu?
24 Em seguida disse: Ó rei, meu senhor, porventura declaraste: Adonias reinará depois de mim e se sentará no meu trono?
25 Bikos, today, e don use many sheep, goat and fat melu take do sakrifice. E invite all yor shidren, Joab wey dey kommand yor sojas and Priest Abiatar and as wi dey tok so, dem dey do party dey shaut sey, ‘Adonijah, yu bi king! Make yu live forever!’
25 Pois ele desceu hoje para imolar bois, bezerros cevados e grande quantidade de ovelhas, tendo convidado todos os príncipes, os generais e o sacerdote Abiatar, os quais estão comendo e bebendo com ele, e gritando: Viva o rei Adonias!
26 But e nor invite mi, Priest Zadok, Benaya and yor savant Solomon.
26 Não fomos, porém, convidados nem eu, teu servo, nem o sacerdote Sadoc, nem Banaías, filho de Jojada, nem teu servo Salomão.
27 My oga know all dis tins and yu nor even tell yor ofisas who go bi king afta yu?”
27 Será do agrado de meu senhor e rei que assim se faça? Porque não deste a conhecer a teus servos quem deverá sentar-se depois de ti no trono do rei, meu senhor.
28 David ansa, “Make yu tell Batsheba make e kom inside,” so di woman kom kon stand for di king front.
28 O rei respondeu: Chamai-me Betsabé. Ela entrou e ficou de pé diante dele;
29 Den e tell am, “God wey save mi from all my trobols, I use en name take promise yu
29 o rei fez-lhe este juramento: Pela vida de Deus que me livrou de toda a angústia,
30 sey, I go keep di promise wey I make with Israel God name sey, na Solomon go bi king afta mi.”
30 o que te jurei pelo Senhor, Deus de Israel, dizendo: Teu filho Salomão reinará depois de mim e sentar-se-á no meu trono em meu lugar, isso vou cumprir hoje.
31 Batsheba bow kon sey, “Make my oga, di king live forever!”
31 Betsabé inclinou-se diante do rei, prostrando-se com a face por terra, e disse: Viva o rei Davi, meu senhor, para sempre!
32 Den David sey make dem koll Zadok, Natan and Benaya. Wen dem enter,
32 O rei Davi disse: Chamai-me o sacerdote Sadoc, o profeta Natã, e Banaías, filho de Jojada. Tendo-se eles apresentado diante do rei, este disse-lhes:
33 e tell dem, “Make una take my ofisas follow body; make Solomon my pikin ride my horse, den una escort am go Gihon wotaside,
33 Tomai convosco os servos de vosso amo, fazei montar na minha mula o meu filho Salomão, e levai-o a Gião.
34 where Natan and Zadok go anoint am as Israel king. Den make una blow di trumpet kon shaut, ‘Solomon, yu bi king! Make yu live forever!’
34 Ali o sacerdote Sadoc e o profeta Natã o ungirão rei de Israel. Tocareis então a trombeta e direis: Viva o rei Salomão!
35 Make una follow am kom back kon sidan for my throne. E go bi king afta mi, bikos naim I don choose to rule Israel and Judah pipol.”
35 Voltareis depois atrás dele, e ele virá sentar-se no meu trono para reinar em meu lugar; pois é a ele que estabeleço chefe de Israel e de Judá.
36 Benaya ansa, “I go do as yu tok and make God wey bi yor God asept am as king!
36 Banaías, filho de Jojada, respondeu ao rei: Assim seja; assim queira ordenar o Senhor, o Deus de meu senhor e rei!
37 As Oga God don dey with awa king, make E dey with Solomon and make E prosper am, pass yu.”
37 Esteja ele com Salomão assim como esteve com o rei, meu senhor, e eleve o seu trono ainda acima do trono de meu senhor o rei Davi!
38 So Zadok di priest, Natan di profet, Benaya and di royal bodyguards kon put Solomon for David horse and dem escort am go Gihon wotaside.
38 O sacerdote Sadoc desceu com o profeta Natã, Banaías, filho de Jojada, os cereteus e os feleteus; fizeram montar Salomão na mula de Davi e conduziram-no a Gião.
39 Zadok karry di olive oil wey e bring from Tabanako kon use am anoint Solomon. Dem blow di trumpet and all di pipol kon shaut, “Solomon, na yu bi king! Make yu live forever!”
