1 Reis 18

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Afta sometaim, for di third year wey rain nor gri fall, God tell Elijah, “Make yu go meet King Ahab and I go make rain fall.”
1 Passado muito tempo, foi a palavra de Deus dirigida a Elias no terceiro ano, nestes termos: Vai apresentar-te diante de Acab, eu vou fazer chover sobre a terra.
2 So Elijah go meet King Ahab.
2 Elias partiu e foi apresentar-se a Acab. A fome devastava violentamente a Samaria.
3 So Ahab koll Obadaya wey dey kare for di palis. Obadaya dey serve God with all en mind.
3 Acab mandou chamar Abdias, seu intendente. Abdias era um homem fervoroso adorador do Senhor.
4 Wen Jezebel dey kill God profets, Obadaya hide hundred profets for two kave; fifty-fifty for each kave and e dey bring food and wota kon give dem.
4 Quando Jezabel massacrou os profetas do Senhor, Abdias tomou cem profetas e escondeu-os em duas cavernas, cinqüenta numa e cinqüenta noutra, onde lhes tinha providenciado o que comer e beber.
5 King Ahab tell Obadaya, “Make yu go all di land; pass thru di wota and di valley kon shek weda yu go si any aria wey grass dey, so dat di animals go-go chop for der, make dem nor for die.”
5 Acab disse-lhe: Percorre a terra; vai a todas as fontes e a todas as torrentes; talvez encontremos erva para conservar a vida aos cavalos e aos burros, evitando assim abater uma parte de nossos animais.
6 Ahab and Obadaya kon divide di land among demsef. One go dis side, while di oda one go di oda side.
6 E repartiram entre si a terra para percorrê-la. Acab foi por um lado, sozinho, e Abdias tomou uma direção contrária.
7 As Obadaya dey go en side, Elijah kon si am. As Obadaya notis sey na Profet Elijah, e fall face groun kon sey, “My oga, Elijah! Na yu really bi dis?”
7 Enquanto Abdias caminhava, eis que veio Elias ao seu encontro. Abdias reconheceu-o e prostrou-se com o rosto por terra, dizendo: És tu, meu senhor Elias?
8 Elijah ansa, “Yes! Na mi. Make yu go tell yor oga sey, ‘Elijah don kom back.’ ”
8 Sim, sou eu. Vai dizer ao teu amo: Elias está aí.
9 Obadaya kon sey, “Wetin I do wey make yu wont make King Ahab kill mi yor savant?
9 Abdias replicou: Que pecado cometi eu, para que entregues assim o teu servo nas mãos de Acab, para ele me matar?
10 As long as yor Oga my God dey alive, I dey tell yu sey, my oga don send pipol go evriwhere go find yu. Wen dem tell am sey, ‘Yu nor dey der,’ e go make sure sey dem swear sey dem nor really si yu.
10 Pela vida de Deus, não há nação, nem reino aonde meu amo não te tenha mandado buscar. E diziam: Elias não está aqui; e ele fazia jurar reino e povo que não te haviam achado.
11 Naw, yu dey sey, ‘Go tell yor oga sey, “Elijah don kom back.” ’
11 E agora tu me dizes: Vai dizer ao teu amo: Elias está aí.
12 But wen I leave yu, God Spirit go karry yu komot sotey I nor go si yu again. If I go tell King Ahab sey I don si yu, den e find and nor si yu, e go just sey make dem kill mi. Dat one nor good, bikos yor savant dey serve God well-well, since wen e bi small pikin.
12 Mas quando eu me apartar de ti, o Espírito do Senhor te levará para não sei onde, e Acab, informado por mim, não te encontrando, matar-me-á. Ora, o teu servo teme o Senhor desde a sua juventude.
13 And na true sey, my oga know wetin I do wen Jezebel dey kill God profets. I hide hundred profets for two kave, fifty-fifty for each kave and I dey give dem wota and food.
13 Porventura não foi dito ao meu senhor o que eu fiz quando Jezabel massacrava os profetas do Senhor? Escondi cem deles, cinqüenta numa caverna e cinqüenta noutra, e os sustentei ali.
14 Naw yu sey, ‘Go tell yor oga, “Elijah don kom back.” ’ But e go kill mi.”
14 E agora tu me dizes: Vai dizer ao teu amo: Elias está aí! Ele me matará!
15 Elijah kon sey, “As long as God wey get pawa wey I dey serve dey alive, I go let King Ahab si mi today.”
15 Elias respondeu-lhe: Pela vida do Senhor dos Exércitos a quem sirvo, hoje mesmo me apresentarei diante de Acab.
16 Wen Obadaya go tell King Ahab wetin Elijah tok, di king kon go meet am.
16 Abdias correu para junto de Acab e deu-lhe a nova. Acab saiu ao encontro de Elias.
17 Wen Ahab si Elijah, e tell am, “Na yu really bring dis wahala kom Israel?”
17 Ao vê-lo, Acab lhe disse: Eis-te aqui, o perturbador de Israel!
18 Elijah ansa, “I nor bring wahala kom Israel. But na yu and yor papa family bring wahala as una abandon God kommand kon follow Baal.
