1 Reis 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”
1 Um profeta chamado Elias, de Tisbé, na região de Gileade, disse ao rei Acabe: — Em nome do
2 Den God tell Elijah,
2 Então o Senhor Deus disse a Elias:
3 “Make yu komot der go hide near Kerit Valley for Jordan River east.
3 — Saia daqui, vá para o leste e esconda-se perto do riacho de Querite, a leste do rio Jordão.
4 Di valley go bring out wota wey yu go drink and I don kommand birds make dem bring food kom give yu for der.”
4 Você terá água do riacho para beber; e eu mandei que os corvos levem comida para você ali.
5 Elijah obey God kommand kon go stay for Kerit Valley.
5 Elias obedeceu à ordem do Senhor e foi e ficou morando perto do riacho de Querite.
6 E dey drink wota from di valley and birds dey bring bread and meat kon gi-am evry morning and evening.
6 Ele bebia água do riacho, e os corvos vinham trazer pão e carne todas as manhãs e todas as tardes.
7 Afta sometaim, di valley kon dry, bikos rain nor fall again.
7 Mas algum tempo depois o riacho secou por falta de chuva.
8 Den God tell Elijah,
8 Então o Senhor Deus disse a Elias:
9 “Naw make yu go Zarefat town wey dey near Sidon. I don tell one woman wey e husband don die make e give yu food.”
9 — Apronte-se e vá até a cidade de Sarepta, perto de Sidom, e fique lá. Eu mandei que uma viúva que mora ali dê comida para você.
10 So Elijah go Zarefat and as e rish di gate, e si one woman wey e husband don die dey gada firewood. So Elijah tell am, “Abeg! Make yu give mi wota make I drink.”
10 Então Elias foi para Sarepta. Quando estava chegando ao portão da cidade, ele encontrou a viúva, que estava catando lenha. Elias disse a ela: — Por favor, me dê um pouco de água para eu beber.
11 As di woman dey go bring am, e still tell am, “Make yu still bring bread kom for mi too.”
11 Quando ela ia indo buscar a água, ele a chamou e disse: — E traga pão também, por favor.
12 Di woman ansa, “I promise with God wey dey alive sey, I nor get bread. Di only tin wey I get na small flower for plate and olive oil for cup. I kom gada firewood make I use take make am for mi and my pikin. Na dat one bi di last food wey wi go chop before honga go kill us.”
12 Porém ela respondeu: — Juro pelo seu Deus vivo, o
13 Elijah tell am, “Make yu nor worry. Just go kook yor food, but first make one bread from wetin yu get kon give mi, den go make di remainin ones for yu and yor pikin.
13 — Não se preocupe! — disse Elias. — Vá preparar a sua comida. Mas primeiro faça um pãozinho com a farinha que você tem e traga-o para mim. Depois prepare o resto para você e para o seu filho.
14 Bikos di Oga wey bi Israel God sey: ‘Flower and oil nor go finish from yor plate and cup till di day wey God go make rain fall.’ ”
14 Pois o Senhor , o Deus de Israel, diz isto: “Não acabará a farinha da sua tigela, nem faltará azeite no seu jarro até o dia em que eu, o Senhor , fizer cair chuva.”
15 Di woman kon go do wetin Elijah tell am and all of dem si food chop for many days.
15 Então a viúva foi e fez como Elias tinha dito. E todos eles tiveram comida para muitos dias.
16 As God don promise thru Elijah, flower and oil nor finish from di woman plate and cup.
16 Como o Senhor havia prometido por meio de Elias, não faltou farinha na tigela nem azeite no jarro.
17 Afta sometaim, di woman pikin kon bigin sick. Bikos di sickness strong well-well, di pikin kon die.
17 Algum tempo depois, o filho da viúva ficou doente. Ele foi ficando cada vez pior e acabou morrendo.
18 Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”
18 Então ela disse a Elias: — Homem de Deus, o que o senhor tem contra mim? Será que o senhor veio aqui para fazer com que Deus lembrasse dos meus pecados e assim provocar a morte do meu filho?
19 Elijah tell am, “Make yu give mi di pikin.” Elijah karry di pikin from am, klimb go di room wey e dey stay for up kon put am for bed.
19 — Dê-me o seu filho! — disse Elias. Então pegou o menino dos braços da mãe e o levou para o andar de cima, para o quarto onde estava morando, e o colocou na sua cama.
20 Den e shaut kon pray, “My Oga God, why Yu allow dis kind bad tin happen to dis woman? E dey kind and dey kare for mi! Naw, Yu don allow en pikin die.”
20 Então orou em voz alta, assim: — Ó
21 Den Elijah liedan on-top di pikin three times dey pray kon sey, “My Oga God, make Yu give dis pikin life again!”
21 Aí Elias se deitou em cima do menino três vezes e orou deste modo: — Ó
22 God ansa Elijah prayer, so di pikin kon kough and start to breath again.
22 E o Senhor Deus respondeu à oração de Elias. O menino começou a respirar outra vez e tornou a viver.
23 Elijah karry di pikin go down kon tell en mama, “Si, yor pikin don kom back to life!”
23 Elias pegou o menino, e o levou para baixo, para a sua mãe, e disse: — Veja! O seu filho está vivo!
24 Di woman ansa, “Na naw I know sey yu bi God savant and God dey really tok thru yu!”
24 Então ela disse a Elias: — Agora eu sei que o senhor é um homem de Deus e que Deus realmente fala por meio do senhor!

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Reis 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.