1 Reis 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen di kween for Sheba hear about di wonderful tins wey Solomon dey do, e kon travel go Jerusalem go test am with hard-hard kweshon.
1 A rainha de Sabá soube da fama que Salomão tinha alcançado, graças ao nome do Senhor, e foi a Jerusalém para pô-lo à prova com perguntas difíceis.
2 E karry plenty pipol follow body kon load spices, jewels and plenty gold full en kamels. Wen di kween si Solomon, e kon ask am all di kweshon wey dey en mind.
2 Quando chegou, acompanhada de uma enorme caravana, com camelos carregados de especiarias, grande quantidade de ouro e pedras preciosas, foi até Salomão e lhe fez todas as perguntas que tinha em mente.
3 King Solomon ansa all di kweshon and e nor get any one wey hard am to ansa.
3 Salomão respondeu a todas; nenhuma lhe foi tão difícil que não pudesse responder.
4 Sheba kween know sey King Solomon get wisdom and e si di palis wey e build;
4 Vendo toda a sabedoria de Salomão, bem como o palácio que ele havia construído,
5 di food wey dem serve for di tabol; di house wey en ofisas dey stay; how en workers dey do and di uniform wey dem wear; di savants wey dey serve wen dem dey do party and di sakrifice wey e dey offa for di temple. All dis tins kon sopraiz di kween well-well and fear katch am.
5 o que era servido em sua mesa, o lugar de seus oficiais, os criados e copeiros, todos uniformizados, e os holocaustos que ele fazia no templo do Senhor, ela ficou impressionada.
6 E tell Solomon, “Wetin I hear for my kountry about yor wisdom, na true!
6 Disse ela então ao rei: "Tudo o que ouvi em meu país acerca de tuas realizações e de tua sabedoria era verdade.
7 But I nor bilive until naw wey I don kom si evritin by mysef. I nor even hear half of wetin I don si; bikos yor wisdom and propaty many pass as dem tell mi.
7 Mas eu não acreditava no que diziam, até ver com os meus próprios olhos. Na realidade, não me contaram nem a metade; tu ultrapassas em muito o que ouvi, tanto em sabedoria como em riqueza.
8 Yor ofisas and savants go dey happy well-well, bikos dem always dey with yu, dey hear di wise tins wey yu dey tok!
8 Como devem ser felizes os homens da tua corte, que continuamente estão diante de ti e ouvem a tua sabedoria!
9 Make wi praiz di Oga wey bi yor God! E don show how E dey happy with yu, bikos E make yu king for Israel and di love wey E get for Israel pipol, go last forever. E don make yu dia king, so dat yu go fit keep di law and dey judge well.”
9 Bendito seja o Senhor, o teu Deus, que se agradou de ti e te colocou no trono de Israel. Por causa do amor eterno do Senhor para com Israel, ele te fez rei, para manter a justiça e a retidão".
10 Sheba kween give Solomon all di gifts wey e bring and dem heavy rish 120 pounds for gold, with plenty spices and jewels. Di spices wey e give Solomon, plenty pass di ones anybody don ever gi-am before.
10 E ela deu ao rei quatro toneladas e duzentos quilos de ouro e grande quantidade de especiarias e pedras preciosas. E nunca mais foram trazidas tantas especiarias quanto as que a rainha de Sabá deu ao rei Salomão.
11 (Hiram pipol wey karry gold kom from Ofir, still bring plenty fine wood and jewels.)
11 ( Os navios de Hirão, que carregavam ouro de Ofir, também trouxeram de lá grande quantidade de madeira de junípero e pedras preciosas.
12 King Solomon use di wood take build rails for di temple and di palis. E still use am make harp and lyre for doz wey dey play music. Di junipa wood wey fine pass, na-im dem bring kom Israel and e nor get any oda wood like doz ones again.
12 O rei utilizou a madeira para fazer a escadaria do templo do Senhor e a do palácio real, além de harpas e liras para os músicos. Nunca mais foi importada nem se viu tanta madeira de junípero. )
13 Solomon give Sheba kween evritin wey e ask for kon still gi-am oda tins, just as dia tradishon bi, den di kween and en pipol kon go back to Sheba.
13 O rei Salomão deu à rainha de Sabá tudo o que ela desejou e pediu, além do que já lhe tinha dado por sua generosidade real. Então ela e os seus servos voltaram para o seu país.
