1 Pedro 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Since Christ don sofa for us, make wi do like am, bikos di pesin wey sofa for us nor get anytin to do with sin again,
1 Ora pois, já que Cristo padeceu na carne, armai-vos também vós deste mesmo pensamento; porque aquele que padeceu na carne já cessou do pecado;
2 bikos e don do wetin God wont and nor bi wetin pipol wont.
2 para que, no tempo que ainda vos resta na carne não continueis a viver para as concupiscências dos homens, mas para a vontade de Deus.
3 Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju.
3 Porque é bastante que no tempo passado tenhais cumprido a vontade dos gentios, andando em dissoluções, concupiscências, borrachices, glutonarias, bebedices e abomináveis idolatrias.
4 Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again.
4 E acham estranho não correrdes com eles no mesmo desenfreamento de dissolução, blasfemando de vós;
5 For di day wen Christ go judge pipol wey dey alive and doz wey don die, e go ponish dem.
5 os quais hão de dar conta ao que está preparado para julgar os vivos e os mortos.
6 Na dis make Christ prish di gospel for doz wey don die, so dat even doh e go judge dem as human being, dem go live forever as spirit thru God judgement.
6 Pois é por isto que foi pregado o evangelho até aos mortos, para que, na verdade, fossem julgados segundo os homens na carne, mas vivessem segundo Deus em espírito.
7 Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.
7 Mas já está próximo o fim de todas as coisas; portanto sede sóbrios e vigiai em oração;
8 As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.
8 tendo antes de tudo ardente amor uns para com os outros, porque o amor cobre uma multidão de pecados;
9 Make una welkom pipol for una house without komplain.
9 sendo hospitaleiros uns para com os outros, sem murmuração;
10 God don give evribody en own gift, so make una use di gift take help each oda as good savant wey get God grace.
10 servindo uns aos outros conforme o dom que cada um recebeu, como bons despenseiros da multiforme graça de Deus.
11 Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!
11 Se alguém fala, fale como entregando oráculos de Deus; se alguém ministra, ministre segundo a força que Deus concede; para que em tudo Deus seja glorificado por meio de Jesus Cristo, ma quem pertencem a glória e o domínio para todo o sempre. Amém.
12 My friends, make una nor sopraiz sey una dey pass thru trobol like pesin wey fire dey burn, bikos tins wey go make una fear, go must happen.
12 Amados, não estranheis a ardente provação que vem sobre vós para vos experimentar, como se coisa estranha vos acontecesse;
13 Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.
13 mas regozijai-vos por serdes participantes das aflições de Cristo; para que também na revelação da sua glória vos regozijeis e exulteis.
14 If dem curse una bikos of Christ, God don bless una bi dat, bikos God Spirit wey get glory, rest on-top una life.
14 Se pelo nome de Cristo sois vituperados, bem-aventurados sois, porque sobre vós repousa o Espírito da glória, o Espírito de Deus.
15 But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.
15 Que nenhum de vós, entretanto, padeça como homicida, ou ladrão, ou malfeitor, ou como quem se entremete em negócios alheios;
16 But if yu sofa bikos yu bi Christian, make yu nor shame, but dey praiz God, bikos yu dey ansa Jesus name.
16 mas, se padece como cristão, não se envergonhe, antes glorifique a Deus neste nome.
17 Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God?
17 Porque já é tempo que comece o julgamento pela casa de Deus; e se começa por nós, qual será o fim daqueles que desobedecem ao evangelho de Deus?
18 If e go hard for God pipol to dey save, den e nor go eazy for doz wey nor dey fear God.
18 E se o justo dificilmente se salva, onde comparecerá o ímpio pecador?
19 So if yu dey sofa as God wont am, make yu trust God wey kreate yu and E nor go ever fail yu.
19 Portanto os que sofrem segundo a vontade de Deus confiem as suas almas ao fiel Criador, praticando o bem.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Pedro 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.