39 Tomou o sacerdote Sadoc no tabernáculo o chifre de óleo e ungiu com ele Salomão. A trombeta soou e todo o povo pôs-se a gritar: Viva o rei Salomão!
40 Den all of dem follow am go back dey happy, dey shaut, blow flute, dey make plenty nois and di groun kon dey shake.
40 Depois toda a gente voltou atrás dele, tocando flauta e fazendo grandes festas, de modo que a terra vibrava com suas aclamações.
41 As Adonijah with all di pipol wey e invite dey finish dia party, dem kon hear di nois. Wen Joab hear di trumpet, e ask, “Wetin dey bring dat kind nois for di town?”
41 Adonias e seus convivas, tendo terminado o seu banquete, ouviram aquela algazarra. Joab, ouvindo soar a trombeta, disse: Por que esse barulho de cidade alvoroçada?
42 Before e tok finish, Jonatan wey bi Priest Abiatar pikin kon enter. Adonijah sey, “Make yu kom inside. Yu bi good man, na betta news yu go dey bring so.”
42 Falava ainda, quando sobreveio Jônatas, filho do sacerdote Abiatar. Adonias disse-lhe: Vem: tu és um homem valente e trazes certamente boas notícias.
43 Jonatan ansa, “Nor bi as yu wont am, bikos David don make Solomon king.
43 Sim, respondeu Jônatas; é verdade que o rei Davi, meu senhor, proclamou rei a Salomão.
44 E send Zadok, Natan, Benaya and di palis bodyguard make dem put am for en horse kon escort am,
44 Enviou com ele o sacerdote Sadoc, o profeta Natã, Banaías, filho de Jojada, os cereteus e os feleteus e estes fizeram-no montar na mula do rei.
45 den Zadok and Natan anoint am for Gihon wotaside as king. So pipol enter town bigin shaut dey happy and na dat bi di nois wey yu dey hear so.
45 O sacerdote Sadoc e o profeta Natã ungiram-no rei em Gião. Dali voltaram cheios de alegria, e a cidade está em alvoroço: essa é a algazarra que ouviste.
46 Na Solomon bi king naw.
46 E Salomão até já está sentado no trono do reino.
47 Di one wey worse pass bi sey, all di ofisas go meet David kon tell am, ‘God go make Solomon dey great pass yu and en reign go pass yor own ten times.’ Den King David bow woship God from en bed
47 Além disso, os servos do rei foram felicitar o rei Davi, meu senhor, dizendo: Que o teu Deus torne o nome de Salomão maior que o teu, e eleve o seu trono ainda acima do teu! O rei prostrou-se então sobre o seu leito e disse:
48 kon pray sey, ‘Make wi praiz di Oga wey bi Israel pipol God, wey don make one of my pikin take my place as king and E make mi dey alive to si am!’ ”
48 Bendito seja o Senhor, Deus de Israel, que hoje pôs sobre o meu trono um sucessor, vendo-o eu com os meus próprios olhos!
49 Den doz wey Adonijah invite kon dey fear and all of dem stand up bigin go one-by-one.
49 Os convidados de Adonias, aterrorizados, levantaram-se e foram cada um para o seu lado.
50 Adonijah kon dey fear Solomon so e go di tent for God present kon hold di horn wey dey di altar.
50 Adonias, temendo Salomão, levantou-se também e foi abraçar-se com os cornos do altar.
51 Dem tell Solomon sey, bikos Adonijah dey fear am, e go hold di horn wey dey di altar kon sey, “I wont make Solomon swear for evribody present sey e nor go kill mi.”
51 Disseram-no a Salomão, nestes termos: Eis que Adonias, temendo o rei Salomão, foi abraçar-se com os cornos do altar, dizendo: Jure-me hoje o rei Salomão que ele não fará morrer o seu servo à espada!
52 Solomon ansa, “If e go respet mi, I nor go even tosh one hair for en head, but if e nor respet mi, I go kill-am.”
52 Se ele se mostrar um homem valente, respondeu Salomão, não lhe cairá por terra um só de seus cabelos; mas se nele se encontrar maldade, morrerá.
53 Solomon send dem go koll Adonijah from di altar. Adonijah go meet am kon bow for en front, so di king kon tell am sey make e dey go en house.
53 O rei Salomão mandou mensageiros, e o fizeram descer do altar. Ele veio e prostrou-se diante do rei, que lhe disse: Volta para a tua casa.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Reis 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.