18 Não sou eu o perturbador de Israel, respondeu Elias, mas tu, sim, e a casa de teu pai, porque abandonastes os preceitos do Senhor e tu seguiste aos Baal.
19 Naw, send message go gada Israel pipol kom meet mi for Mount Karmel with Baal 450 profets and Asherah juju 400 profets wey Jezebel dey support.”
19 Convoca, pois, à montanha do Carmelo, junto de mim, todo o Israel com os quatrocentos e cinqüenta profetas de Baal e os quatrocentos profetas de asserá, que comem à mesa de Jezabel.
20 King Ahab send message go meet Israel pipol and dem gada all di profets for Mount Karmel.
20 Mandou Acab avisar a todos os israelitas e reuniu os profetas no monte Carmelo.
21 Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!”
21 Elias, aproximando-se de todo o povo, disse: Até quando claudicareis dos dois pés? Se o Senhor é Deus, segui-o, mas se é Baal, segui a Baal! O povo nada respondeu.
22 Elijah kon tell dem, “Na only mi bi God profet wey remain, but Baal profet na 450.
22 Elias continuou: Eu sou o único dos profetas do Senhor que fiquei, enquanto os de Baal são quatrocentos e cinqüenta.
23 Make dem bring two melu kom give us. Dem go choose one for diasef, kut am into pieces kon put am for di wood. But dem nor go put fire. I go do di same tin to di oda melu and I nor go put fire too.
23 Dê-se-nos, portanto, um par de novilhos: eles escolherão um, fá-lo-ão em pedaços, e o colocarão sobre a lenha, mas sem meter fogo por baixo; eu tomarei o outro novilho e pô-lo-ei sobre a lenha, sem meter fogo por baixo.
24 Una go koll una god name and I go koll my God name. Den, di one wey go ansa with fire, na-im bi di true God.”
24 Depois disso, invocareis o nome de vosso deus, e eu invocarei o nome do Senhor. Aquele que responder pelo fogo, esse será reconhecido como o {verdadeiro} Deus. Todo o povo respondeu: É boa a proposta.
25 Elijah tell Baal profets, “Make una first choose one among di melu kon start, bikos na una plenty pass. Make una koll una god name, but make una nor lite fire put.”
25 Então disse Elias aos profetas de Baal: Escolhei vós primeiro um novilho e preparai-o, porque sois mais numerosos, e invocai o vosso deus, mas não ponhais fogo.
26 So dem take one melu as Elijah tok kon kill-am put on-top di firewood wey dem arrange.
26 Eles tomaram o novilho que lhes foi dado e fizeram-no em pedaços. Em seguida, puseram-se a invocar o nome de Baal desde a manhã até o meio-dia, gritando: Baal, responde-nos! Mas não houve voz, nem resposta. E dançavam ao redor do altar que tinham levantado.
27 For aftanoon, Elijah kon dey laf dem dey sey, “Make una shaut well-well. Afta all, na god e bi, may bi e dey tink or waka go out or travel. May bi e dey sleep and e nid pesin wey go wake-am up.”
27 Sendo já meio-dia, Elias escarnecia-os, dizendo: Gritai com mais força, pois {seguramente!} ele é deus; mas estará entretido em alguma conversa, ou ocupado, ou em viagem, ou estará dormindo... e isso o acordará.
28 So dem shaut well-well, just as dem always dey do for dia juju. Dem use spear and swod dey kut demsef, until blood bigin komot from dia body.
28 Eles gritavam, com efeito, em alta voz, e retalhavam-se segundo o seu costume, com espadas e lanças, até se cobrirem de sangue.
29 Dem shaut and kry till aftanoon, but dem nor hear any sound, ansa or anytin.
29 Passado o meio-dia, enquanto continuavam em seus transes proféticos, chegou a hora da oblação. Mas não houve voz, nem resposta, nem sinal algum de atenção.
30 Elijah kon tell di pipol, “Make una kom meet mi.” So all di pipol go meet am. E ripair God altar wey don skata since.
30 Então Elias disse ao povo: Aproximai-vos de mim, e todos se aproximaram. Elias reparou o altar demolido do Senhor.
31 Den Elijah karry twelf stones wey stand for Jakob twelf tribes wey God tell sey, “Na Israel go bi una new name.”
31 Tomou doze pedras, segundo o número das doze tribos saídas dos filhos de Jacó, a quem o Senhor dissera: Tu te chamarás Israel.