14 Evry year, dem dey give Solomon gold wey heavy rish 666 pounds.
14 O peso do ouro que Salomão recebia anualmente era de vinte e três toneladas e trezentos quilos,
15 Dis one nor dey join di tax wey tradas, Arab kings and di govnors for Israel dey pay gi-am.
15 fora os impostos pagos por mercadores e comerciantes e por todos os reis da Arábia e pelos governadores do país.
16 Solomon use gold wey rish fifteen pounds take make two hundred shield.
16 O rei Salomão fez duzentos escudos grandes de ouro batido, utilizando três quilos e seiscentos gramas de ouro em cada um.
17 E still use gold wey almost rish four pounds take make three hundred shield kon put all of dem for di hall wey dey Lebanon forest.
17 Também fez trezentos escudos pequenos de ouro batido, com um quilo e oitocentos gramas de ouro em cada um. O rei os colocou no Palácio da Floresta do Líbano.
18 E still make one big throne. Dem kover one side for di throne with ivory kon kover di oda side with fine gold.
18 O rei mandou fazer ainda um grande trono de marfim revestido de ouro puro.
19 Na six steps dey to klimb go di throne and for di end for evry step, dem mold lion put, so all di lion kon bi twelf.
19 O trono tinha seis degraus, e o seu encosto tinha a parte alta arredondada. Nos dois lados do assento havia braços, com um leão junto a cada braço.
20 Dem mold melu head for di throne back and near di two chair hand. Dem still mold anoda lion put for di throne. E nor get any throne wey bi like dis for any oda kingdom.
20 Doze leões ficavam nos seis degraus, um de cada lado. Nada igual havia sido feito em nenhum outro reino.
21 Na gold dem take make di cup wey Solomon take dey drink wota and all di spoons and plates wey dey di hall for Lebanon forest. Dem nor use silva, bikos silva nor get value for Solomon time.
21 Todas as taças do rei Salomão eram de ouro, bem como todos os utensílios do Palácio da Floresta do Líbano. Não havia nada de prata, pois a prata quase não tinha valor nos dias de Salomão.
22 Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.
22 O rei tinha no mar uma frota de navios mercantes junto com os navios de Hirão. Cada três anos a frota voltava, trazendo ouro, prata, marfim, macacos e pavões.
23 Solomon get propaty and e wise pass any oda king.
23 O rei Salomão era o mais rico e o mais sábio de todos os reis da terra.
24 Evribody for di world dey won kom hear di wise tins wey God give Solomon to tok.
24 Gente de todo o mundo pedia audiência a Salomão para ouvir a sabedoria que Deus lhe tinha dado.
25 Evribody wey dey kom, dey bring gold, silva, robes, weapons, spices, horse and mule. And dem dey bring dem kom evry year.
25 Ano após ano, todos os que vinham traziam algum presente: utensílios de prata e de ouro, mantos, armas e especiarias, cavalos e mulas.
26 Solomon gada many horse and shariot. E get 14,000 shariot and 12,000 ordinary horse. E keep dem for difren towns for Jerusalem.
26 Salomão juntou carros e cavalos; possuía mil e quatrocentos carros e doze mil cavalos, dos quais mantinha uma parte nas guarnições de algumas cidades e a outra perto dele, em Jerusalém.
27 Wen Solomon dey rule, silva dey evriwhere like ordinary stone for Jerusalem and cedar tree dey kommon like ordinary trees for Jerusalem.
27 O rei tornou a prata tão comum em Jerusalém quanto as pedras, e o cedro tão numeroso quanto as figueiras bravas da Sefelá.
28 Solomon buy en horse from Egypt and Silisia; doz wey dey sell for di king, na dem buy dem kom from Silisia for di normal prize.
28 Os cavalos de Salomão eram importados do Egito e da Cilícia, onde os fornecedores do rei os compravam.
29 Dem dey buy one shariot from Egypt for 600 silva and ordinary horse for 150 silva. Den dem go re-sell am give Hit and Siria kings.
29 Importavam do Egito um carro por sete quilos e duzentos gramas de prata, e um cavalo por um quilo e oitocentos gramas, e os exportavam para todos os reis dos hititas e dos arameus.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Reis 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.