32 E kon use di stones make altar give God. E dig one big gutta round di altar wey go kontain four gallon of wota.
32 E erigiu com essas pedras um altar ao Senhor. Fez em volta do altar uma valeta, com a capacidade de duas medidas de semente.
33 E arrange di firewood kon kut di melu put on-top. Den e sey, “Make una fetch wota put for four gallon kon pour am on-top di ofrin and wood.” So den do as e tok.
33 Dispôs a lenha e colocou sobre ela o boi feito em pedaços.
34 Den Elijah sey, “Make una do am again and again.” So dem do am three times.
34 E disse: Enchei quatro talhas de água e derramai-a em cima do holocausto e da lenha. Depois disse: Fazei isso segunda vez. Tendo-o eles feito, disse: Ainda uma terceira vez. Eles obedeceram.
35 Di wota rush kom down from di altar kon full di gutta.
35 A água correu em volta do altar e a valeta ficou cheia.
36 Wen time rish to do di evening ofrin, Profet Elijah waka go di altar go pray, “My Oga God wey bi Abraham, Isaak and Israel God! Make Yu show today sey, na Yu bi Israel God and I bi yor savant wey dey do di tins wey Yu kommand.
36 Chegou a hora da oblação. O profeta Elias adiantou-se e disse: Senhor, Deus de Abraão, de Isaac e de Israel, saibam todos hoje que sois o Deus de Israel, que eu sou vosso servo e que por vossa ordem fiz todas estas coisas.
37 My Oga God! Make Yu ansa mi! Ansa mi, so dat pipol go know sey na Yu bi di true God, den dem go turn from dia sins kom meet Yu.”
37 Ouvi-me, Senhor, ouvi-me: que este povo reconheça que vós, Senhor, sois Deus, e que sois vós que converteis os seus corações!
38 At wons, fire from God kon fall from heaven. Di fire burn di ofrin, di wood, di stones and di dirty kon dry di wota wey dey di gutta.
38 Então, subitamente, o fogo do Senhor baixou do céu e consumiu o holocausto, a lenha, as pedras, a poeira e até mesmo a água da valeta.
39 Wen di pipol si dis tin, dem fall face groun kon dey sey, “Na God bi di true God! Na God bi di true God!”
39 Vendo isso, o povo prostrou-se com o rosto por terra, e exclamou: O Senhor é Deus! O Senhor é Deus!
40 Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.
40 Elias disse-lhes: Tomai agora os profetas de Baal; não deixeis escapar um só deles! Tendo-os o povo agarrado, Elias levou-os ao vale de Cison e ali os matou.
41 Den Elijah tell King Ahab sey, “Make yu go drink and chop, bikos yu go soon hear heavy rain as e dey kom.”
41 Então Elias disse a Acab: Vai, come e bebe, porque já ouço o ruído de uma grande chuva.
42 So King Ahab go chop and drink and Elijah klimb go Mount Karmel. E bend kon put en face for en leg centre, den e kon dey pray.
42 Voltou Acab para comer e beber, enquanto Elias subiu ao cimo do monte Carmelo, onde se encurvou por terra, pondo a cabeça entre os joelhos.
43 Leta e tell en savants, “Make yu go look di side wey di sea dey.”
43 Disse ao seu servo: Sobe um pouco, e olha para as bandas do mar. Ele subiu, olhou {o horizonte} e disse: Nada. Por sete vezes, Elias disse-lhe: Volta e {olha}.
44 For di sevent time, di savant kon tell am, “I si one small kloud wey bi like pesin hand dey raiz from di sea.”
44 Na sétima vez o servo respondeu: Eis que, sobe do mar uma pequena nuvem, do tamanho da palma da mão. Elias disse-lhe: Vai dizer a Acab que prepare o seu carro e desça, para que a chuva não o detenha.
45 So dark kloud kon kover di sky; di wind blow and heavy rain bigin fall. King Ahab ride dey go Jezrel.
45 Num instante, o céu se cobriu de nuvens negras, soprou o vento e a chuva caiu torrencialmente. Acab subiu ao seu carro e partiu para Jezrael.
46 Naw God give Elijah pawa, so e tie en rope round en waist kon run with leg pass Ahab go Jezrel.
46 A mão do Senhor veio sobre Elias, o qual, tendo cingido os rins, passou adiante de Acab e chegou à entrada de Jezrael.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Reis 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.